You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

INEC declare Soludo of APGA winner of Anambra governorship election

Nigeria election body di Independent National Electoral Commission don announce say Anambra State supplementary election go hold from 10 am to 4 pm today.

Live Coverage

Moseph Ekine and Helen Oyibo

  1. Less dan two hours before voting go close

    Afta voting open for 8:30am, na less dan two hours remain before Inec go close shop on voting.

    But di Nigeria election body add say if dem don accredit you and you dey for queue you fit still vote even though di closing time don pass.

    So far voting still dey go on but candidates and voters don complain about di use of di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).

    Dem say e dey cause major delay for voting centres as e no dey work as Inec bin promise.

  2. See how voters turn out for Umuokpu Awka

    Young pipo including mama and papa dem come out in dia numbers to vote for Umuokpu Awka, ward 7 units 6,7,8 and 9.

    Many of dem na first time voters way believe say dem get stake for di Anambra governorship election.

  3. Elderly pipo complain say BVAS no dey work

    For Umuokpu Awka, ward 7unit 3 and 4 elderly pipo also complain say di BVAS machine reject dem and dem no fit vote.

    Some of dem sidon under di sun dey wait for Inec to rectify di matter.

    Cases of BVAS rejection also happun for Uroekwo ward 2 unit 3 and 4.

  4. APC candidate hope to defeat oda candidates

    Candidate of di All Progressives Congress, Senator Andy Uba don cast im vote for di 2021 Anambra governorship election.

    Afta im vote, di Senator tok say e dey confident im party go defeat odas and come out victorious.

    Uba say "im dey happy wit di electoral process and di turn out dey impressive" plus Inec bin "try well-well".

    Im point out say "di small hitches wey occur earlier, dem don dey fix am."

  5. PDP candidate cast im vote

    Candidate of di People's Democratic Party, Valentine Ozigbo don cast im vote for im unit wey dey for Amesi.

    Oga Ozigbo beg inec to "extend voting time" for areas wia di Bvas machine delay voting.

    "I dey worried wit how long e take me to vote as di BVAS machine no quick work."

    Im call on agents of im party and other political parties to remain vigilant and steadfast against any manipulation of votes and result.

    He and im wife together vote for dia polling unit.

  6. Anger as Inec BVAS machine fail to work

    Pipo para for Uruekwe units 1 and 2 Ward 003 Enugwu Ukwu sake of di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) wey no dey work well.

    Some voters wey say dem don dey di polling unit since 6:30am tell BBC Pidgin say di Bvas machine don reject dem several times.

    Inec adhoc staff for di ward say di machine don reject about 70% of di voters dem dey try accredit and di situation dey make pipo vex.

    She say dem don report di incident to di Electoral Officer in charge of di ward.

  7. Voting don start for APC candidate polling unit

    Accreditation and voting also dey go on for Aguata ward 16 polling 17 wia di All Progressives Congress (APC) candidate, Senator Andy Uba dey expected to cast im vote.

  8. 'My children bin tell me say make I no come out'

    Just before di election today fear bin dey say security no go dey to stop katakata from happening.

    Dis make police deploy over 30,000 police officers go di state.

    Na dat number put confidence for Mrs Agnes Okoli wey tok say her children bin warn her not to go vote.

    But she "hear for radio say security go dey and she expect pesin wey go win to work well for Anambra state and remember her community Amesi and also stop di too much killing for di state.

  9. Breaking, Willie Obiano cast im vote

    Anambra State Governor, Willie Obiano and Im wife, Ebelechukwu Obiano don cast dia vote.

    Dem vote for Eri Primary School, Otuocha 1, polling unit 004 for Aguleri around 9:44am.

    Govnor Obiano call on eligible voters to come out and perform dia duty without fear.

  10. 'I dey happy say I fit vote my favourite candidate'

    One of di voters wey turn up to cast e vote, Uchenna Onyeka say im dey happy say im fit cast im vote for im favourite candidate afta di tension wey bin don happen for Anambra state.

    Onyeka say na di deployment of security operatives wey im see give am di confidence to come out to vote.

    "Di sit at home order bin worry my mind well sake of say I bin don get plan to vote for pesin wey I like for Anambra state.

    "As I see how police pipo and army enter Anambra e make me happy well well.

    "I don cast my vote for my preferred candidate and I dey pray make e win," Onyeka tok.

  11. Inec deploy BVAS machine wey dem say dey fast

    Inec deploy Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) for today Anambra State Governorship Election as dem tok.

    According to di commission, di accreditation process for di election go include verification and authentication of voters using di BVAS for cross-checking names of voters for di e-register and authenticate di voters using di fingerprints or facials.

    Di introduction of di BVAS don make voting dey faster dan as e dey be before according to Inec.

  12. Meet Angela Odinaka one of Inec observers

    Meet Moubu Angela Odinaka, pesin wey dey live wit disability wey dey work as observer for di Anambra governorship election.

    Odinaka tell BBC Pidgin say she dey work for Access Network and her role na to check preparation wey Inec don make for physically challenged pipo to vote.

  13. Polls don officially open

    Officially according to Inec voting don suppose start.

    Di time wey dem give na say voting fo start by 8:30am for morning and end by 2:30pm for afternoon.

  14. Youths set up polling unit for Amesi

    Less dan 30mins before polls open, pipo still dey set up for di Amesi social polling centre.

    Dis na di place wia di candidate of di People's Democratic Party, Valentine Ozigbo go cast im vote.

  15. Wetin Anambra pipo must do today - Bishop Kukah

    Di Bishop of Sokoto Catholic Diocese say di Independent National Electoral Commission (Inec) go declare winner of di governorship election on Saturday weda pipo come out to vote or not, di election process wey don start go end.

    "If you no wan vote, e better make dem sidon for dia house but no be to come stop oda pipo wey wan exercise dia right," di Bishop tok

    "Dem need to realise say some pipo go still come out to vote and Inec go only count di number of votes wey dem see. Winner must dey.

    "Anambra pipo get luck say majority of di candidates wey dey contest di 6 November governorship election na pipo wey go school."

  16. Governor Obiano ask Anambra pipo to come out early

    Di incumbent govnor of Anambra State, Willie Obiano don tell pipo for di over two million registered voters for di state to come out early to vote.

    Governor Obiano assure di pipo say voting go dey peaceful, free and fair.

    Already police don deploy 34,500 officers of different unit go di state.

    Voting go start by 8:30am and e go close by 2:30pm

  17. Inec clear 18 political parties

    Ahead of today election, Nigeria election body - Independent National Electoral Commission bin don clear 18 political parties to contest for di election.

    Tori be say one of di candidates don allegedly step down. According to one statement wey comot Chidozie Nwankwo step down as di governorship candidate of African Action Congress (AAC).Nwankwo for di statement say e don collapse im political structure to support di candidate of di PDP, Valentine Ozigbo.

    But we don receive reports say oga Nwankwo don deny say im step down.

  18. Welcome to BBC Pidgin live coverage of Anambra Governorship Election

    Good morning.

    Welcome to BBC News Pidgin live-text commentary of di 2021 Governorship election wey dey happun for Anambra State.

    Make you dey refresh dis page from time to time as we go bring you ogbonge update of how di election dey go.