Kwankwaso win so far
Inside di 29 states wey di Returning Officer for di presidential election don receive for Abuja, NNPP don win one state so far and na Kano state.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Millions of Nigerians vote for di most competitive presidential election since military rule end. Sabi pipo say dis time, na three horse race.
Victor Ezeama, Helen Oyibo, Jelilat Olawale and Annette Arotiba
Inside di 29 states wey di Returning Officer for di presidential election don receive for Abuja, NNPP don win one state so far and na Kano state.
Inside di 29 states wey di Returning Officer for di presidential election don receive for Abuja, Labour Party don win seven so far:
Inside di 29 states wey di Returning Officer for di presidential election don receive for Abuja, APC don win 10 so far:
Inside di 29 states wey di Returning Officer for di presidential election don receive for Abuja, PDP don win 11 so far:
Di national collation centre for Abuja dey on break right now and dey due to resume anytime from now.
In total dem don call 29 states.
Dem call one on Sunday.
13 on Monday and 15 today so far.
Di Elders don tok!
Di West African Elders Forum wey consist of former presidents and head of state mission come Nigeria don hail kontri pipo on top di kain ginger dem carry take vote for February 25.
Di mission wey dem send to view di election bin dey led by former Ghana president, John Dramani Mahama.
Oda members include Beninoise President Boni Yayi, former Nigeria President Goodluck Jonathan, fomer Vice President of The Gambia, Fatoumata Jallo Tambajang, former Burkinabe prime minister Kadre Quedraogo and former deputy oga of di African Union Erastus Mwencha.
Di Mission for Statement bin reveal say di election bin dey peaceful for some areas, while for odas bin get incidents of kasala wey include ballot snatching and issues of fight figt.
Dem urge pipo wey dey complain on top di election make dem calm down send am through di write corners.
"Las-las, Nigeria na major stakeholder for sustainability of di democracy and di general peace of di region," dem tok for statement.
Former Nigeria president, Goodluck Jonathan alongside oda African leaders on Tuesday visit di presidential candidate of di All Progressives Congress Bola Ahmed Tinubu for im Abuja residence.
GEJ do di waka wit former president of Kenya Uhuru Kenyatta wey lead di African Union election observation mission to Nigeria plus di former Ghana president, John Mahama wey jointly lead di ECOWAS election monitoring team wit Jonathan.
Dem also meet Peter Obi of di Labour Party (LP), Rabiu Kwankwaso of di New Nigeria People’s Party (NNPP) and Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party (PDP).
Dia visits na part of moves to ensure post-election peace.
Di visit come as di INEC kontinu wit di collation of di results of di 25 February presidential election for di National Collation centre for di Federal Capital Territory.
Four political parties wey include LP, PDP, ADC and NNPP don ask di Independent National Electoral Commission to cancel di election and conduct anoda poll over allegations of malpractice.
Di ruling APC say dia call no make sense at all and dey condemnable.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don put di collation of result on hold.
Di commission go on two hour break - to retun by 9pm for di continuation of di results of di presidentital electon.
So far Inec don declare 29 states.
Rivers State
Di State Collation Officer for di presidential Election for Rivers state, Prof Teddy Adias don announce pronvincial result from di 23 LGAs of di state.
Registered voters: 3315005
Accreditedvoters: 605055
APC - 231591
LP - 175071
NNPP – 1322
PDP - 88468
Valid votes: 523651
Rejected votes: 30293
Total votes cast: 553944
Cancellation in 25 wards with 5441 registered voters of which 51763 PVCs have been collected were affected.
One of president Muhammadu Buhari aid say INEC don tell political parties wey no happy wit di presidential results to go court.
Bashir Ahmad tok dis one for inside tweet on Tuesday.
Oga Ahmad tweet afta three political parties for Nigeria demand for fresh election
Di parties dey claim say di presidential election dey “compromised”.
Di three wey call for fresh elections na Peoples Democratic Party, Labour Party and African Democratic Congress.
Julius Abure from LP, PDP chairman, Iyorchia Ayu and ADC Ralph Nwosu, tok dis one for joint press conference for Abuja on Tuesday.
Dem add say manual transmission of results compromise di integrity of di election process.
INEC don go on break from di national collation of di presidential election results wey just happun ova di weekend.
See di breakdown of di results wey INEC chairman Yakubu Mahmood don receive so far:
Niger State
Benue State
Abuja FCT
Akwa Ibom State
Edo State
Abia State
Kogi State
Bauchi State
Plateau State
Bayelsa State
Di running mates of di opposition parties of di People's Democratic Party and Labour Party don come to chook mouth inside di press conference wey both oppositions dey call.
Dem also dey question why di Independent National Electoral Commission IReV election portal no dey work.
PDP Vice presidential candidate Ifeanyi Okowa, say "moral justification no dey to kontinu collation."
E add say "na either one of two tins cause di palava, either Inec connive or system dey down in which case, dem suppose postpone di election to anoda time".
LP Yusuf Datti Baba-Ahmed on im part call out di electoral bodi say, "Di powerful pipo dey control INEC and Security and Judiciary and na why dem sy make we go court".
E add say wetin dey happun now na human disaster wia one pesin dey put demselves ova oda pipo.