You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Carlo Ancelotti: Everton don appoint Champions league winning coach as manager
Everton don appoint Carlo Ancelotti as dai manager for four-and-a-half-year deal.
Ancelotti wey Napoli bin sack early dis month, go take ova from Marco Silva, wey Everton sack for 6 December.
Ancelotti, wey be Italian na three-time Champions League-winning coach. E return to English football eight and a half years afta Chelsea sack am.
Everton announce Ancelotti arrival on Saturday before di home Premier League game against Arsenal, wey appoint former Gunners and Toffees midfielder Mikel Arteta as dia head coach on Friday.
Ancelotti wey be 60 years old go officially take ova Sunday and im first match in charge go be di home game against Burnley on 26 December.
Oga Ancelotti wey be former AC Milan, Real Madrid, Bayern Munich and Paris St-Germain boss tok say Everton "na great club with rich history and a very passionate fanbase."
"E get clear vision from di owner and di board to deliver trophies. Dat na something wey I like me as a manager.
"I dey happy say I go dey able to work with everybody for di club to help make dat vision to dey real."
End of Di one wey oda users dey read well well
Ancelotti don win 15 major trophies during im career and im na one of only three managers to win three European Cups/Champions Leagues - along with Liverpool legend Bob Paisley and Real Madrid boss Zinedine Zidane.
E guide Chelsea go di Premier League and FA Cup double during im first season in charge for 2009-10 but dem sack am afta e fail to win trophy for di following campaign.
Everton director of football, Marcel Brands tok say Ancelotti na "one of di finest managers for di world football" and na "proven winner".
"Carlo na di perfect appointment for us," e add.
"E know how to build trophy-winning side and we share di excitement of our fans for di prospect of him leading our team for di years ahead."
Everton start di weekend 16th for di Premier League table - three points above di relegation zone.