In order for any party to win de 2020 elections, dem for win at least two out of de three battlegrounds.
Dis be Greater Accra, Central den Western Region.
Historically, dis coastal regions who dey change dema voting pattern in every election - so all eyes dey on Accra, Central and Western ahead of de elections.
In addition to winning these regions, de NPP and NDC get dema strongholds or what Ghanaians dey call - "world bank."
De volume of votes from Ashanti Region dey determine how well NPP go perform.
Wey volume of votes from Volta Region dey determine how opposition NDC go perform.
In 2016 for instance, NDC record 115,000 less voter turnout for Volta Region compared to de 2012 turnout, contributing partly to dema loss.
So on December 7, dis be de elements wey you for look out for if you want see who dey win or lose.