World Cup first-timers Cape Verde hold Spain to scoreless draw

Cape Verde is frustrating Spain

Wia dis foto come from, MATTIA OZBOT/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Ferran Torres fail to score two good chances wey Cape verde keepr Voozinha bin save most of di balls for di first half
Published
Read am in 13 mins

First-timers for di World Cup Cape Verde put in defensive masterclass to hold European Champions Spain to 0-0 draw for di Atlanta Stadium for dia group H opener.

Pundits and fans predict say Spain go win dis game but afta 90 minutes na Cape Verde dey smile as dem get dia first point for di World Cup.

Spain try everitin to beat di Cape Verde defence but dia goalkeeper Vozinha no allow La Roja to score as im make plenti saves.

Ferran Torres bin hit di crossbar wey im miss two oda chances bifor dem comot am from di game.

Real Sociedad captain Mikel Oryazabal also no show for di whole game as Spain struggle to score.

Luis de la Fuente carry Lamin Yamal enta di game to try and create some magic, but Oryazabal waste di one clear chance wey im create.

Nico Williams bin enta di game too late – na so dem struggle till di end.

For Cape Verde, apart from dia goalkeeper Vozinha, dia defenders also put dia body for di line wey dem play for di counterattack.

In fact for di last five minutes, Cape Verde get chance to even score.

At di end of di game Spain wit dia seven shots on target from 24 shots settle for one point for dat group.

Group H get Uruguay and Saudi Arabia wey go play dia games later.

Cape Verde now join Morocco as di oda African kontri to get one point for dia first game.

Second Haalf

FULL TIME

Yamal play di corner but di header from Cubarsi comot for goalkick.

90+4" Corner to Spain! Yamal create di pressure.

Yellow card! Pedri lose concentration wey im foul im marker as Cape Verde dey try to attack.

92" Yamal try to shoot bur Oyazabal block di ball.

90" Chance! Cape Verde attack di corner di ball bounce in front of Unai Simon.

89" Corner to Cape Verde. One poor pass by Yamal meet Cape verde player wey dem attack, bifor di ball comot for corner.

86" Throw-in for Cape Verde as dem dey pressure for unlikely winner. Spain xarry Nico Williams enta di game.

83" Di game dey enta di final stage still 0-0. Spain dey push

82" Chance! Cucurella head di ball dey try to beat di keeper but once again di keeper bin save am.

80" Ferran Torres don comot for Dani Olmo. Di Barcelona player bin miss chances for di game.

Panic inside di Cape verde box afta do corner but dem ni fit score.

78" Corner to Spain. Dem still dey push for di gial, Cape Verde dey defend.

76" Spain still dey try to pass di ball into di net. Na so Cape Verde also dey block all di balls.

75" Cape Verde don comot Sydny Lopes Cabral.

74" Torres shoot di ball into Cape Verde bodies.

72" Chance for Spain as Yamala dance enta di box, pass di ball to Llorente, instead say im go shoot, im also pass di ball again to Merino but im shot dey weak.

71" Just afta im enta di game, Yamakl already beat one pesin wey im try to create sometin vut Cae Verde dey kankpe for back.

Lamin Yamal and Mikel Merino don enta di game as Spain try to find di opening goal for dis game wit 20 minutes remaining.

68" COOLING BREAK!

67" Corner to Spain. Cabral no fit clear di ball from di area, na so e carry am comot for corner

65" Still 0-0 between di two teams.

64" Foul against Nuno Da Costa wey just enta di game. Di attacker foul Laporte.

63" Cucurella bin dey everiwia for di pitch, afta im lose di ball, di real Madrid player run put pressure to collect di ball

61" Throw-in, Cape Verde block Pedri and Gavi from creating any chance into dia box.

60" Three changes for Cape Verde, Nuno Dacosta, Deroy Duate and Yannick Semedo

59" All di crosses into di Cape Verde box dey easy for Vozinha to collect.

57" Shot! Aymeric Laporte shoot from outside doi box; di ball go ova.

Deroy Duarte bin dey prepare to enta di pitch for Cape Verde.

