You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Raila Odinga and William Ruto dey in a tight race for president

Millions of Kenyans on Tuesday vote today to elect di pesin wey go be dia new president and now dey wait for di result of di poll.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Anti-riot police deployed to Nakuru county afta voting material mix-up

    Authories don send anti-riot police go Rongai constituency for Nakuru county - just north-west of Kenya capital, Nairobi.

    Dis na according to report from BBC tori pesin, David Wafula.

    E dey happun afta one protest take place outside Mercy Njeri polling station afta dem suspend voting for area MP sake of one mix-up with voting papers, Wafula tok.

    But di oda ballots no dey affected by di disruption, and pipo still dey stream in to vote, our reporter tok.

  2. Issey Miyake: Japanese fashion designer die at 84

    Japanese fashion designer Issey Miyake don die at di age of 84, im company announce.

    Miyake die of liver cancer on Friday, and dem don already hold private funeral for am.

    Di designer dey known for im innovative styles and perfume.

    Im build global fashion brand, wey include designing Steve Jobs iconic turtle neck jumpers.

    Miyake also dey known to dey experiment wit traditional and modern techniques during im career of more dan 50 years.

    Dem born am for Hiroshima for 1938, and na just seven years old wen United States drop atomic bomb for im city.

    Im move to Paris for 1960s where im work wit ogbonge fashion designers Guy Laroche and Hubert de Givenchy.

    Miyake move to New York and spend small time dia before im move back to Tokyo for 1970 to open di Miyake Design Studio.

  3. Di ethnic factor

    One factor wey fit determine how pipo vote na ethnicity.

    Raila Odinga (a Luo) and William Ruto (a Kalenjin) fit attract di votes of dia respective ethnic groups.

    But dis na di first Kenyan election for di multiparty era wia none of di front-runners dey from di biggest group, di Kikuyu.

    Both Mr Odinga and Mr Ruto chosoe Kikuyu running mates.

  4. Streets dey empty for Kenya as many pipo go out to vote

    Eldoret town dey deserted as large may pipo go out to vote for Uasin Gishu county.

    Many shops dey closed and business owners tok say dem allow dia workers to go cast dia votes. Na only few premises remain open.

    For polling stations, voters don urge electoral officials to work fast to accommodate di large number of pipo wey bin dey queue up from 4am.

    For William Ruto hometown of Sugoi, motorcycle riders don abandon dia day jobs as dem volunteer to take di sick and elderly pipo to polling stations for free.

  5. Kiems kits fail to work for some polling units

    Kiems kits no dey work for Kakamega and presiding officers still dey wait for IEBC order since 5am.

    Below na stations wey no dey work:

    Sambuli Primary School.

    Shikokwe Primary School 01

    Malimali Primary School 01

    Lunyu Primary School Station

    Matende PR school 01 and 02

    Kimang'eti Primary School 01

    Lwanda Kabras Primary School 02

    Manda primary/02 9.

    Shirugu Primary 01/02

    Fubuye Primary Room B

    Kalenda Primary

  6. Police dismiss officer wey flog pesin wit machete

    Di Nigeria Police Force don dismissed one officer, Liyomo Okoi, sake of say im flog one man wit machete.

    One video wey go viral capture di moment di officer flog di man wit machete for Cross River State, south-south Nigeria.

    Di tok-tok pesin for di Nigeria Police Force Olumuyiwa Adejobi announce yesterday say dem don dismiss di officer sake of gross misconduct.

    “Di Force don dismiss Force No. 524503 PC Liyomo Okoi wey dey attached to Ekori Divisional Headquarters, Cross Rivers Police Command for gross misconduct wey dey captured for one viral video on 31st July, 2022 where im dey flog one man wit machete. Im dismissal take effect from today di 8th of August, 2022,” di statement tok.

  7. Raila Odinga cast im vote

    Presidential candidate Raila Odinga don cast im vote for im polling unit for Old Kibera Primary School as Kenyans elect new leader today.

    Massive supporters welcome Odinga wen im land for Kibera to cast im ballot.

    Odinga and Vice President William Ruto na dem be di main presidential candidates.

    President Uhuru Kenyatta endorse Odinga for presidency as im and im vice get kwanta.

  8. Kenyan teacher tok why she dey vote

    Kenyan teacher Joy Njue wey dey on ground to cast her vote tell BBC say she dey vote for better future for her unborn pikin and di students wey she dey teach.

  9. ‘Grease’ actress, Olivia Newton-John don die at age 73, Di Australian actress and musician battle cancer for over 30 years.

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Popular Australian musician and actress Dame Olivia Newton -John don die at age 73.

    Her husband, John Easterling make di announcement say she pass away peacefully for her Ranch for Southern California, surrounded by her family and friends.

    Her career defining role as Sandy for di popular High School musical film 'Grease' for 1978 wey she do with famous American actor, John Travolta, shoot her to stardom from Australia to UK and US.

    Olivia Newton-John become breast cancer awareness campaigner after she share her journey with breast cancer for over 30 years and na for 1992 she get di first diagnosis of breast cancer.

    She bin dey cancer-free until 2013 wen e return and then for September 2018, she announce again say she don get anoda cancer diagnosis after dem discover tumor for her lower back.

    She bin dey treat di illness 'naturally' and dey use cannabis oil made from marijuana her husband dey grow for California to help alleviate di pain.

    Instead of flowers, di family say make pipo send donations to di Olivia Newton-John Foundation Fund wey dey dedicated to researching plant medicine and cancer in her memory.

    She dey survived by her husband, John Easterling, daughter Chloe Lattanzi, sister, brother, nieces and nephews.

