South Africa authorities issue warning on snowfall and heavy rain - wia go dey affected

Wia dis foto come from, RODGER BOSCH / AFP) (Photo by RODGER BOSCH/AFP via Getty Images
Authorities for South Africa don issue warning ontop places wey heavy rainfall and snow go affect across di kontri.
KwaZulu-Natal Transport and Human Settlements MEC Siboniso Duma say authorities dey monitor di road network.
Dem say di Drakensberg Mountains don alreadi experience snowfall but dia 'grader operators dey on standby to remove snow bifor e accumulate to more dan 30cm.'
Di South African Weather Service (SAWS) say veri cold and wet conditions wit light snowfall dey expected to set in from Wednesday evening for several across di kontri.
"Di weather conditions dey due to di passage of cut-off low weather system, wey go clear from di west by Thursday."
"Farmers dey advised to take precautionary measures to mitigate di negative impact under such serious weather conditions."
According to di warning by di weather service, dem say disruptive snow go dey and e dey expected for places ova north-eastern high ground of di Eastern Cape and di Drakensberg area of KwaZulu-Natal.
"Di snow fit result in traffic disruptions, disruption to essential services and some communities go dey temporarily cut off."
How di weather condition go affect South Africa
Di authorities say dem dey check to make sure say di snow no too affect pipo wey dey on di coastal road and settlements.
"Van Reenen between Harrismith and Ladysmith dey closely monitored to ensure road closure wia necessary."
"Dis go help to prevent motorists make dem no dey stucked on di N3. Coastal and low-lying areas wia dem get informal settlements go dey monitored," Duma say on Wednesday.
"Disruptive rain, resulting in flooding of bridges, roads and settlements, as well as damage to property and infrastructure, dey expected ova di south-eastern parts of di Eastern Cape and di eastern parts of KwaZulu-Natal, except di extreme north-east.:
Di South Africa Human Settlements team wey dey work for eThekwini Municipality say dem do make about 170 rooms available for pipo wey go dey affected by di weather condition.
"We go accommodate families wey fit dey destitute becos of floods. Construction dey go on di Quarry Heights Bridge, wey dey partially destroyed by floods for 2022."
Dem say engineers from di department of Transport dey construct culverts for some bridges to prevent water make e no enta di and prevent flooding.
Wetin South African go do
South African authorities, particularly for eThekwini Municipality tell dia residents to take immediate precautions sake of di warning wey di weather service release.
According to di weather forecast, heavy rainfall dey expected across KwaZulu-Natal.
During dat time, showers and thundershowers dey expected and e get serious risk to lives, property and infrastructure.
"Di disruptive rainfall fit result in flooding on settlements, roads, bridges, and low-lying areas. Poor visibility and slippery road surfaces dey expected to make driving dangerous," di municipality say for statement.
According to di authorities, residents wey dey live for flood areas dey expected to take caution and safeguard diasef and family members.
Pipo wey dey drive for road also gatz dey careful, 'reduce speed, and maintain safe following distance on wet and slippery roads.'
"Wia possible, residents dey encouraged to remain indoors and avoid unnecessary travel. Di Municipality's Disaster Management Directorate and emergency services dey on high alert, ready to respond to any incidents," di municipality say.
Which region go dey affect by South Africa snow and rainfall
Di South African Weather Service (SAWS) say veri cold and wet conditions wit light snowfall dey expected to set in from Wednesday evening for several across di kontri.
Places wey dey close to di Eastern Cape, southern parts of KwaZulu-Natal, southern Free State and di Lesotho border, dey expected to be affected.
Flooding of bridges, roads and settlements, as well as damage to property and infrastructure, dey expected for areas between East London for di Eastern Cape and Cape Vidal for KwaZulu-Natal.