56" Chance! Ruiz weak header dey saved afat Cubarsi criss di ball into di box

Spain dey prepare to make changes as sdem dey struggle to take advantage of dia chances.

54" Spain begin to build up again from di back.

52" Oryazabal get chance to cross di ball inside box but im attempt be very poor.

51" Vozinha comot to catch anada cross by Pedri into di box and ref goive Cape Verde foul against Gavi.

50" Chance! Pedri try to pass di ball to Ruiz inside di Cape verde box, but di PSG player im shot once agains go ova.

47" Chance! Pedri cross di ball into di box for Oryazabal but im no fit direct di header towards di goal, di follow up end wit Fabian Ruiz but im shot go ova di bar.

46" Vozinha gada di ball as Spain try to enta di area for di first time dis second half

Dem dey pass di ball around like how dem do am di whole first half.

45" Spain bin pass di ball for di second half to begin.

How di second half go dey? Time go tell

Di first half end wit Spain failing to score any of dia chances, Cape Verde keeper Vozinha make plenty saves for di game.

Cape Verde frustrated the european Champions the entire game.

Wia dis foto come from, MATTIA OZBOT/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Cape Verde defensive wall prevent Spain from scoring for dia first game for di 2026 World Cup

First Half

HALFTIME!

49" Oryazabal meet Llorente im cross from di right but di effort be wayward.

48" SAVE! Laporte head di ball wey dey head into di far corner but goalkeeper Vozinha save am. Di Cape verde keeper na di man of di match so far.

46" All di chances dey fall for Spain but dem no fit carry even one score.

45+4 mins

44" Chance for Spain again! Ferran Torres im weak effort dey saved afta dem enta di box

42" Offside! Ref blow whistle as Pedri try to meet one ball inside di Cape Verde box.

41" Spain bin dey delay to take dia shots and cape Verde counter attack but dem no fit take advantage.

38" OFF DI POST! Rodri lob di ball ova di top, Cucurella carry head knack di ball back across di gaol instead say im go score, and Torres im shot hit crossbar bifor Vozinha catch di follow up

37" Chance! Cabral shoot from tight angle wey di ball go way ova di bar. Cape Verde dey create chances now.

OFFSIDE! Spain create one chance but Cucurella bin dey offside bufor im head di ball across, Pedri strike di ball from range but Vozinha catch am biofr di flag go up for offside.

35" Chance! Rodri don lose possession for midfield; Cape Verde try to score from dia thru Livramento, but di ball go wide.

33" Foul ball. Ferran Torress lose posession wey im foul Sidny Cabral when im dey try to recover di ball

OFFSIDE! Ref blow whistle for offside against Cape Verde captain Ryan Mendes. Im don vex.

32" Spain dey struggle wit dia final pass so far, Cape Verde dey defend well.

31" Chance! Ferran Torres pass di ball to Oryazabal, instead say im go shoot am at once, di Real Sociedad captain now take anoda touch wey carry di ball comot di goial area. Di chance don vanish.

30" Spain dey try to press di Caoe Verde defense well well but dem manage to clear dia lines.

29" Cucurella smash one shot from outside di box wey enta Row Z!

28" Chance! Ruiz bin play one fine pass inside di back of di Caope Verde defence for Cucurella, di Real Madrid leftback cut di ball back for Gvi but dem block im shot.

26" Shot! Cape Verde striker Steven Moreira strike di ball but Cucurella don block am

25" Cape Verde begin to pass di ball; dem dey try to penetrate di Spain midfield but di ball neva dey enter.

Di game don restart.

22" COOLING BREAK!

21" Offside! Ref blow whistle against Cape Verde cpatain Ryan Mendes as dem try to create some chance.

20" Spain get ova 70% of di possession so far but nothing to show.

19" Cubarsi try to shoot from outside di box wey di ball knack im own teammate Ruiz bifor e comot for goalkick.

16" Chance for Spain go waste. Di Atletico Madrid player enta di box but im cross no fit beat Sidny Cabral.

15" Yellow card for Sidny Lopes Cabral afta im throw hand for Marcos Llorente face.