  10. PWDs want disability friendly ballots

    65 year old John Chege na pesin wey dey physically impaired and im don express satisfaction for di polling exercise.

    As im cast im vote at 8:30am Chege say "I no queue, di official usher me inside, dem assist me to get to di polling booth where I mark my papers."

    Pipo wey dey live wit disabilities especially di visually impaired tok say di electoral bodi, di Independent Electoral and Boundaries Commission gass get braille ballots to make am easier for dem.

    Samuel Odawo wey be visually impaired pesin and di CEO of Ulemavu Institute wey tok wit IEBC on how to make di process smooth for PWDs want IEBC to ‘map out where PWDs live and create polling station for dem.’

    IEBC expect say di visually and hearing impaired go come in with assistants to help dem mark di ballot or dem fit get help from di polling officers.

    "Di problem wit dat be say, I gass trust my assistant to vote in my candidate and make di pesin no go dey announce who I vote for."

    Oga Odawo hope say for future, IEBC go provide sign language interpreters and braille ballots for PWD.’

  11. 'Di voting process dey smooth' - President Kenyatta tok as e cast im vote

    Kenyan President Uhuru Kenyatta don cast im vote for im home county of Kiambu for central Kenya.

    “I believe say dis election go dey free and fair, di voting process dey smooth,” e tell tori pipo after casting im ballot.

    Dis na Kenyatta last tenure for office as di pipo of Kenya dey vote for who go replace am for office.

    Kenyatta don be president of di East African kontri since 2013.

  12. Ralia Odinga enta polling station amidst rowdy welcome by supporters

    Di moment one of di major presidential candidate for Kenya election, Ralia Odinga arrive im polling unit to vote for Old Kibera primary school inside di kontri capital, Nairobi.

    Pipo scatter queues and police no fit control di crowd.

    Odinga na di main opposition candidate wey also get di backing of president Uhuru Kenyatta for di election.

    Na four candidates dey contest di election.

  13. Moment 96-year-old woman cast her vote

    Sarah Mwihaki na 96-year-old woman wey cast her vote for Mutomo Primary School, Gatundu South, Kiambu county.

  14. Popular Nigerian filmmaker Biyi Bandele die at 54

    Nigerian filmmaker Biyi Bandele don die at di age of 54, im daughter Temi Bandele make di announcement yesterday and tok say her papa die on Sunday 7, August.

    Biyi na talented writer and filmmaker wey be di director of Half of a Yellow Sun, adaptation from Chimamanda Ngozi Adichie novel of di same title.

    Na Biyi also direct Fifty, one television series Shuga, and di latest work wey im direct na Elesin Oba, the King’s Horseman.

    Biyi na novelist wey be di author of Burma Boy, The King’s Rifle, The Man who Came in from the Back of Beyond, The Sympathetic Undertaker and Other Dreams, and The Street.

    “Biyi na prodigiously talented writer and film-maker, as well as loyal friend and beloved fada. Na storyteller to im bones, wit unblinking perspective, singular voice and wisdom wey speak boldly through all im art, poetry, novels, plays and for screen.

    “Im tell stories wey make profound impact and inspire many all over di world. Im legacy go live on through im work,” Temi write for im papa Facebook page.

    Di deceased get one son Korede and one daughter Temi.

  15. Presidential candidate Mwaure Waihiga cast im vote

    Mwaure Waihiga, wey be one of di four Kenyan presidential candidates, don cast im ballot for one polling station for di capital, Nairobi.

    Di state broadcaster bin share one video of di candidate voting at Upper Hill Secondary School:

  16. Disapora voting dey hold for 12 kontri

    IEBC Kenya dey conduct diaspora voting for 12 countries wey include Burundi, Tanzania, Rwanda, Uganda, and South Africa.

    Oda kontris na United Kingdom, Canada, USA, South Sudan, Qatar, UAE, and Germany.

  17. Cast your vote and waka go home - Kenya police

    Di police dey advise Kenyans to comot polling stations after dem don casting dia ballots and wait for di results at home so as to maintain order and peace.

    “In today's poll, after una don vote, we ask make una support our security efforts by waiting for di poll results for di comfort of una homes,” di National Police Service tok for one statement.

    “We all wan live for orderly society wey respect di rule of law and one wey dey considerate to di wellbeing of im people,” dem add.

    During campaigns some politicians bin urge supporters to remain for polling stations on voting day in order to "guard dia votes".

  18. Voting start across di country

    Voting start across di kontri afta dem don open polling stations at 06:00 local time.

    Kenyans dey elect dia new president plus five oda election races.

    Deputy President William Ruto, one of the frontrunners for di presidency plus im wife dey among di early mor-mor voters.

    Election dey hold for 46, 232 polling stations with 22 milion registered voters expected to vote. About 40% of dis na young voters

  19. Fotos: Kenyans gather to cast dia voters early mor-mor

    Across Kenya, na early mor-mor something voters take am do as dem gather in plenti numbers in readiness for di election.

    Check out some of di fotos:

  20. Deputy President William Ruto get confidence say e go win

    Deputy President William Ruto don show confidence say e go win di presidential election, moments after e cast im vote for im home town for di Rift Valley region.

    "I dey look forward to a victorious day," e tell tori pipo.

    "I dey very confidentsay di pipo of Kenya go make choices wey go take our country to di future... e dey upon us all to respect wetin di pipo wan."

    Oga Ruto, 55, wey be President Uhuru Kenyatta deputy dey make im first shotr at di presidency after e don be deputy president for 10 years.

    Im main challenger, Raila Odinga - na long-serving opposition leader - dat one dey for president for di fifth time.