Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Ties between di two countries don grow since one coup in May last year.
Dat second military take-over for just over one year plus Mali's decision to hire Russian mercenaries na key reasons why France choose to pull im troops out of di kontri.
Jihadist attacks don increase for recent weeks.
Over di weekend Islamist militants shoot 17 soldiers and four civilians dead.
Di army say nine oda troops dey miss and 22 soldiers dey injured for di attack.
Kenya 2022 Election Results: Voter turnout fall from 80 to 60 percent - IEBC
Wia dis foto come from, Getty Images
Dem still dey count votes for Kenya wia voters on Tuesday vote for new president wey go take over from Uhuru Kenyatta.
Polling day dey largely peaceful, but turnout dey, amid voter apathy and frustration over rising food prices, corruption and fears of violence.
Di Electoral Commission estimate di turnout dey around 60%, wey dey lower dan di 80% wey dem get for di election five years ago.
Kenyans dey wait eagerly to know whether di next leader na di former prime minister, Raila Odinga, who be President Kenyatta fave, or di vice president, William Ruto.
Good morning!, Una welcome back
We dey welcome you back to our live coverage of di Kenya general election as kontri pipo still dey wait for di results of dia voting wey hold on Tuesday.
We go also dey bring you news updates from Nigeria, elsewhere in Africa and around di world.
Video of how Pastor Chris Oyakhilome suspend im nephew trend for social media
Una bye-bye
Na here we go march break for our live updates ontop di Kenya election today and oda tori dem.
Join us again tomorrow for our continued coverage of di elections and oda tori from around di world.
Bye-bye!
Japanese Fashion Designer Issey Miyake die at di age of 84
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Issey Miyake and models during im Ready-to-Wear Spring-Summer 1992 fashion show for Paris
Revolutionary Japanese fashion designer Issey
Miyake don die at di age of 84, im company announce.
Miyake wey dey known for im innovative styles and
perfumes build ogbonge global fashion brand, wey include di Steve Jobs famous
turtle neck jumpers wey e design.
Miyake work wit traditional and
modern fashion techniques during im long career.
E die of liver cancer on Friday, and dem
don bury am already in a private funeral, Japanese media report.
Dem born am for Hiroshima for 1938.
Miyake na just seven years old wen one
atomic bomb wey di United States drop destroy di city.
Im mother die of radiation exposure
three years later.
"Wen I close my eyes, I still
see dey tins nobody suppose ever experience," e write fo one New York Times opinion piece in 2009 – e add say im prefer to tink of tins "wey fit
dey created, not destroyed, and dat dey bring beauty and joy".
According to tori, Miyake wan be
dancer or athlete wen e dey young - but dat change afta e read im sister fashion magazines.
E study graphic design for one Tokyo
art university and den move go Paris for di 1960s, wia e work wit big fashion
designers Guy Laroche and Hubert de Givenchy.
E bin move go New York for a short
time, before e head back to Tokyo for 1970 to open di Miyake Design Studio.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Di Pleats, Please line on di catwalk for Paris in 1995
By di 1980s, dem celebrate am as one of di
world's most pioneering designers as e work wit materials from plastic to metal
- and also traditional Japanese material and paper.
Miyake develop one new way of
pleating fabric by wrapping it between layers of paper in a heat press.
E become phenomenal success - various
tests prove say di pleats stay for di same place and e no wrinkle, and dis lead
to im signature line e call di Pleats, Please.
Miyake distinctive Bao Bao line of
bags, wey dey recognisable for dia small resin triangles, dey celebrated for dia
engineering and e dey so popular wey copy-cats flood di fake designer market.
E become popular for creating style wey
be high-tech yet practical and comfortable, and e become a household name no be
only for Japan fashion industry - but on di global catwalk.
Im fashion house develop clothes for men and women wey pipo like well-well, as well as bags, watches and perfumes - According to tori, one bottle of L'Eau d'Issey, wey dem launch for 1992, sell every 14
seconds.
Apple
co-founder Steve Jobs bin ask Miyake to design im ogbonge turtle neck jumpers
and reportedly make 100 of dem for $175 each.
Dem award
am di prestigious Kyoto Prize for im dedication to di arts for 2006, and e receive di Order of Culture for 2010 for "remarkable accomplishments"
for Japan culture and arts.
