Nigeria election bodi Inec don announce say dem fit continue di election voting process on Sunday sake of some challenges wey dem dey face for field on Saturday.
For statement for dia official social media handle, dem announce extension of voting time from 2:30 pm to 4pm sake of challenges wey di BVAS machine dey cause for some polling units for di state.
Di statement say dem dey investigate why di machine work for some places but no work for odas.
Inec say, “Our technicians don build update for di devise to avoid repeat of di situation and dey upload di update “.
Di statement further tok say if di BVAS machine continue to dey malfunction, dem go move di election process for dose units to Sunday or any oda time wey di commission go tok.
Inec also admit for di statement say transportation mata affect dia work for some areas as some local media bin report.
E say “some of our transporters cancel dia trip sake of fear of security afta dem don collect 50% of dia moni, dem leave some of adhoc staff stranded"
Di statement further tok say some Inec adhoc staff back out from dia assignments at last moment.
Meanwhile, voting done end for most polling units and counting don start.