You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Omar al-Bashir: Sudan president dey trial for 1989 coup
Sudan longest serving wey dem sack from office, Omar al-Bashir dey face trial for di kontri capital, Khartoum, sake of military coup wey bring am to power more dan thirty years ago.
Di seventy-six years old man wey don chop corruption charge, fit face death penalty if dem find am guilty of di 1989 coup.
Dem fit charge am plus more dan twelve former goment officials.
Na by force dem take pursue al-Bashir comot from power afta plenty serious protest for 2019.
Di civilian i-no-go-gree for di konri start towards di end of 2018 as protest against austerity but later turn to make President al-Bashir resign.
On 11 april 2019, di military announce say dem don remove am from office plus arrest am.
For august 2019, dem form transitional goment wey include army officials and civilians.
International Criminal Court (ICC) dey also find am for alledged war crime and genocide for di western Darfur region.
End of Di one wey oda users dey read well well
For February, Sudan goment bin say dem ready to hand am ova to di ICC.