Voting don start for Ward 9, Mgbala primary school Oshimil North, local goment area of Delta State.
Di Electoral official first begin give numbers to allow voters based on first come.
Den afta, dem educate di voters before dem begin di voting process.
So far, di voting process dey go on smoothly for ward 9.
Meanwhile, one independent observer, Raphael Nwankwo wey follow BBC Pidgin tok say di polls for Okpanam, one community for Oshimili North dey go on well except for some machines wey no dey pick up alphabet.
From my observation, we no get much challenges, everything dey go on smoothly apart from some machines wey no dey pick up some alphabet for unit 004."
"But Officials don assures us say with time those machines go react, say na based on di time wey dem take activate am," Raphael Nwankwo add.