'What happen to MTN network today?' Nigerians para as di telecommunications provider explain connection issues wey shut out users

Wia dis foto come from, other
Mobile Telecommunication giant for Nigeria - MTN don tok sorry to dia customers wey fit dey experience network issues.
Dis dey come as plenty users don complain of difficulty and inability to use di service make calls or access data to browse internet for di social media apps wey dey dia phones or their computers.
MTN for inside one post on top dia verified Facebook page say dem dey sorry for any inconvenience di network palava dey cause.
Although management of di telecommunication network no to tok reason why dia service go down, dem however say dem dey look into di mata.
Di management too no tok how long di palava go last.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
MTN blackout dey come days afta social media services Facebook, Whatsapp and Instagram experience blackout for more dan six hours.
Di company say na one faulty configuration cause di blackout.
Plenty MTN users for Nigeria say dem dey confused as dem no fit use di telecommunication network.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, BASHIR AHMAD

Wia dis foto come from, OTHERS
While some subscribers say dem lose plenty money sake of di network palava, odas tok how dem bin tink say na dia phone spoil.

Wia dis foto come from, OTHERS

Wia dis foto come from, OTHERS

Wia dis foto come from, OTHERS

Wia dis foto come from, OTHERS
MTN na di network with di largest subscribers for Nigeria.
According to Statista, As at March 2021, MTN hold 39.5 percent share of mobile wireless subscribers for Nigeria and dem be di current market leader in terms of number of mobile wireless subscribers followed by Globalcom and Airtel, with around 26 to 28 percent each.
Na for August 2001, dem launch MTN for Nigeria ahead of di oda mobile wireless subscribers di kontri currently get.










