US launch 'heavy' strikes on Iran afta attempted attack on American sojas

Wia dis foto come from, UGC via Reuters
- Author, Jude Sheerin
- Author, Helen Sullivan
- Role, BBC News
- Published
- Read am in 5 mins
US military tok say dem don complete one "heavy wave" of strikes against Iran in retaliation for Tuesday attempted ballistic missile attacks on American forces.
Centcom say dem hit "dozens" of Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) targets in response to Iran firing on US bases for Jordan and for ships for di Strait of Hormuz.
Iranian state media say di latest strikes kill three pipo, wey include one two-year-old child, for Qeshm island, di strikes also hit oda locations for di south and west of di kontri.
Dis latest fight-fight come just one week wey don see di conflict spread more, as dem first time publicly announce joint US and Saudi attack wey target Iranian proxy groups for Iraq.
Wen US and Israel launch military strikes on Iran for February, President Donald Trump bin say di war go last only for few weeks, but e don pass five months now wit no end in sight.
On Wednesday, news outlet Axios bin cite one unnamed US official say e tok say Trump don meet wit Saudi defence minister Prince Khalid bin Salman, and dat pesin say Saudi Arabia wan de-escalate tensions.
BBC don contact di White House for comment.
Meanwhile, di Egyptian govment don confam one fire for one of dia prt wey one drone attack cause on Wednesday
Egypt, wey be US ally, neva face any direct attack during di war.
US-Iran conflict bin start afresh afta several days of relative calm.
For days, both sides bin pause di strikes as dem begin dey tok again wit hopes of some type of diplomatic solution.
Trump bin call dem "very friendly negotiations", though Tehran bin deny say no discussions bin dey happun.
But following di Iranian missile attack on one US base for Jordan on Tuesday, Trump don vow to retaliate, e tell tori pipo for di White House: "We go hit dem very hard becos na our turn to hit dem. Dem no wetin dey come. Dem ask us not to do am."

Wia dis foto come from, US Central Command
Di latest wave of US strikes start for 20:00 ET on Wednesday (01:00 BST on Thursday) and e last for about one hour.
Centcom call am "powerful response to yesterday attempted Iranian attacks on US forces wey base for di Middle East". Centcom say dem intercept all Iran missiles.
Di attack wey di US carry out target "military command centers, missile and drone facilities, coastal surveillance and defense sites, and maritime capabilities," Centcom tok.
Iranian state media agency Irib report say di islands of Qeshm and Abadan, both central to di oil industry, dey among di areas dem hit.
"US attack on one residential home for di Chah Tangu neighbourhood of Qeshm kill three members of one family: di father, di mother, and dia 2-year-old child," Fars report cite di Hormozgan University of Medical Sciences.
Meanwhile, Jordan armed forces say dia air defence systems successfully shoot down five Iranian missiles wey target di Kingdom territory on Thursday.
On Tuesday, di IRGC tok say dem target one US air base and one command centre for Jordan "in response to di acts of aggression of di American child-killing army".
Dem also say naval forces strike three oil tankers for di Strait of Hormuz afta dem "ignore warnings" and sail along wetin dem describe as "unsafe and illegal route" through di vital Gulf waterway.
Last Friday, Trump bin suspend one intensive bombing campaign wey last for 13 consecutive nights.
US say dem target Iranian weapons and military sites. Report say plenty pipo die.
On Tuesday, Centcom say di joint US-Saudi strikes hit "multiple terrorist logistics and weapons sites across eastern Iraq as strong response to ova 30 IRGC-directed aerial drone attacks in di last 72 hours".
Iraq paramilitary Popular Mobilisation Forces (PMF), di Iran-backed Shia militias, tok say at least 20 of dia members dey killed for US-Saudi strikes on dia bases.
Di Iraqi presidency don reject di bombing of di PMF bases, as dem call am "an unacceptable attack plus blatant violation of Iraq sovereignty".
But Trump tell Fox News say di strikes dey "co-ordinated wit di Iraqi govment".
Saudi Arabia, wey see dia sef as di leading Sunni Muslim power, and Iran, di largest Shia Muslim don dey locked for struggle for regional dominance for decades.









