You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

See everitin wey happun during Ghana 2020 Elections

Ghana election 2020 latest news from BBC Pidgin as Ghanaians dey go to polls on Monday 7 December.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Princess Igho Williams

  1. NDC ask supporters to storm collation centres, .

    De opposition National Democratic Congress (NDC) dey claim say dem don swap some 36 constituencies wey de ruling bin win for 2016 elections for Monday's elections.

    De Director of Elections of the NDC, Elvis Afriyie Ankrah announced dis at a press conference [NDC] organised at 12:40am, on Tuesday 8 December, 2020.

    But dat claim remain unverified as de National Electoral Commission na get de right and power to confirm any results.

    E be about 275 parliamentary constituencies across de 16 regions of Ghana dat be contested by various candidates for Monday 7 December polls.

    De NDC command centre direct all dia supporters to storm de collation centre claiming say na dia dem fit change results, so make dia supporters be vigilate.

    NDC also earlier call for swift action against persons caught indulging in electoral mago-mago.

    Elvis Afriyie Ankrah, de Director of Elections of the Party, tok for a press conference that there be reports of alleged ballot stuffing in some parts of de country, as well as a shooting incident at a polling station in de Awutu Senya East Constituency.

    Ghana Police Service confim de shooting incident for Awutu Senya East Constituency.

  2. Ghana presidential election results counting in progress - Wetin we know so far, .

    Ghana elections don enter concluding stage as counting dey in progress.

    Ghana presidential election providional results dey expected within 24hours, according to de country electoral commission.

    A Presidential winner in Ghana must obtain not less than 50% +1 of de total valid votes cast, de Electoral Commission talk on Tuesday morning.

    Reports wey BBC Pidgin dey examine dey indicate say dis election be tightly contested election between de ruling NPP and de main opposition NDC.

    Jean Mensa, de woman wey dey organize dis election don warn say make political parties and media houses avoid to declare any results.

    De Chairperson of Ghana Electoral Commission say na only dem get right to announce results according to di law.

    Ghana EC don maintain commitment to announce results within 24 hours after de close of polls at 5pm GMT on Monday.

  3. John Mahama, Nana Akufo-Addo message Ghanaians on Ghana election results

  4. How EC plan to declare results of Ghana polls, .

    As de counting and tallying process continuou across de country, here be all you need to know about de collation process and announcement of election results.

    De collation and declaration of de presidential election results go happen in three steps.

  5. Ghana Electoral Commission Regional Director for Ashanti address issue of five fake ballot papers, How EC plan to declare results of Ghana polls

    Benjamin Bio, de Ghana Electoral Commission Regional Director for Ashanti address issue of five fake ballot papers wey dem gbab from one of de voters for de Region today.

    Bio show tori pipo de authentic ballot papers compared to de one dem gbab from de offender.

    During one Press Conference e hold on Monday night afta 9 O'clock, en say de electoral commission dey committed to transparency all through de election.

  6. Polling stations don officially close for Ghana election, .

    Polling stations don officially close for Ghana election.

    Now, attention go leave polling stations and move to de Collations centers for de 16 regions wia dem go announce results.

    Meanwhile, Ghana Police arrest di two Electoral Commission officers wey temper with di presidential ballot paper for Awutu Senya West and Bawku central.

    Also, Ghana Police Service confirm say two people sustain gunshot wounds for Awutu Senya East.

    Ghana president, Nana Akufo-Addo don call for vigilance not violence. Ghana electoral body say na within 24 hours.

    Just follow BBCPidgin website and Facebook page to get di result.

  7. Police arrest Ghana election officials wey tamper with Presidential ballot papers

    Ghana Police don arrest di two Electoral Commission officers wey temper with di presidential ballot paper Awutu Senya West and Bawku central.

    Di country Electoral commission wey talk dis one promise di general public say di two officers go face di law.

    " Electoral Commission wishes to inform de general public that de two officers who tampered with de presidential ballot paper in Awutu Senya West and Bawku central have been arrested and dem currently dey in police custody.

    De officers na:

    Mary Adatsi DAJHS, Twimine B110104A, Awutu Senya West. and Ahmed Shafawa, Alhaji Salam Grinding Mill Polling Station Bawku Central.

