Inec postpone Enugu East senatorial election

Di independent national electoral commission (INEC) say a total over six million pipo never collect dia permanent voters card two days to di Nigeria presidential and national assembly.

Live Coverage

Victor Ezeama and Jelilat Olawale

  1. Imran Khan: Why supporters of former Pakistani prime minister dey protest go Islamabad?

  2. Who don join Trump team so far?

  3. Fotos: Burial of Anambra senator Ifeanyi Ubah

  4. Why Ghana electoral commission burn thousands of ballot papers before 7 December elections

  5. Why Catholic church for Kenya reject $40,000 donation from President Ruto

  6. Why President Tinubu approve Bwala, Dare as co-tok tok pesins wit Onanuga

  7. Inec declare APC Lucky Aiyedatiwa winner of Ondo governorship election

  8. LGA by LGA breakdown of Ondo governorship election result

  9. Yiaga Africa say case of vote buying dey for Ondo govnorship election

    Election monitors for situation room

    Wia dis foto come from, X/Yiaga Africa

    Yiaga Africa, one civil society organisation wey dey chook mouth into electoral matter tok say dem observe cases of vote buying for different polling units for di ongoing Ondo state govnorship election.

    Di group tok dis one wen dem dey give dia situation report about di election wia dem tok say dis issue of vote buying dey contribute to electoral corruption.

    Remember say BBC capture moments wey some voters begin collect money afta dem cast dia votes for di Ondo State govnorship election. Di open vote-buying occur for unit 016, Ahmadiyya Grammar School, Owo local goment area.

    But one oda incident wey Yiaga mention happun for St. Stephen Polling Unit in Ward 4, Akure and men of di DSS bin gbab di pesin wey dey involved for di mago-mago.

    Di group say election officials and materials bin arrive early for polling units wey dem observe.

  10. EFCC say dem monitor Ondo state election to find vote buying and selling

    EFCC men wey wear red jacket wit black for Ondo

    Wia dis foto come from, X/EFCC

    Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dia men dey ground for Ondo state to find pipo wey involve in vote buying and selling during di election.

    According to informate for dia X page, di commission say dem monitor di election to ensure say dem check everi form of electoral offences wey go happun.

    "Operatives dey all ova di state in line wit di mandate of di commission to prevent, investigate and prosecute all forms of economic and financial crimes," EFCC tok.Meanwhile, counting for di 2024 Ondo state election don begin.

    EFCC men wearing red jacket holding gun
    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  11. Ondo state governorship election result live updates

  12. Nigeria Minister for Interior cast im vote for ongoin Ondo election

    A voter smiling for di camera

    Wia dis foto come from, @BTOofficial/X

    Di minister of interior Olubunmi Tunji-Ojo don cast im vote for di ongoing Ondo state govnorship election.

    Tunji-Ojo wey vote at around 11:34am for im area for polling unit 17, Ward 3, Akoko North-West local govment area of di state.

    Di minister say di election dey go peaceful.

    "Na peaceful election wit officials wey dey display high level professionalism wit encouraging turn out of voters," di minister tok.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  13. PDP govnorship candidate Agboola Ajayi cast im vote

    Man facing an accreditation machine

    Wia dis foto come from, Eniola Olurankinse

    Di candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Agboola Ajayi don cast im vote for Polling unit 4, Ward 2, Kiribo Apoi, Ede-Odo LGA.

    Ajayi wey be 54-year-old na di flag bearer of PDP for dis 2024 Ondo state governorship election.

    E appear for im polling unit wia e join di queue for accreditation bifor e move forward to cast im vote.

  14. Why India Prime Minister Narendra Modi dey visit Nigeria

  15. Meet di main candidates for di Ondo state governorship election

  16. Simple guide to di Ondo state gubernatorial election

  17. President Tinubu appoint Daniel Bwala as Special Adviser on media

  18. Four key issues wey fit decide who go win Ondo state govnorship election 2024

  19. 'Welcome back' - highlight of Donald Trump meeting wit US president Joe Biden

  20. Appointment of Oshiomhole son and five tins Edo govnor Monday Okpebholo don do