US scata magomago birth tourism network for West Africa, North Africa and Europe

Published
Read am in 4 mins

United States govment say dem don end illegal birth tourism schemes, as dem scata one multiple international birth tourism networks for West Africa, North Africa and Europe and withdraw hundreds of visas.

Di Department of States for series of post on X tok say US embassies discova several operations wey allegedly dey use fake documents plus visa "fixers" to help foreign nationals get visa to born for di kontri and secure American citizenship for dia children.

Di department say one US embassy for West Africa bin uncova one network wey involve more dan 100 foreign nationals wey allegedly use fake documents and visa fixers to get US citizenship for dia children.

State Department officials say dem don shut down di operation, revoke di visas of di pipo wey dey involved and authorities dey work wit local partners to identify and cut off similar schemes.

"Under President Trump, di State Department dey defend di integrity of U.S. citizenship by ending illegal birth tourism schemes. No foreigner suppose get visitor visa just becos dem wan go America go born pikin make dat pikin collect U.S. citizenship,” US Department of State tok.

Di Department of State add say anoda US embassy for North Africa don also withdraw 100 visas for "birth tourist" parents wey enta America just to born so dia pikin go get US citizenship.

Di agency say consular officers dey work wit law enforcement to identify di several networks wey dey abuse di system and to stop dem.

Dem also confam say one US embassy for Europe discova more dan 400 suspected birth tourism cases since 2024.

Investigators allegedly trace dem to at least six companies wey dey coach applicants on wetin to tok for dia visa interview, arrange accommodation for America and set up childbirth plans.

However, di department of states no identify di kontris wey dey involved for di scheme, dem no disclose di nationalities of dose wey dey affected or provide evidence to support di allegations.

Dem also no tok weda dem don effect any arrests or send anybodi go prison from di investigations.

For January 2020, US govment bin change di visitor visa regulations, wey allow consular officers to deny applications wey dem believe say di primary purpose of travel na to go born for United States to secure citizenship for dia pikin.

Di law still dey in force and don bicom key tool for US efforts to tackle birth tourism.

For 2024, Di United States Mission for Nigeria bin announce say dem go deny di visa application of foreign nationals wey dem suspect say wan travel go America to go born, so dia pikin go get US citizenship.

Di advisory bin come afta one Supreme Court ruling for June wey allow US President Donald Trump to go ahead wit im executive order of ending birthright citizenship.

Di Supreme Court ruling bin limit di power of federal judges to block presidential orders and allow for di birthright citizenship policy to start in 30 days. Although, some lower courts don file counter lawsuits against di ruling.

Di crackdown dey come for di middle of President Trump administration to tighten immigration controls and fight visa fraud.

For early dis year, US Immigration and Customs Enforcement bin launch one initiative wey di aim na to identify birth tourism schemes and scata organised networks wey dem suspect say dey facilitate such travel.