Di All Progressives Congress Presidential
Campaign Council don respond to one call by former President Olusegun Obasanjo wey say
make di Nigeria electoral body, Inec chairman, Prof. Mahmood Yakubu cancel di elections wey mago-mago dey for di Saturday exercise.
Di Special Adviser, Media, Communications and
Public Affairs, APC PCC, Dele Alake for im response describe Obasanjo
allegation as “coup to democracy” and add say im comments na move to disrupt di
kontri democratic process.
“Obasanjo repeat without no evidence rumours
wey e pick say di Bimodal Voters Accreditation System dey compromised and di
results wey Inec dey announce dey fraudulent.
“E dey tragic say na former president wey
suppose be elder statesman dey tok like dis to endanger and derail di democratic process for selfish, egoistic and malicious reasons.
“E no get any evidence to prove im laughable
and ridiculous allegations against Inec plus di credibility of di ongoing
process.” Dele Alake tok.
Di former two-time president for inside statement
wey e address to president Muhammadu Buhari, e allege say di election process dey
corrupted and most of di results wey no come from di Bimodal Voter
Accreditation System (BVAS) and server no be di true reflection of di will of
Nigerians wey don make dia choice.
E allege say Inec officials don dey
compromised plus di result don dey doctored as dem change to manual transmission. E
say make President Muhammadu Buhari cancel di elections for areas wey no pass
di credibility test.
“Tension dey build up, make all elections wey
no pass di credibility and transparency test dey cancelled and areas wia dem
disrupt di election, make dem cancel and do am again on March 4, 2023 and make e
change BVAS and server officials.”
Obasanjo add say make di Inec chairmo do
everytin to rectify di errors of di last two as “No BVAS, no result go dey
acceptable and no upload through service, no result go dey acceptable.