You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

See everitin wey happun during Ghana 2020 Elections

Ghana election 2020 latest news from BBC Pidgin as Ghanaians dey go to polls on Monday 7 December.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Princess Igho Williams

  1. Wetin President Nana Akufo-Addo don tok since after de polls?, .

    President Nana Addo Dankwa Akufo-Addo never make any statement in de last 24 hours.

    However just before and after de elections de president wey be de ruling NPP presidential candidate make a few statements.

    On de election night, Akufo-Addo send messages to Ghanaians as dema await provisional results Ghana election.

    NPP [New Patriotic Party] presidential candidate message na "Remain vigilant, protect de ballot".

  2. Wetin John Mahama don tok since after de elections?, ."I want to state categorically say I no ever congratulate anybody, and we go resist any attempt to steal dis election."

    John Dramani Mahama of de NDC, de main rival of President Nana Akufo-Addo of NPP don make some statements since after de election.

    Mahama on Tuesday say:

    "I want to state categorically say I no ever congratulate anybody, and we go resist any attempt to steal dis election."

    "We win de election for 10 out of 16 Regions."

    On Monday night John Mahama of NDC send messages to Ghanaians as dema await provisional results Ghana election.

    NDC [National Democratic Congress] candidate Mahama message na "Thank you for voting for change"

    Dis morning Mahama never make any comment.

  3. Stories of attempt to falsefy Ghana Presidential election results be false - EC Chair

    Jean Mensa, de woman who go declare de winner of 7 December election say stories of attempt to falsefy Ghana Presidential election results be false.

    Mensa wey be de election Returning Officer and Chairperson of Ghana Electoral Commission tell BBC Pidgin on Wednesday day early morning say such stories no dey true.

    She say dis year, new transparency na im dem don introduce in de result collation process and so de public should ignore de stories wey dey fly up and down.

    Recall say last night one of de main contenders for dis election John Mahama of de [NDC] National Democratic Congress bin raise alarm of attempt to falsefy de presidential election results.

    Mahama warn say dem go resist any attempt to change de will of de pipo.

  4. How Ghana Elections "first past the post voting system" dey work

  5. Breaking, Ghana Presidential Election Results - See wia things stand right now, .

    EC Ghana don certify declare 43.75 percent of de total provisional presidential results from de 7 December election wey happun for Ghana

    Ghanaian Electoral Commission [EC] declare seven of de 16 Regions presidential election results

    De declared be de following: Ahafo, North East, Central, Upper West, Volta, Bono and Oti

    John Dramani Mahama, de former president and Nana Addo Dankwa Akufo-Addo, de current president be de two main candidates

    From de seven declared results so far, Akufo-Addo clinch four: Ahafo; North East; Central and Bono.While Mahama take de rest three: Upper West, Volta and Oti.

    Ghana EC say by dis morning dem go begin de process of certifying and declaring de other seven regions provisional results wey dem don recieve.

    But results form two of de 16 regions be yet to arrive de EC headquarters.

    Stay with BBC Pidgin for live updates.

  6. Why Ghana EC no announce presidential election results within 24hrs

  7. Breaking, Seven certified Presidential Election results so far, .

    Electoral Commission of Ghana Headquarters in Accra don certify and declare seven of de 16 regional presidential election results for de 7 December 2020 Ghana elections.

    Between midnight and now EC Ghana announcede following:

    Ahafo

    North East

    Central

    Upper West

    Volta

    Bono

    Oti

    BBC Pidgin fit confam at dis time say 14 of de 16 Regional results don ready.

    EC Ghana Chairperson Jean Mensah say dem dey wait for de remaining two regional results to complete before dem fit declare a winner.

    BBC Pidgin dey project say de declaration fit happun today 9 December, 2020.

  8. Ghana EC wan declare of presidential elections results

  9. Breaking, EC Certified Presidential Results - Ahafo Region, NPP Nana Akufo-Addo win

    Nana Akufo-Addo win of de New Patrotic Party [NPP] win Ahafo Region.

  10. Breaking, EC Certified Presidential Result- North East Region, NPP Nana Akufo-Addo win

    Nana Akufo-Addo win of de New Patrotic Party [NPP] win North East Region.

  11. Breaking, EC Certified Presidential Results - Cenral Region, NPP Nana Akufo-Addo win

    Nana Akufo-Addo of de New Patrotic Party [NPP] win Cenral Region.

  12. Breaking, EC Certified Presidential Result -Upper West Region, NDC John Dramani Mahama win.

    National Democratic Congress [NDC] Candidate John Dramani Mahama win Upper West Region.

  13. Breaking, EC Headquarters: Wetin dey happun for Electoral Commission of Ghana Headquarters, Accra now?, Dis be latest informate on de Ghana Presidential Elections Results Declaration

    All eyes be on Electoral Commission of Ghana Headquarters in Accra.

    Dis be because as at midnight Tuesday into Wednesday 9 December, 2020 nothing don happun for de Electoral Commission Headquarters concerning results declaration.

    BBC Pidgin fit confirm say respected Ghana cleric Bishop Ducan Williams bin hold closed door meeting with de EC Chair Jean Mensa.

    After de meeting madam Jean Mensa apologies for de delay in de Ghana presidential results declaration.

    She tell BBC Pidgin say so far, 14 of de 16 Regional results don ready but dem dey wait for de remaining to complete before dem fit declare a winner.

    BBC dey live for de EC Heaquarters.

  14. Breaking, EC Certified Presidential Result -Volta Region, NDC John Dramani Mahama win

    National Democratic Congress [NDC] Candidate John Dramani Mahama win for Volta region of Ghana.

  15. Breaking, EC Certified Presidential Result - Bono Region, NPP Nana Aufo-Addo win

    Nana Akufo-Addo of de New Patriotic Party [NPP] na im lead for Bono region, according to de Electoral Commssion of Ghana.

  16. Breaking, EC Certified Presidential Result - Oti Region, NDC Dramani Mahama win

    National Democratic Congress [NDC] Candidate John Dramani Mahama win Oti Region.

  17. Osei Kennedy Nyarko of NPP win Akim Swedru Constituency

  18. Ebebenezer Okletey Terlabi of NDC win Lower Manya Krobo Constituency

  19. Bryan Acheampong of NPP win Abetifi Constituency

  20. Kwadjo Asante of NPP win Suhum Constituency