You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

See everitin wey happun during Ghana 2020 Elections

Ghana election 2020 latest news from BBC Pidgin as Ghanaians dey go to polls on Monday 7 December.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Princess Igho Williams

  1. Video of Akufo-Addo receiving brown envelope - Donation or bribe?

    One viral video of Prez. Nana Akufo-Addo receiving brown envelope wey Adom TV show on 1st December, 2020 don spark debate of which narrative be true - a donation or bribe?

    De Management of Adom TV write on Wednesday 2 December say dem find out say contents of de video be false as e no represent de full story as dema understand.

    Adom TV go on to say in fact, dis be video of de then candidate Nana Addo Dankwa Akufo-Addo in October 2016 receiving a donation of USD $40,000 for his campaign.

    Adom TV therefore unreservedly apologises for any harm or embarrassment dee video fit cause de President and admits say de publication happun in error.

    Minister of Information, Kojo Oppong Nkrumah don ask de general public to disregard de bribery allegation levelled against de President, stressing say e be false information being propagated by de opposition National Democratic Congress (NDC).

    Mr Oppong Nkrumah say de encounter captured on tape happun at a time Akufo-Addo no be president yet for October 2016 wey be donation some one make.

    BBC Pidgin don examine de video too but find out say wetin people be talk about de video and what really happun inside de scene of de video dey different.

  2. Adom TV Akufo Addo bribe scandal viral video - Wetin we know

  3. “Ghana economy dey inside intensive care unit”

  4. How to benefit from Ghana scholarship for Free SHS graduates

  5. NDC drag God into Ghana election wit 3 days fasting and prayer

    De opposition National Democratic Congress dey start 3-day nationwide fasting and p;rayer sake of di 7 December polls.

    De prayer wey go start on Thursday go end on Saturday. Inside statement wey di National chairman of di party,

    Samuel Ofosu signm he say de prayer na for God to intervene for de general election.

    "E dey important as a party, we call on God for intervention to support our hard work and determination to win de 7 December general elections". part of de statemene\t tok.

    Oga Samuel Ofosu tok say dem don dey reach di crucial stage of de election.

  6. Breaking, Ghana president declare December 7 as national holiday

    Ghana President, Akufo-Addo don declare December 7, 2020, as national holiday.

    De day wey falls on Monday na de same day de whole country go come out to vote to elect who dem want to be dia president and parliamentarians for di next 4 years.

  7. “Ghana economy dey inside intensive care unit”, John Mahama talk BBC Pidgin inside exclusive interview

    John Mahama, Presidential Candidate of de National Democratic Congress, say de economy of Ghana dey inside intensive care under de current govment.

    Mr Mahama talk BBC Pidgin inside exclusive interview say de Ghana economy crumble under de leadership of President Akufo-Addo.

    According to am “dis economy be de worst under de Fourth Republic.

    Finance Minister dey cook de books.” “Since we leave office Ghanaians dema lives make worse, de economy make worse,” he add.

    Ghana dey go de polls on December 7 to elect new leader.

    Top candidates in de race, NPPs Nana Akufo-Addo and NDCs John Mahama be favorites out of 12 presidential candidates.

  8. "I stand for peace election 2020", Young Ghanaians stand shoulder to shoulder.

    Stoneboy organize peace walk to prevent violence during and afta de elections.

  9. Check Ghana Elections 2020 gender statistics

    2020 General Elections Voters Register-Gender Statistics according to EC.

    Of de over 17 million registered voters for de 7 December 2020 general elections, na female gender plenty pass.

    Acording to de Electoral Commission na 51.7% of dis nu.ber na females while males be 48.3%.

    E represent 8,810,283 females and 8,22,358 males inside de final voters register.

    And de statistics data also show say na over two point six million young voters between de ages of 18 and 21 dey registerd to voter during de Ghana elections 2020.

  10. , .

  11. Today Daily Election Security Tips - Ghana Police Service

    Today Daily Election Security Tips from Ghana Police Service be about fake news.