Nigerian Navy hand ova two rescued Ghanaian fishermen to Ghana Consulate
Wia dis foto come from, Nigerian Navy
Wetin we call dis foto, Di two Ghanaian fishermen with Nigerian Naval officers
Di Nigerian Navy don hand ova di two Ghanaian fishermen dem rescue over to di Representative of di Ghana Consulate for Lagos.
Na few days ago Nigerian Navy ship NNS Prosperity while on patrol duty sight one man dey float on top one 20 litre gallon for di sea come rescue am for North East Dangote quay, Lagos on 2 August, 2022.
E tell dem say anoda pesin also dey involved and dem go reach wia e dey, rescue am.
Di fishermen say dia fishing boat capsize and two oda fishermen wey bin dey with dem drown before di Navy rescue dem.
Di Ghanaian fishermen dey live for Takwa Bay for Lagos, Nigeria.
Wia dis foto come from, Nigerian Navy
Wetin we call dis foto, Di Nigerian Navy hand over di two fishermen to di Ghanaian Consulate for Lagos
Wetin dey happun for Kenya election?
Wetin we call dis foto, Kenya Decides 2022
In case you just dey join us.
Kenyans don vote in low numbers for dis year general election as dem cast 12.1 million votes out of an expected 21
million.
Statement from di elections watchdog, di Independent Electoral and Boundaries Commission IEBC, just one hour to di 5pm
voting deadline, say voting time for two areas for Western and Eastern Kenya wey start late don dey extended.
IEBC also announce say voting for di coastal region of Mombasa and Kakamega for Western Kenya, for di govnor
position, go happun on August 23. IEBC bin suspend voting for those areas
and four odas, afta a mix up in ballot paper printing.
Wetin we call dis foto, Kenya Decides 2022
Elections for Eldas constituency for Northern Kenya don dey postponed to tomorrow due to insecurity.
With di polling stations wey don close now, tallying don start with heavy security in some place.
Members of di public don dey warned to go home and to stay away from polling stations.
IEBC get until August 16, to announce di election results.
Di Kenyan election na two-horse race between Deputy President William Ruto and Former Prime Minister Raila Odinga.
Final update on di elections dey expected at 8pm EAT.
Tennis legend Serena Williams tok about retirement from di game
'I bring my kids to vote to see how dem dey elect leaders’
Wetin we call dis foto, Kenyan voter carry im children go witness di election
As e bin dey ready to go vote, Paul
Kimutai son and daughter ask am say "daddy wia you dey go?’ I tell dem say I go out to vote"
Kimutai, 35, say im pikin de get plenti questions about di Kenyan elections and dat na why e carri dem go di polling station.
I bin want dem to see how dem dey elect our leaders and say dem dey free to elect who dem want. E add say di election go shape di future of Kenya and di services wey di goment e vote in go affect im children.
Wetin we call dis foto, Paul Kimutai na Kenyan voter
Di children 3 and 5 years, queue wit dia father until e cast im vote and collect ink for im finger.
"I also want to be a good role model to dem, I want dem to take dis lessons with dem until adulthood."
Kimutai plan to tag dem along even for di next general election, wia dem go dey much older and fit get better understanding of di process.
Na so e tell BBC tori pesin Carolyne Chepkoech.
WhatsApp update go allow you leave groups silently plus oda new features
Athletics Coach collect life ban ban for sexually inappropriate conduct
Wia dis foto come from, Getty Images
Athletics Coach for United Kingdom, Toni Minichiello don collect life ban.
UK Athletics ban am sake of sexually inappropriate conduct afta dem find out say e commit "gross breaches of trust".
Plenti oda charges dey wey no get proof.
One independent panel find out say Minichiello actions fit "get severe consequences for di mental health and mental wellbeing of di athletes under im care".
Di findings wey relate to anonymous athletes over 15-years period show say Minichiello:
make inappropriate sexual references and gestures to athletes.
fail to respect di athletes right to dia private life by making intrusive enquiries and personal comments about dia personal lives.
engage in sexually physical behaviour, namely inappropriate and unwanted touching of athletes to whom e bin owe a duty of care.
engage in inappropriate and sometimes aggressive behaviour, bullying and emotional abuse.
Coach Minichiello wey be 56 years don be subject of multiple complaints from women for athletics and im don also commit 11 serious charges, one independent case-management group tok
Minichiello win BBC Sports Personality Coach of di Year 10 years ago afta e guide Jessica Ennis-Hill to Olympic glory for London 2012.
Di BBC don contact Minichiello for im response.
