Revolutionary Japanese fashion designer Issey
Miyake don die at di age of 84, im company announce.
Miyake wey dey known for im innovative styles and
perfumes build ogbonge global fashion brand, wey include di Steve Jobs famous
turtle neck jumpers wey e design.
Miyake work wit traditional and
modern fashion techniques during im long career.
E die of liver cancer on Friday, and dem
don bury am already in a private funeral, Japanese media report.
Dem born am for Hiroshima for 1938.
Miyake na just seven years old wen one
atomic bomb wey di United States drop destroy di city.
Im mother die of radiation exposure
three years later.
"Wen I close my eyes, I still
see dey tins nobody suppose ever experience," e write fo one New York Times opinion piece in 2009 – e add say im prefer to tink of tins "wey fit
dey created, not destroyed, and dat dey bring beauty and joy".
According to tori, Miyake wan be
dancer or athlete wen e dey young - but dat change afta e read im sister fashion magazines.
E study graphic design for one Tokyo
art university and den move go Paris for di 1960s, wia e work wit big fashion
designers Guy Laroche and Hubert de Givenchy.
E bin move go New York for a short
time, before e head back to Tokyo for 1970 to open di Miyake Design Studio.
By di 1980s, dem celebrate am as one of di
world's most pioneering designers as e work wit materials from plastic to metal
- and also traditional Japanese material and paper.
Miyake develop one new way of
pleating fabric by wrapping it between layers of paper in a heat press.
E become phenomenal success - various
tests prove say di pleats stay for di same place and e no wrinkle, and dis lead
to im signature line e call di Pleats, Please.
Miyake distinctive Bao Bao line of
bags, wey dey recognisable for dia small resin triangles, dey celebrated for dia
engineering and e dey so popular wey copy-cats flood di fake designer market.
E become popular for creating style wey
be high-tech yet practical and comfortable, and e become a household name no be
only for Japan fashion industry - but on di global catwalk.
Im fashion house develop clothes for men and women wey pipo like well-well, as well as bags, watches and perfumes - According to tori, one bottle of L'Eau d'Issey, wey dem launch for 1992, sell every 14
seconds.
Apple
co-founder Steve Jobs bin ask Miyake to design im ogbonge turtle neck jumpers
and reportedly make 100 of dem for $175 each.
Dem award
am di prestigious Kyoto Prize for im dedication to di arts for 2006, and e receive di Order of Culture for 2010 for "remarkable accomplishments"
for Japan culture and arts.