Jeffrey Toobin Zoom video: New Yorker suspend reporter wey accidentally 'expose' imsef for zoom meeting

Wia dis foto come from, Getty Images
Tori pipo di New Yorker don suspend CNN chief legal analyst Jeffery Toobin, afta im expose im sef for Zoom video call, days before di presidential election.
Oga Jeffrey wey dey on leave from CNN na also ogbonge reporter for di New Yorker.
Di reporter expose im sef as im dey do Zoom meeting wit im colleagues last week but say im do am by accident.
Ordinarily by now, oga Jeffrey for dey busy dey cover di controversial US Supreme Court confirmation plus election wey fit end up wit legal wahala.
Di New Yorker staff bin dey don joint meeting wit staff from WNYC to prepare for di presidential election coverage.
New York times report say, Staff writers for The New Yorker and employees from WNYC, wey dey jointly produce di magazine podcast, bin dey on joint video call dey prep for election night coverage.
According to Vice, wey first report am, as dem pause for di call for breakout discussions, e be like Mr. Toobin switch go anoda video-call wey be like phone sex call, according to di two pipo wey familiar with di call, wey speak on di condition of anonymity.
Toobin tell tori pipo New York Times say, "I make embarrassing stupid mistake, I bin believe say I dey off camera. I apologise to my wife, family, friends and co-workers.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
"I bin tink say I mute di Zoom video, " im tok. "I bin tink say nobody for di Zoom call fit see me."
Tok-tok pesin for di New Yorker say dem don "suspend am while we dey investigate di mata."
CNN tok-tok pesin say, "Jeff Toobin don ask for some time off as im dey deal wit personal issue, and we don grant am."
Who be Jeffrey Toobin?
Jeffrey Ross Toobin, na United States lawyer, legal analyst for tori pipo CNN and di New Yorker, blogger, and author.
Im bin serve as associate counsel for di Department of Justice.
Im don write many books including one on di O.J. Simpson murder case wey dem turn for 2016 to TV series wey dem call di Pipo v. O.J. Simpson: American Crime Story.
Dem air am as di first season of FX American Crime Story and e win nine Emmy Awards.