Sania Khan put her divorce for Tiktok den her husband kill am
Wia dis foto come from, Sania Khan
Wetin we call dis foto, Sana Khan bin comot her marriage before her husband kill am wen e visit to "save di marriage"
Sania Khan, 29 comot her bad marriage just over a year afta she enta am for 21st July.
Only for dem to carry am give her family inside casket.
Dis one happun afta officers find Khan for her house not responsive close to di house she bin dey stay with her husband Raheel Ahmad, 36 wey she bin get issues wit, with gunshot wound for di back of head.
As di police dey come na so Ahmad face gun to im self and take im own life.
Police reports wey dem share with Chicago Sun-Times tok say di couple bin dey in di process of divorce and Ahmad wey no dey live for di same state since im separate, drive go dia former house to "save di marriage".
Sania Khan wey be Pakistani-American photographer marry for June 2021, and wen she wan comot leave di man, her South Asian Muslim community make am feel like say she don fail for life, na im she turn to tik-tok to tok about her journey.
Former Nigeria President Goodluck Jonathan dey for Kenya as election observer
Wia dis foto come from, Goodluck Jonathan/FACEBOOK
Wetin we call dis foto, Former Nigeria President, Goodluck Jonathan dey observe Kenya election
Former Nigeria President,
Goodluck Jonathan say dem dey look forward to a peaceful outcome and beta
democracy as Kenyans dey cast dia vote today.
Di former president dey for Kenya
as member of di Election Observation Mission for di Electoral Institute for
Sustainable Democracy in Africa (EISA).
E say dem don observe voting
procedures for some polling stations for Nairobi, Kenya capital.
So far for di Kenya elections
Wia dis foto come from, AFP/Reuters
Dis na reminder of how di voting dey go for Kenya wit less dan three hours to go until polls close for 17:00 local time (14:00 GMT).
Three of di four presidential candidates don vote so far; George Wajackoyah neva vote sake of malfunctioning ID verification kits
Even wit dat kain delays and logistical problems, in most places di process appear smooth
For north-eastern areas along di border wit Somalia, voters bin dey affected by reported attacks and intimidation tactics by suspected al-Shabab militants
Di vote follow intense campaign dominated by debates about living costs, unemployment and corruption
Di two frontrunners for president na ex-Prime Minister Raila Odinga and current Deputy President William Ruto
Voters dey also choose MPs, senators, county governors, local assembly members and parliamentary women's representatives.
ID verification kit fail for presidential contender
Presidential candidate George Wajackoyah from di Roots Party for Kenya says im no fit cast im vote.
Dis na because di voter identification kits no work for im constituency wey dey di west of Kenya, na so e tell tori pipo.
For inside interview wey NTV tweet, di lawyer and educationalist, wey dey try presidency for di first time say, na im be di only presidential contender wey neva vote.
“For my stronghold, Kakamega county, most of di pipo neva vote dis morning."
Officials confam say about 10% of polling centres for Kakamega county dey affected.
Di 63-year-old candidate say im don tell im supporters wey dey vex to “cool down”.
Electoral officials don tell am to come back later, e tok, wey mean e gatz buy another ticket go Kisumu where e suppose travel go later.
But e dey feel say oda pipo fit no come vote: “My pipo dey disenfranchised di older pipo don go house.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Chief of Defence Staff release names of terrorists behind Owo Catholic Church attack
85-year-old Kenyan woman cry as dem say she no fit vote
Wetin we call dis foto, Rahab Nduta
Rahab Nduta na 85-year-old woman wey break down in tears for polling station wen dem tell her say she no fit vote sake of say her details dey reflect anoda polling station.
Di woman follow BBC tok and she express her frustration, asking say wetin she wan come do?
‘'I reach and dem tell me to g queue one. I carry my identity card give di polling officials, den dem tell say my name dey registered for Embakasi, I no know wia dat be. I don’t know what to do.’
"But I never change my polling station, now wetin I go do?" She tell BBC.
More dan six million don vote by noon - officials
For im latest update about di vote, Kenya’s electoral commission tok by noon local time (09:00 GMT), 6.5 million people had voted.
Dis amount to just more dan 30% of registered voters. Polls go dey open until 17:00 local time.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post, 1
Reports wey we dey get from different parts of di kontri suggeste say turnout don dey low so far compared to previous elections.
Di commission don try to address concerns about di electronic kit wey checks fingerprints (known as Kiems kits) wey dem report to be malfunctioning in different places.
Commissioner Justus Nyang'anya tok say issues bin dey with only a tiny proportion - 200 out of more dan 46,000.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.