14" Ball don fall to Pedri in front of di Cape verde box but im shot be weak.

13" So far no team create clear chance but di possession all dey Spain dema side.

12" Oryazabal tink say im go meet one Pedri cross to score; goalkeeper Vozinha miss di ball but im defemders clear am

11" Cape Verde try to play di counter attack afta poor corner kick from Pedri but Spain stop di attack.

10" Corner to Spain afta Jivane Cabral blocl Marcos Llornte im ball.

9" Livramento wey dey strike for Cape Verde fall for ground as im try to collect one high ball inside di Spain area. Ref say play on.

7" Kevin Pina hustle wit Gavi to clear one ball as di Barcelona player dey try to cross di ball inside di box

6" Fans for di stadium dey chant for Cape Verde anytime dem bin get di ball.

5" Jovane Cabral try to dribble one Spain player but im lose di ball bifor im keeper Jozinha catch di cross from di left hand side.

4" Cape Verde try to string three, four passes togeda bifor dem lose di ball; Cape Verde now get throw-in

3" Spain get di ball again wit dia possession. Dem try one cross-field pass but Cape Verde don defend well

2" Di ball return to Spain; dem dey try to create chance, Ferran Torres tink say im bin win corner kick but VAR say na goalkick.

Referee don blow whistle for freekick for Cape Verde afta Cucurella foul im marker for di far right

Spain begin to pass di ball around as usual for di first minute

1" Referee don blow whistle afta di countdown - and match don begin.

Dem begin to sing di national anthem for di two teams.

Spain bin dey wear dia blue jersey wey Cape Verde dey weat dia all-white jersey. Tins don set now.

Di fourth official na Andres Rojas from Colombia; VAR ref na Joseph Dickerson from di US and VAR assistant 2 na Khamis Mohamed Al Marri from Qatar

Center referee and im two assistants be from Jordan. Adham Makhadmeh, assistant 1 Mohammad Al-Kalaf and Ahmad Al-Roalle as assistant referee 2.

Referee and oda officials don lead di two set of players to di pitch.

Fans bin gada for di stadium wey di sun dey up – for di Atlanta Stadium.

Welcome everibody to dis live text commentary for di game between Spain and Cape Verde

Di first game for Group H for di World Cup dey hia. And as we tok am for di build up, Island kontri Cape Verde bin dey appear for di tournament for di first time eva, wey dia first match be against former World and reigning European champions – Spain.

Many tins dey at stake for dis match – for Africa, anoda team for di continent dey try to get point for dia group opener afta Ivory Coast take all three points from Ecuador, wey Tunisia suffer 5-1 trashing against Sweden.

Morocco wey finish fourth for di 2022 World Cup for Qatar bin play 1-1 draw wit Brazil.

Time don reach now for Cape Verde to also try to find dia first points for di World Cup, but na ogbonge tin for dem as Spain wey be one of do favourites bin dey stand for dia way.

Both coaches bin dey show respect to each oda ahead of di game – De la Fuente of Spain tok say Cape Verde get technical team wey dem be competitive, wey Bubista of Cape Verde sabi di quality Spain bin get.

Im tok say dem go play without fear for dis game and hope to get di points to make history for dia kontri.

Lineups don drop – as expected Lamin Yamal and Nico Williams bin dey fit to dey di bench for Spain.

Marc Cucurella wey don sign for Real Madrid from Chelsea today, bin dey start for left back.

For Cape Verde, dia experienced captain Ryan Mendes and goalkeeper Josimar Dias (Vozinha) dey for di starting XI.

Spain XI; Unai Simon (GK), Marc Cucurella, Aymeric Laporte, Pau Cubarsi, Marcos Llorente, Rodri ©, Pedri, Fabian Ruiz, Ferran Torres, Pablo Gavi, Mikel Oyarzabal

Cape Verde XI; Josimar Dias 'Vozinha' (GK), Edilson Borges 'Diney', Roberto 'Pico' Lopes, Kevin Pina, Jovane Cabral, Jamiro Monteiro, Sydny Lopes Cabral, Laros Duarte, Dailon Livramento, Ryan Mendes ©, Steven Moreira

Di game go soon begin at 4PM GMT (5 PM WAT).

