Wetin dey happun for Benue
- Author, Dooshima Abu
- Role, Benue, Nigeria
Long queue for APC secretariat for Makurdi, Benue State capital as dem prepare to collect sugar, spaghetti for di party secretariat.
Di party start di sharing since yesterday.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.
Daniel Semeniworima
Long queue for APC secretariat for Makurdi, Benue State capital as dem prepare to collect sugar, spaghetti for di party secretariat.
Di party start di sharing since yesterday.
INEC for Cross Rivers State say dem dey ready for di govnorship and state house of assembly election wey go happun on Saturday 9th March.
25 candidates dey contest for di govnorship election while 265 candidates dey contest for di state house of assembly election.
29 states go do gubernatorial elections on Saturday 9 March to decide who go be dia govnor for anoda four years.
Una welcome to all di correct and confam tori dem on top di election as e dey hot .
BBC News Pidgin reporters tanda across Nigeria to give you live tori wey concern di govnorship and State house of assembly election dem.
Use #BBCNigeria2019 to follow di tori dem.