    Police de draw ear give public na electoral offence to spread fake news.

    So make you shine ya eyes well well before you share any info on social media.

  12. Offence, wetin to do and not to during Ghana election 2020

  13. EC message to voters after Special Voting in Ghana

    Special Voting in Ghana results na im Ghanaians dey wait on Wednesday morning, after Tuesday exercise for security and essential workers.

    Ghana Electoral Commission no tok anytin about de results as e e say dis na pasrt of de 7 Dcemeber vote.

    EC Ghana message dis morning na:

    "We thank all voters who turn out Tuesday to peacefully participate in de Special Voting. All de systems and protocols workwell and de Commission be ready to hold an equally smooth process on 7th December, 2020. Make Peace Reign!"

  14. Interesting facts & lifestyle of Prez. Nana Akufo-Addo

  15. Today Election Security Tip from Ghana Police

    Daily Security Tips on electoral offences for today be say:

    "Election Observers no get power to insult Electoral Officials, dem go only draw dia attention to anything wey no dey normal.

  16. Ghana 2020 election special voting & Covid-19 safety protocol, Ghana voting centers observe Covid-19 safety protocol during special voting

    All 311 voting centers for Ghana dey observe COVID-19 safety protocol in de ongoing special voting exercise.

    Electoral Commission of Ghana appoint COVID-19 ambassadors for de voting centers who dey ensure say voters wash dema hands, sanitize den stuff.

    According to the Electoral Commission, the exercise is taking place at 311 designated voting centres located in all the 275 constituencies.

    COVID-19 ambassador, Desmond Agyare for Osu Police Stattion which dey under de Korle Klottey Constituency talk BBC Pidgin say "I dey make sure everyone wash hands and sanitize."

    "After I now go check dema temperature den make sure say dem wear nose mask before dem go meet electoral officers" he add.

  17. Fotos of Ghana Election 2020 Special Voting in progress

  18. Video: How Ghana "first past the post voting system" dey work, Watch dis video explainer for simple understanding of Ghana Elecetion 2020

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Since de inception of de Fourth Republic, Ghana dey practice voting system - First Past the Post alias Simple Majority.

    Dis system be one of de most straightforward ways to determine who go win elections in most political systems.

    Under de "First Past the Post" or simple majority system, de candidate with de highest number of votes be winner of de election.

    In other words, de candidate wey go get majority votes be winner of de elections.

    Per de 1992 Constitution of Ghana, candidate who go gather 50 percent plus of valid votes cast be winner of de elections.

  19. EC dey use backup biometric devices in case of breakdown

    Electoral Commission for Ghana dey use backup biometric devices in case equipment break down during de special voting exercise.

    Ayawaso Central Electoral Officer for Gladstone Agboada, talk BBC Pidgin say dem get backup devices in case de devices mess up.

    All de special voting centers get backup biometric devices to help make de process smooth.

    Some 1063 voters dey take part in de special voting exercise for ATTC polling station, Ayawaso Central Constituency.

    Officials divide de polling station into A and B so say traffic go flow smoothly for de voting center.

    As at 9.35am officials talk BBC say dem record 200 votes, meanwhile more people dey queue inside dey wait for dema turn.

  20. Voters turn out in good numbers for Ghana special voting

    Voters turn out in numbers to participate in de early voting exercise for Ghana. At de Nima Police Station polling center, 107 people out of 487 vote as at 8.30am.

    Polls open around 7.00am dis morning, Electoral Officer, Samuel Anim Ofori talk BBC Pidgin say de turn out be impressive so far.

    Mr Ofori explain say so far dem no experience any challenge plus de verification biometric devices.

    “De only issue we get be say some people come here to vote but dema name no dey on dis polling station register.

    So we check carefully and direct dem to de right polling station dem for do de special voting for” he reveal. De voters wey BBC Pidgin see for grounds dey include uniformed police, military officers, immigration officers den stuff.

    See more pictures from voting.