You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

How di govnorship and state House of Assembly elections happun across Nigeria

Sorting and voting start for many polling units as early as 3pm for some parts of di kontri.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. Breaking, INEC postpone govnorship and Assembly elections for 10 polling units for VGC

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don postpone di govnorship and state House of Assembly elections for 10 polling units for Victoria Garden City (VGC) for Lekki area of Lagos State.

    Inec Resident Electoral Commissioner for Lagos State, Olusegun Agbaje, yarn dis one to tori pipo for VGC.

    E say di elections go hold for dose polling units on Sunday 19 March by 8:30am.

    E say corps members dem deploy for di election no enta di VGC estate as dem allege say pipo hold dem hostage for di February 25 presidential and National Assembly elections.

    E add say ad-hoc staff set up voting materials in front of di estate on Saturday but di estate residents claim say di hoodlums fit disrupt di process, so dem no feel secure and dem no cast dia votes.

    Agbaje say di situation dey difficult for security agents to contain and na why im team gatz come to di area.

    “We get eight polling units here wit 6,024 registered voters and out of which 5,624 pipo get dia PVCs,” e tok.

    E say two oda polling units for di estate main gate also dey affected.

    “Eight here (in di estate) and two outside,” Agbaje add.

  2. Voters pushback against intimidation by jaguda pipo for 2023 governorship election

  3. Moment thugs enta and scatter polling units wia counting dey go on for Lagos

    Jaguda boys scata counting of votes as e dey happun for Agungi Idado polling unit for Lekki area of Lagos.

    BBC Pidgin News tori pesin bin dey do live report for di unit wen di men scata di Inec materials wey polling officers don already sort.

    Pipo attempt to reclaim di ballot box and di papers.

  4. Rivers govnor Nyesom Wike give reason for voter apathy for di state

    Rivers state govnor Nyesom Wike don hail di conduct of di governorship election as e claim say e beta pass wetin e experience during di 25 February presidential elections.

    Govnor Wike wey follow tori pipo tok afta e cast im ballot for im polling unit for Rumuepirikom community for Obio-Akpor Local Government Area of Rivers State say im no get wahala wit di BVAS as e happun during di presidential election.

    On top di mata of voter apathy for some part of Obio-Akpor LGA, wia low voter turnout dey reported, governor Wike explain say pipo wey bin come out to vote during di presidential election bin get great expectation and according to Wike as dem no get wetin dem want, dem dey discouraged.

    "E dey much beta today unlike wetin we experience on 25th of February. Wen di first election come and go, and pipo no get wetin dem want, dem dey discouraged.

    "But for whatever e be, di number still dey okay. You no fit force people to go and vote. I dey happy wit di peaceful nature and di way di election dey go. E mean say di security agencies dey do wetin dem suppose do."

  5. Election end with pockets of gbege for PHALGA

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Counting of election results don begin for di governorship and State Assembly elections as di time wey INEC give for lectionary to end don pass.

    For many polling units, di counting process dey go on well but some polling units experience pockets of gbege wey happen.

    For PHALGA Ward 5 units 1- 8, some jaguda boys come disrupt di counting process as dem hijack di ballot box, select di ballot papers and remove di ballot papers of voters wey vote oda parties and burn am.

    Security agents naim come carry di election officials comot.

    Voters for di area no happy with wetin happen as dem say di action na waste of dia votes and so dem call for di cancellation of results from di affected units: Phalga ward 5 units 1-8.

  6. Governorship candidate of APGA, Ogboru don vote

    Di governorship candidate of the All Progressives Grand Alliance (APGA), Chief Great Ogboru don cast im votes for di ongoing election.

    Great Ogboru vote for Ward One, Unit Eight Abraka Grammar School Ethiope East Local Government Area of Delta state.

    Oga gboru don dey contest for every governorship election for Delta State since 2003 under di platform of different parties.

  7. INEC assure VGC residents of voting for dia polling units inside di estate

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    More dan five hours afta waiting for di Governorship and House Assemble Elections start, residents of Victoria Garden City, VGC for Lagos go finally fit vote.

    Dis dey come afta one official of di Independent National Electoral Commission INEC, direct di polling officers dem send to di area to set up for inside di estate and begin di electoral process.

    Earlier, electorates bin complain say di Inec adhoc staff bin set up outside di estate and say make dem come outside come vote.