Match Buildup

World Cup debutants Cape Verde from Africa go face 2010 World Champions Spain for dia first group game for di tournament on Monday, 15 June for di Atlanta Stadium for US.

Di Island kontri bin make history to become di third smallest kontri to qualify for di tournament behind Curacao and Iceland, wey dem go face Spain for di first time eva, for di senior level.

Already, Ivory Coast don become di first African kontri to get three points for dia first game for di competition afta dem sama Ecuador 1-0 on Monday dawn.

Tunisia bin suffer heavy 5-1 defeat for Sweden wey Morocco and Brazil play 1-1 draw for dia first group game.

Cape Verde get opportunity to join Ivory Coast and get dia first three points but e neva go dey easy for dem.

Dem bin dey di same group H togeda wit Saudi Arabia and Uruguay.

Coach for di Island kontri say dem go play "witout fear" against di former World and reigning European Champions.

Team news

Spain wingers Lamin Yamal and Nico Williams both don recova from hamstring injury but e no dey clear if dia coach De La Fuente go select dem for dis game.

Yamal na dia star player wey help dem win di Euros two years ago wen im be 16 years.

Many pundits believe say di Spanish League player of di season go be di one to make di difference for dem for di tournament.

Apart from dis two players, Arsenal midfielder Mikel Merino wey also bin return from injury dey available for selection.

Di midfielder bin score six goals for di qualifiers for di tournament bifor im get injury wey make im no play most of di season for Arsenal.

But im dey ready.

For Cape Verde, dia coach dey expected to rely for dia core group of players wey bin help dem qualify for di competition.

Dis be one of di most important games for dia history wey dem go hope to get good result.

Cape Verde bin win evri game for dia home witout conceding a single goal for di qualifiers, wey dem finish ahead of Cameroon.

Dia coach go dey hope dia top scorer for di qualifiers Dailon Livramento togeda wit veteran forward Ryan Mendes and Josimar Dias (dia goalkeeper) go dey on form against La Roja.

Cape Verde would be looking to cause an upset

Wia dis foto come from, FLORENCIA TAN JUN/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Cape Verde coach Bubista say dem go play against Spain "witout fear"

Wetin di coaches and players tok ahead of di game

Spain Coach Luis de la Fuente say "Cape Verde get clear tactical concept, dem dey build up well wey dem get physical and powerful players".

Im add say "many of di players bin dey play for Europe for competitive level, na so e go be ogbonge match – we gatz be at our best to compete."

De la Fuente also confam say Nico Williams and Lamin Yamal dey available but dem no go start di game - dem go only play some part but e dey depend on how di game don dey go.

Midfielder Mikel Merino say "di important tin na to focus for oursefs and wetin we gatz do; we gatz take di game seriously sake of we for start di tournament well".

Cape Verde coach Pedro Leitão Brito wey dey popular as Bubista say dem go fight well well.

"We wan show wetin we do for di qualifiers, we want compete wit our own identity like how we bin play di qualifiers to show di world wetin we get as a team."

Bubista add say "we sabi say e neva go dey easy wey we sabi well di value of Spain but we all go play di game for di pitch".

Cape Verde captain Ryan Mendes say "we dey expect difficult game against one of di best teams for di world".

"Spain dey stronger wit Yamal but whoever go play di match go still cause us trouble, na so we gatz dey solid for defence and try to cause dem trouble. We gatz dey our best"

Possible lineups

Spain XI; Simon; Llorente, Cubarsi, Laporte, Cucurella; Rodri, Pedri, Fabian Ruiz; Ferran Torres, Oyarzabal, Baena

Cape Verde XI; Vozinha; Moreira, Borges, Lopes, Paulo; Lenini, Yannick Semedo; Mendes, Monteiro, Willy Semedo; Livramento

Di game go happun at 4PM GMT (5PM WAT) for di Atlanta Stadium for di US.

Make una join us for live text commentary for dis game.