INEC final results show how Gov. Akeredolu sweep Ondo election
Ondo State Governorship Election latest updates from di sunshine state of Nigeria 10 October vote.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Helen Oyibo
33,000 security men go tanda for 10 October election
IGP of police don warn politicians say dem no go tolerate violence and disruption during Ondo Governorship Election dis Saturday.
IGP Adamu Muhammed give di warning on Monday for di stakeholders meeting wey dem do today for Akure.
Police go send over 33,000 security men go tanda for di election on 10 October.
'ZLP Ajayi plan decamp to join Jegede PDP tori no be true'
Wia dis foto come from, Other
Di tori wey dey fly upandan say ZLP govnorship candidate,
wey be di deputy Govnor of Ondo state, Agboola Ajayi wan decamp to join PDP no
dey true.
Na wetin ZLP spokespesin Banji Okunomo tell BBC
Pidgin.
Okunomo say dia party no fit bend down for any
oda 'weaker' party and di rumor na political propaganda wey no get any truth
inside.
“Di
popularity of di candidate of di ZLP, Agboola Ajayi dey go higher and higher
every day”.
Im tok say di rumor na political propaganda wey
no get any atom of truth inside.
“As far as di election dey, na two horse election
between di Deputy Govnor, Agboola Ajayi and di Govnor, Rotimi Akeredolu.”
Banji Okunomo say pipo don dey even decamp from
di APC and di PDP to join di Zenith Labor party.
Face mask wey cari political party logo or brand no go dey allowed to vote, No face mask, no voting
Wia dis foto come from, Getty Images
In line with safety guidelines for Covid-19, di Nigeria election office INEC don say all
voters must come wit not just dia permanent voters card but also face mask.
Dis face mask must not get branding of any political party
ontop, di Di Resident Electoral Commissioner for Ondo State bin warn.
Anybodi wey turn up wit face mask wey dem write political
name ontop, no go get chance to vote.
Ambssador Oloruntoyin Akeju
also tok say voters must observe social distancing and wear dia face mask.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, INEC say voters for Ondo govnorship election must come wit facemask wey no get logo or message from political party
Blind pipo fit choose who go assist dem vote – Ondo REC
Di Resident Electoral Commissioner for Ondo State don
say provision go dey for blind pipo wey wan vote during di upcoming election.
For di stakeholders meeting against di 10 October govnorship elections, Ambassador Oloruntoyin Akeju say allowance go dey for blind
pipo to carri pesin wey go assist dem vote come polling station.
Dem also fit ask election officials or security personnel to
assist dem, but party official dey banned to offer helep.
Wetin we call dis foto, Braille guide go dey available to assist blind pipo chose which party dem wan vote for
Youths dey march for Akure, carri 'Ondo no be Lagos' placard
Our reporters for Akure sight some youths dey march for road, wit placards for hand wey get different-different messages.
Dem tell BBC say di march na to draw awareness give di Inspector General of Police to make dia vote count inside di upcoming 10 October govnorship elections for Ondo.
Some of di placards get messages like "We say no to violence, thuggery & election rigging", "Ondo no be Lagos" and "No to fake policemen".
E no be like say di youths dey represent any political party, as nobody among dem carry or wear party logo or colours.
See photos from INEC Ondo Elections stakeholders meeting ahead of 10 October vote
See some photo from di Ondo Elections stakeholders meeting wey go involve security oga, traditional rulers and representatives from political parties and di election office INEC.
INEC final results show how Gov. Akeredolu sweep Ondo election
Wetin you suppose know about di October 10 Ondo govnorship election