    De police say in de case of bawku central, only one of such ballot na im dem use.but for de case of Awutu Senya West none of de ballot dey used.

    "De commission dey assure de general public that de police will be prosecuted and dealt with by law."

  8. Video/photos of car wey gun men shoot at in Kasoa for de Awutu Senya East constituency

  9. Rain disrupt voting proceedings for Community center inside Ketu North Constituency

    Rain disrupt voting proceedings for Community center at siagorme polling station for de Ketu North Constituency for one hour according to de Preciding Officer, Albert Atsu Dzotefe.

    Dis happen around 12:55pm and e prevent pipo wey dey queue inside from voting.

    Total for de register be 402 but 225 go through de process before de rains come inside.

  10. Ghana Strategize to support border security on election day

    De Chief superintendent of Ghana Immigration for de Aflao sector command, Fred Duodu talk BBC pidgin how dem take strategize to support border security on election day.

    "We no get enough men for de Ketu South constituency so we strategically go deploy men wey dey unauthorized routes make dem come support during vote counting."

    According to de immigration boss, as at about 9am, dem go get security make dem police de voting process for 27 polling stations for Agbozume so dem for call back officers wey for dey rest after dema night duties.

  11. Jane Naana Opoku-Agyemang, NDC Vice Presidential Candidate don vote

    Jane Naana Opoku-Agyemang, NDC Vice Presidential [female] Candidate don vote.

    She cast her ballot for Anomako JHS A polling station in Komenda and post for her facebook say;

    "I vote John Mahama as president of Ghana and Samuel Atta Mills as MP for the KEEA constituency."

    Madam Jane Naana Opoku-Agyemang say she vote for progress, development, inclusion and better Ghana. It is important to go out and vote.

  12. John Mahama wife Lordina cast her vote together with her children

    John Mahama wife and Ghana former first lady, Lordina Mahama don cast her vote together with her sons.

    Lordina and the boys vote for de Next Page Polling Station in Tse Addo, in de La Dadekotopon Constituency.

  13. Two people sustain gunshot wound after shooting for Ghana election today

  14. Two people sustain gunshot wound after shooting near polling station for Awutu Senya East

    Two persons don sustain gunshot wounds near de Steps to Christ polling station in Kasoa for de Awutu Senya East constituency after some men in black SUV fired at dem.

    Ghana Police service don confirm de report and tweet say;

    "At Kasoa in de Awutu Senya East Constituency however, Police is on chase for occupants of one black 4×4 SUV wey shot occupants of one silver coloured Kia private salon car with registration No GW 2375-20...

    "Dem don rush de occupants wey injure go hospital and dem deyrespond to treatment."

    "Police dey investigate any allegation of impropriety so far receive."

    E no dey clear wetin led to de shooting incident.

    Report say incidence of violence for dis same centre during de voter registration exercise.

  15. 95 year old grandmother, Cecilia Quaye cast her vote

    95 year old great grandmother, Cecilia Quaye cast her ballot in de ongoing Ghana elections.

    She tell BBC Pidgin say; “I make very happy to vote in de election” Her grandson help am walk to de polling station to cast her ballot."

  16. Ghana Electoral commission confirm alleged Cases of Tampering With Presidential Ballot Papers.

    Ghana Electoral commission confirm alleged Cases of Tampering With Presidential Ballot Papers.

    "Information wey dey reach de commission show say isolation cases of presidential ballot papers tampering happun with in some polling station in Awutu Senya West and Bawku Central Constituencies."

    De commission say their official wey dey work with de Ghana police service don identified de suspected officer and remove them from post until further investigation.

  17. Physically challenged Elias Ekuamoah say he make happy say de voting area be disability friendly.

    Im talk say he sure say he make de right choice for de person wey go implement policy in de interest of de ordinary person like am.

    He cast im vote for de EP JHS Tegbi Aklamatsi polling station

  18. Physically challenged Elias Ekuamoah say he make happy say de voting area be disability friendly

  19. See Polling station wey people no dey stand to queue

    Dis na M/A Experimental polling station, for here people no dey stand to queue.

    Chair dey for people wey come vote.

  20. Women turnout plenti for Mallaga internet Cafe voting area, Kumasi

    Women turnout plenti for Mallaga internet Cafe voting area for Asawase constituency, Kumasi for de Ashanti region.