Di Nigeria Labour Congress, don continue to express worry about di state of di nation as di collation of results dey go on, dem dey vex say as Inec officials no fit upload results to server fit cause kasala for di kontri.
Inside statement di workers union release on Sunday night, president of di union Joe Ajaero tok say, "we continue to express our deep concerns over di apparent manipulation of results for Lagos and Rivers states and demand di real results as captured by di BVAS be uploaded without fail."
"INEC must understand say not uploading results to server go create avoidable crisis"
Dis na wetin di Nigeria Labour Congress tok as di collation of result for state levels don dey go far.
"We demand make INEC investigate di activities of one of di officials for di ICT department wey fit dey responsible for technically jamming di airwaves wey make am difficult for BVAS results to dey transmitted to di servers."
NLC allege say di pesin wey fit jam di airwaves to stop di successful transmission of results "na one former Commissioner for Lagos State and im name na Femi Odubuyi".
We call on President Muhammed Buhari to rise to di occasion and call di electoral umpire (INEC) to order. Di president suppose to seize di redemptive power for dis situation and demand INEC to return to di rule book for election conduct.
Na only if im do dis im go reassure Nigerians of im innocence for di unfolding drama.