You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mikel Arteta: See wetin you need to know about di new Gunners manager
Arsenal don appoint dia former player Mikel Arteta as dia new manager.
Di former Gunners midfielder bin dey work with Pep Guardiola as coach for Manchester City, im join dem afta im retire as player for 2016.
Im go replace Unai Emery wey Arsenal sack for early November but dem neva announce im coaching team yet.
Arteta wey be 37 years win FA Cup two times for di five years wey im spend with di Gunners.
"We need to dey compete for di top trophies for di game," na wetin Arteta tok
"Dat one dey very clear to me, when I discuss with di [owners] Stan and Josh Kroenke and senior pipo from di club."
Arsenal dey siddon for number 10 position for Premier League table with 22 points.
See wetin you need to know about di new Gunners manager
Arteta sign three-and-a-half year contract with Premier League club Arsenal.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 37 year old, na former Arsenal club captain, wey play five seasons for di club, from 2011 to 2016.
As player for di club im win two FA Cups titles.
Before im join Arsenal as dia new manager im bin dey part of Pep Guardiola coaching staff for Manchester City.
Arteta na di 20th manager wey di club go appoint inside dia 133-year history.
Di former midfielder sabi speak plenty language dem, im dey speak Spanish, Basque, Catalan and English well-well. Im also dey speak French, Italian and Portuguese small too.