    Di electorate say dem no gree as dem insist say na inside di estate dem go vote as dem don do for many years.

    Meanwhile, na eight polling units wia dem register dey inside di estate and dem insist say dem no go cast dia vote outside di estate.

  8. Jaguda pipo burn ballot papers for Rivers

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    For Phalga Ward 5 unit 5, di election process don end afta some jaguda boys select di ballot papers for dia own party and leave wit dem.

    But bifore dem komot, dem burn ballot papers of oda political parties.

    Pipo dey dia watch as evri tin happun as di jaguda boys operate without resistance.

  9. Seyi Makinde commend voter turn out for Oyo State

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    Di govnorship candidate of di Peoples Democratic Party Seyi Makinde don commend voter turnout and peaceful atmosphere for di state so far.

    Govnor Makinde wey dey seek re-election tok say security challenge no dey for di state as election dey go on.

    Di govnor yarn dis one afta im cast im vote for Ward 11, Unit 01, Abayomi Area, Iwo Road, Ibadan Northeast Local Council Area.

  10. Atiku Abubakar blame INEC for low voter turnout for Adamawa state

    Di Presidential Candidate for di Peoples Democratic Party for di 25 February presidential election, Atiku Abubakar don react to di Governorship and House of Assembly elections wey dey happun across Nigeria today.

    Oga Atiku wey cast im vote for Yola, Adamawa state complain of low voter turnout for di state wey e tok say na di fault of di electoral body, INEC.

    “Sadly, low voter turnout dey for today election, no thanks to INEC partisanship and incompetence wey deliver fake election on 25 February.”

    Di former Nigeria Vice President wey follow tori pipo tok afta e perform im civic duty say im hope say di electoral body go seize dis second chance to di di right thing and redeem dia reputation wey don spoil.

  11. Lagos govnorship candidate Sanwo-Olu say 'no to voter intimidation'

    Di govnorship candidate of di All Progressives Congress for Lagos Babajide Sanwo-Olu don cast im vote.

    Govnor Sanwo-Olu say im dey excited to exercise im franchise as resident of Lagos State.

    According to di govnor, na important responsibility wey everybodi share in building the future of Lagos and Nigeria.

    "I urge all eligible voters to come out and make dia voices heard," di govnor tok.

    E say security officials dey evri polling unit to ensure di safety of voters and e urge everyone to cooperate wit dem and vote peacefully.

    "Remember, our votes count, and every vote mata. I beg my pipo not to do anything wey go discourage pipo. Voting na pipo right and citizens must dey allowed to exercise am," e tok for tweet.

  12. Governorship candidate of APC, Omo-Agege don vote

    Deputy Senate President and flagbearer of di All Progressives Congress (APC), Ovie Omo-Agege don cast im vote for di ongoing governorship election.

    Ovie Omo-Agege wey dey represent Delta Central cast im vote for polling Unit 19, Orogun ward 2, Orhomuru, Ughelli North Local Government Area of Delta state.

  13. In fotos: Pipo wit disability play football as election dey shele

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Journalist, BBC News Pidgin

    Pipo wit disability engage in di game of football for Mile 12, Ikorodu Road, Lagos, as voting dey shele for di area and oda parts of di state.

    See fotos of di footballers as pipo gada to watch di match:

  14. Turn out of voters dey low for Asaba, Delta state

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Turn out of voters for di govnorship election dey very low for Asaba, Delta state.

    For Ward 4 Asagba Primary school Oshimil South Local goment area, voters dey come one by by one unlike di way long queue dey for di February 25 presidential election.

    Also, for ward 9 Uzigwe primary school Oshimili South local goment area wey plenti voters bin dey long queue for February 25 elections, voters no too come out dis time around.

    Some pesin wey follow BBC Pidgin tok blame di outcome of last election for di low turn out.

    Di situation no dey different for Ward 9, Mgbala primary school Oshimil North, Local goment area. Voters wey come out no too plenti.

    However, Inec official come out early and di voting process go on smoothly unlike di February 25 presidential election wey voting no quick start and some machines bin malfunction.

  15. Reports of voter suppression for parts of di kontri

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    For different parts of di kontri, BBC Pidgin gada reports say thugs allegedly dey suppress voters.

    Kano: Foto show voting materials wia some thugs allegedly destroy for Rogo local goment of Kano state as govnorship and house of assembly election dey go on.

