You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
EFCC arraign Blessing CEO sake of stage 4 cancer claim and donations
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arraign Blessing Okoro aka Blessing CEO ova alleged 13 million naira fraud.
Di anti-corruption agency arraign di influencer for di Federal High Court for Ikoyi area of Lagos bifor Justice Yelim Bogoro on Wednesday, 10 June.
Dem arraign am on six-count charge wey border on obtaining money by false pretence and retaining di proceeds to di tune of 13,000,000 naira.
Dis na afta di receipt of several petitions from individuals and groups, including di Nigeria Cancer Society.
"Di petitioners allegedly make donations to di defendant afta her social media posts wey claim say she bin dey battle stage 4 breast cancer and seek financial support for treatment.
"She bin dey, however, later discovered to don allegedly falsify document she bin present to members of di public," EFCC tok.
Dis new arraignment dey come a day afta di agency arraign Blessing CEO ontop accuse of 69,150,000 naira ($50,858.30) alleged magomago.
EFCC on dia official X account on Tuesday, 9 June say dem carry Blessing CEO go court again on two-count charge wey border on accuse say "she obtain money by false pretence and stealing wey amount to 69,150,000 naira (sixty-nine million, one hundred and fifty thousand naira).
Di Nigerian corruption police announce di informate di same day one Federal High Court for Lagos grant di influencer bail on top accuse of rental fraud wey reach 36 million naira naira ($26,000) wey EFCC bin earlier gbab her for.
Calls on EFCC to prosecute Blessing CEO
Several Nigerians bin call on di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to prosecute Blessing CEO ontop accuse say she make false claim say she get stage 4 cancer and receive monetary donations from Nigerians.
According to di influencer, Nigerians bin donate 13 million naira for her afta she come out to solicit funds.
Wen di video of her stage 4 cancer claim go viral, some Nigerians no believe am and dem request say make she post her medical results on social media, while some express pity for her alleged condition.
For one viral interview wit internet personality Egungun of Lagos, Blessing CEO say na miscommunication happun wey make am believe say she get stage 4 cancer.
"I neva start chemo - I just get di result - dem dey call am biopsy. Na lump. Initially dem say e no dey cancerous, afta few months wen I bin wan take out di lump, dem kon tok say e dey cancerous," she tok.