You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Raila Odinga and William Ruto dey in a tight race for president

Millions of Kenyans on Tuesday vote today to elect di pesin wey go be dia new president and now dey wait for di result of di poll.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Kenyans queue overnight for polling station

    Voters bin dey queue overnight. Dis queue long pass 200 meters. Di pipo for di front dey dia before 9pm Monday.

    Margaret Mwangi, 59, we be fruit hawker decide say she no go home for di night. She camp for di polling unit and dey wait to vote. She be di second for di queue and hope say she go go home after voting to follow di news on television.

  2. Una good morning!

    We welcome una to dis ogbonge coverage of di Kenyan general election wia millions of voters go elect dia new president today. Parliamentary and local goments elections dey also shele across di kontri.

    Check out Kenya's voters profile.