Nice terror attack: France knife stabbing, decapitation for Notre-Dame church link to terrorism - Mayor Estrosi

Nice terror attack

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Dem detain di suspect for di basilica shortly afta di attack.
Published

Knife stabbing attack for Notre-Dame basilica Church for France city of Nice kill at least three pipo and wunjure oda pipo well-well, Police tok.

Dem detain di suspect for di basilica shortly afta di attack around 9am Thursday morning.

Di mayor tell tori pipo say di suspect bin "repeat witout end 'Allahu Akbar' (wey mean God dey greatest) wen dem bin dey treat for wia di attack happun".

E say everihing point to "terrorist attack for di heart of di Notre-Dame basilica".

Police tok say one woman na im dem behead [decapitation] for di attack and Mr Estrosi tok of "islamofascism".

Oga Estrosi tok say one of those wey die na di caretaker for di basilica.

Nice terror attack

Wia dis foto come from, Christian Estrosi

Wetin we call dis foto, Di area around di basilica don dey seal off afta di attack (picture courtesy of Christian Estrosi)

French President Emmanuel Macron dey head to di place wia di attack happun.

Di interior minister don beg pipo to avoid di area for di centre of di French Riviera city. Gérald Darmanin tok say im bin dey convene one crisis meeting for di ministry in side Paris.

Di National Assembly observe one minute of silence, wia dem for give Prime Minister Jean Castex details of lockdown measures wey go begin take effect from Thursday night.

"Without question dis na very serious new challenge wey dey striking our kontri," e tok, e also beg for unity and cohesion.

Wia Nice Notre-Dame basilica church dey?

Nice terror attack and knife stabbing, decapitation for Notre-Dame church
Wetin we call dis foto, Map wey show Notre Dame basilica

Nice na di target of one of France deadliest attacks in recent years, wen one 31-year-old Tunisian drive one truck enta inside crowd of pipo wey dey celebrate Bastille Day on 15 July 2016, killing 86 pipo

Map
1px transparent line