China anniversary: Beijing show dia military power for dia 70 years national day parade

Chinese troops march past Tiananmen Square during a rehearsal before a military parade marking the 70th anniversary of the founding of the People"s Republic of China, in Beijing, China, 01 October 2019.

Wia dis foto come from, EPA

Published
Presentational white space

Deep-sea drones and one intercontinental ballistic missile dey among di advanced weapons wey dey on public display for di first time for di parade wey mark di 70 years of communist rule for China.

According to di Ministry of National Defence, about 15,000 military personnel, 580 pieces of military equipment and 160 aircraft na im take part for di parade.

No be today di kontri dey do ogbonge military march-pasts like dis.

But sabi pipo say dis year own display show China ambition to modernise.

Troops march with blue uniform for Tiananmen Square on 1 October 2019.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, About 15,000 Chinese military personnel na im feature for di parade

"Na made in Russia and Ukraine equipment na im dey dis parades 20 years ago - now everytin na made in China," Jon Grevatt of Jane's Defence Weekly tell BBC.

"Di technological advancement wey China don achieve na something wey dem almost never do before."

Float wey carry di symbol of di Chinese People Liberation Army (R) pass through Tiananmen Square during di National Day parade for Beijing on 1 October 2019, to mark di 70th anniversary of di founding of di Peoples Republic of China.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Big floats carry different symbol including di one of Chinese People's Liberation Army (R)
Presentational white space

For China, sabi pipo say today parade na to show America say dem strong.

Our tori pesin say di DF-26 ballistic missile wey, if dem fire from land, fit strike di key element of US power projection, di US Navy's aircraft carriers.

Di latest parade also show di first public display of a newer model - di DF-41 road mobile intercontinental ballistic missile - wey Chinese analysts say get power to target any part of di world.

Military vehicles wey dey carry di DF-41 intercontinental ballistic missile dey enta Tiananmen Square for Beijing during di military parade to mark di 70th anniversary of di founding of di People's Republic of China, on 1 October 2019.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, China military display new intercontinental ballistic missiles for public for di first time
Presentational white space

China know say US dey look wetin dem get to re-build dia capabilities, na so our tori pesin tok, afta plenti years of dia focus on counter-insurgency operations for places like Afghanistan and Iraq.

So China too dey respond by developing dia own forces, dia reach and sophistication.

Soldiers of the People's Liberation Army shout during the rehearsal of the parade on the morning of 1 October 2019, in Tiananmen Square, Beijing.

Wia dis foto come from, Getty Images

Presentational white space
A formation of military aircraft fly over Beijing during the military parade.

Wia dis foto come from, AFP

Presentational white space
Chinese women troops march during a military parade in Tiananmen Square in Beijing on 1 October 2019 marking the 70th anniversary of the founding of the People's Republic of China.

Wia dis foto come from, EPA

Presentational white space
HSU-001 underwater drones dey on show for di first time for Tiananmen Square for Beijing on 1 October 2019.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, HSU-001 underwater drones dey on show for di first time
Chinese soldiers atop tanks in a parade to celebrate the 70th anniversary of the founding of the People's Republic of China in 1949, at Tiananmen Square in Beijing on 1 October 2019.

Wia dis foto come from, Getty Images

Presentational white space
A soldier of the People's Liberation Army stands to attention on a tank during a parade to celebrate the 70th anniversary of the founding of the People's Republic of China in 1949, at Tiananmen Square in Beijing on 1 October 2019.

Wia dis foto come from, Getty Images

Presentational white space
Relatives of pipo wey die for di good of di kontri take part for di National Day parade for Tiananmen Square for Beijing on October 1, 2019, to mark di 70th anniversary of di founding of di People's Republic of China.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Relatives of pipo wey die for di good of di kontri carry dia foto for di procession
Presentational white space
One float wey carry di giant foto of Chinese President Xi Jinping pass through Tiananmen Square duringdi parade for di 70th anniversary of di establishment ofdi People's Republic of China, 1 October 2019.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, One float carry di giant foto of Chinese President Xi Jinping
Performers walk and dance during di parade for di 70th anniversary of di establishment of di People's Republic of China, 1 October 2019 forTiananmen Square.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Non-military performers also take part for di parade
Presentational white space

All di foto dey subject to copyright.