China anniversary: Beijing show dia military power for dia 70 years national day parade

Published

Deep-sea drones and one intercontinental ballistic missile dey among di advanced weapons wey dey on public display for di first time for di parade wey mark di 70 years of communist rule for China.

According to di Ministry of National Defence, about 15,000 military personnel, 580 pieces of military equipment and 160 aircraft na im take part for di parade.

No be today di kontri dey do ogbonge military march-pasts like dis.

But sabi pipo say dis year own display show China ambition to modernise.

"Na made in Russia and Ukraine equipment na im dey dis parades 20 years ago - now everytin na made in China," Jon Grevatt of Jane's Defence Weekly tell BBC.

"Di technological advancement wey China don achieve na something wey dem almost never do before."

For China, sabi pipo say today parade na to show America say dem strong.

Our tori pesin say di DF-26 ballistic missile wey, if dem fire from land, fit strike di key element of US power projection, di US Navy's aircraft carriers.

Di latest parade also show di first public display of a newer model - di DF-41 road mobile intercontinental ballistic missile - wey Chinese analysts say get power to target any part of di world.

China know say US dey look wetin dem get to re-build dia capabilities, na so our tori pesin tok, afta plenti years of dia focus on counter-insurgency operations for places like Afghanistan and Iraq.

So China too dey respond by developing dia own forces, dia reach and sophistication.

All di foto dey subject to copyright.