BVAS na di new voting device wey dey for cross-checking voters names for di Register of Voters.
E dey authenticate voters wit di use of dia fingerprints or facials.
INEC chairman, Professor Mahmood Yakubu during one stakeholder meeting on di Anambra State Governorship Election on Wednesday bin introduce BVAS device and e tok say di use of incident forms during elections no go dey again.
BVAS wey im full meaning be Bimodal Voter Accreditation System get dual capacity for fingerprint and facial authentication of voters.
Dis one na to guard against voting identity mago-mago. E mean say one pesin fit wan try use anoda pesin Permanent Voter's Card (PVC) to vote but wit dis new machine e no fit dey possible.
According to INEC, incident form no go dey useful again as pesin fit cheat wit am.
Voter wey no get original PVC no go fit vote.
Voter wey no dey successfully accredited electronically wit BVAS no go vote too.