Substitution for Nigeria
77' Onome Ebi no fit kontinu.
Michel Alozie don replace her.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Defending champions Nigeria dream to win tenth Wafcon title don end afta dem lose 5-4 on penalties to hosts Morocco.
Helen Oyibo and Tamara Ebiwei
77' Onome Ebi no fit kontinu.
Michel Alozie don replace her.
76' Ayane test Chiamaka Nnadozie wey dey in goal for Nigeria.
Di Paris FC goalkeeper fumble di shot but her defenders later clear di ball wey quickly come back to Nigeria goal as El haj fire over.
75' Nigeria defender Onome Ebi don go down injured.
E be like she no go fit kontinu.
73' Di game don dey physical now.
Nakkach don collect yellow card for Morocco.
71' Afta VAR check, di referee don change her mind on di yellow she give Ajibade.
Di midfielder don collect red card for dangerous tackle.
As e be, di defending champions don dey reduced to nine-women.
69' Rasheedat Ajibade don collect yellow card.
Di referee dey go cehck VAR for possible red card.
Nigeria already dey down to 10-men afta Ayinde collect red early for second half.
66' Sanaa Mssoudy draw Morocco level!
Di midfielder pounce on loose ball wey Nigeria goalkeeper, Chiamaka Nnadozie parry into her path come fire shot into empty net.
Morocco 1-1 Nigeria
63' Nigeria take di lead.
Christy Ucheibe header bounce off di post and fall in front of Uchenna Kanu wey force di ball into di net off Yasmin Mrabet
Morocco 0-1 Nigeria
61' Salma Amani off, Hamzat ON
As to be expected, di fact say di Super Falcons reach di semi final of di game don make pipo wey no for even dey interested to sit up and take note.
As di game dey go on, di Super Falcons dey trend for Nigeria.
See some reactions from Twitter.
59' Fatima Tagnaout don receive di first yellow card of di game.
55' Ashley Plumptre clear Morocco goalbound effort to deny di Atlas Lioness from opening di scoring.
52' Osinachi Ohale produce good insticts to clear Chebbak looped shot on di goal line.
Di red card to Nigeria don give di Moroccans more belief.
47' Halimatu Ayinde don collect red card for her tackle on Rosella Annie.
Afta VAR check di referee decide to send off di Super Falcons player for stamp on di heel of di forward.
46' Super Falcons don resume play as di second half don start.
Morocco 0-0 Nigeria
"An enterprising and cagey opening half" - Na so di Super Falcons rate di game.
Di first half end for 0-0.
Di Super Falcons dey hope to defend dia title.
Possession: Morocco 53% - 47% Nigeria
Goal attempts: Morocco (1) - (6) Nigeria
Attempts on target: Morocco (0) - (1) Nigeria
Corners: Morocco (1) - (1) Nigeria
Morocco 0-0 Nigeria.
Nothing to separate dis two sides so far.
Dem go need try again for second half to find di winner.
If no goal dem go play extra-time.
45' Referee don add one minute before half-time.
Morocco 0-0 Nigeria
43' Ajibade and Elchad Nesryne dey down and need treatment.
Di two players bin dey try to meet looped pass by Ayinde. E belike di goalkeeper clash into di two players.
Afta some treatment, both players dey set to kontinu.