No doubt say di election dis year dey different from wetin we don see in recent times, but sabi pipo say special attention go dey for states like Lagos, Oyo, Kano, Abia, Plateau and Delta States.
One of di reasons na sake of how opposition win di ruling party for di state during di presidential election.
E go dey
hard to predict who go win for dis states.
Lagos state
wey be di commercial capital of di kontri dey face serious shake-up for di
election process.
Opposition
Labour party win di ruling party during di presidential election.
Lagos get
three strong candidates wey dey try win di govnor seat.
Di incumbent
Babajide Sanwo-Olu of di All Progressives Congress, Olajide Adediran aka Jandor
of di Peoples Democratic Party and Gbadebo Rhodes-Vivour of di Labour Party get
plenti supporters wey dey seriously root for dem online and anywia wey
opportunity dey.
Eyes go dey
Adamawa state sef sake of di female wey wan try win di govnor seat.
51-year-old
Dairu Ahmed Aishatu na di ruling party only female govnorship candidate dem dey
field for di kontri and also di only female candidate for Adamawa state.
Kano get serious opposition to deal wit .
Di presidential election for di state see di New Nigerians Peoples Party, NNPP give di ruling APC betA run for dia moni wit landslide victory, even though na for only dat state di candidate win beta number.
Also, for di first
time since democracy, Delta state lose for di presidential election.
Presidential
election wey happun on 25 February see Labour Party win wit 341,866 votes while
PDP come second wit 161,600 votes for Delta State.
But one of
di govnorship candidates tell BBC Pidgin say di mata of president and
govnor elections na two different tins entirely.