Raila Odinga and William Ruto dey in a tight race for president

Millions of Kenyans on Tuesday vote today to elect di pesin wey go be dia new president and now dey wait for di result of di poll.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Kenyans queue overnight for polling station

    Voters bin dey queue overnight. Dis queue long pass 200 meters. Di pipo for di front dey dia before 9pm Monday.

    Kenya election
    Kenya election

    Margaret Mwangi, 59, we be fruit hawker decide say she no go home for di night. She camp for di polling unit and dey wait to vote. She be di second for di queue and hope say she go go home after voting to follow di news on television.

    Kenya Election

    Wia dis foto come from, BB

  2. Who be di candidates wey wan be president?

    Kenya election

    Wia dis foto come from, AFP/Reuters

    Kenya, one of Africa leading economies dey elect new president today 9 August.

    Di election dey come for di middle of high cost of living, and bad economy wey go be serious challenge for anybody wey win di election.

  3. Una good morning!

    We welcome una to dis ogbonge coverage of di Kenyan general election wia millions of voters go elect dia new president today. Parliamentary and local goments elections dey also shele across di kontri.

    Check out Kenya's voters profile.

    Kenya Election