    Lagos: Online reports dey indicate say dem get pockets of violence for polling units around di Nigeria commercial capital.

    Nollywood actress Chioma Akpotha share video for her instagram page wia she claim say some pipo come attack her wit knives.

    "I never even fit bring my phone comot wen di boys show up, hit my car, destroy my side mirror.." she tok as she drive comot her polling unit.

    Bayelsa : Some thugs reportedly hijack and destroy voting materials for House of Assembly election for Wards 2, 3, 4 and 5 for constituency five of di Ogbia Local Government Area of Bayelsa State, local media dey report.

    Meanwhile, Gov Douye Diri don strongly condemn di act and ask di IGP and Bayelsa CP to restore peace for di area, Im media aide Daniel Alabrah confam for one Facebook post.

  16. Report of low turnout for Kaduna govnorship election

    Reports dey of low turnout of votesr dey for at di ongoing govnorship and State Assembly Elections wey dey happun for Kaduna State, North West Nigeria.

    Voting begin around 8:30 a.m across di metropolis as Inec officials and Adhoc Staff dey sighted moving to dia polling units with election materials.

    In most of di polling units we visit within di city, few voters dey sighted on queue dey cast dia votes unlike during di last presidential election wey witness large voter outing.

    One voter wey say e name na Malam Baba say for im polling unit for Kawo, few voters come out to vote.

    Women wey come out to vote to no too plenti.

  17. VGC residents no gree vote

    Residenst of Victoria Garden City, VGC for Lagos don tok say dem no go vote unless Inec set up for dia usual polling unit wey dem bin dey use for many years inside dia estate.

    Some of di pipo wey follow BBC tok allege say di adhoc staff bin arrive and begin set up outside di estate say na dia dem go come vote.

    "We refuse to vote for illegal polling unit wey Inec officers don set up. We don dey vote inside VGC for years so why change di location dis morning. Dem fit easily declare our votes null and void for di end of di day, so we no go go meet dem", one lady tok.

    "E no dey right for Inec officers to change di location of our polling units on election day wen dem no give us prior notice," anoda resident tok.

  18. Updates from Lagos state

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Di govnorship and state house of assembly election for Lagos kick off by 8:30 am as pipo don already arrive some polling units very early and ready to cast dia votes.

    A drive through di streets of di city show empty roads, security teams dey for major spots and some do block di roads.

    Shops and business places including banks dey shut down, but e get some petty traders wey open dia shops and dey sell dia goods.

    For areas wey our reporter visit, dem no record any violence, but online reports dey indicate say dem get pockets of violence for polling units around di Nigeria commercial capital.

    Di state govnor wey dey also seek re-election Babajide Sanwo-Olu don cast im vote.

    Di Labour Party Candidate Gbadebo Rhodes-Vivour don cast im vote likewise di President-elect Bola Tinubu.

  19. ‘I dey disappointed’

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Although many voting points don set up and ready for di elections, poor voter turn out dey observed for many areas like e be for PHALGA Ward 12 units 1, 2, 3 for Rumuwoji community.

    During di presidential and National Assembly elections, plenti voters bin come out dey wait for di election materials to land but dis time around, na case of low voter turn out even though election officials and materials come out early. Now, na di election officials dey wait for voters to come out for some areas.

    Ma Victoria Briggs say she no go vote becos she dey disappointed with di way dem handle di last presidential elections.

    “I no dey happy abeg, di last time we vote dem troway our votes so wetin be di need to come out again?”

    For Ward 4 unit 2, voting dey go on but voters no plenti. During di presidential election, dis na one of di units wey voting materials arrive very late, but dis time around, materials arrive in time but low voter turn out dey observed.

    Despite dis, some of di Govnorship candidate la like Dumo Lulu Briggs of Accord, Beatrice Itubo of Labour Party and Siminialayi Fubara of Peoples Democratic Party PDP don cast dia votes.

  20. Govnorship candidate of PDP for Delta state, Oborevwori don vote

    Govnorship candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Hon. Sheriff Oborevwori cast im vote for Unit 33, Osubi Ward 3, Okpe Local Government Area of Delta State.

    "I dey happy say for my unit, voting materials arrive early and di voting process dey go smoothly and peacefully," Sheriff Oborevwori tok afta im vote.