Check check Nasarawa
Dis corper for Lafia, Nasarawa State northcentral Nigeria dey clear which polling unit e be.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.
Daniel Semeniworima
Dis corper for Lafia, Nasarawa State northcentral Nigeria dey clear which polling unit e be.
Some pipo for Calabar, di capital of Cross River state for southern Nigeria dey do like say Saturday election no concern dem.
Voting suppose start from 8am to 2pm, but most pipo dey go find dia own bizness.
Aisha Zakari don tanda for her polling unit for north bank 003, Makurdi Benue State since 6:30 am and dem say she comot early to make sure say she vote Kia-Kia. Inec officials dem don also land dia polling unit.
Some polling units don open for Asaba, di Delta State capital for south-south Nigeria.
Women, men and voting materials dey on di move for Makurdi, di Benue State capital for north central Nigeria.
Ward 3 (unit 1 and 2), for Uyo, Cross River state don set dey wait for 8am.
Na 36 states dey Nigeria, but na for only 29 pipo go vote to elect govnor. Di oda seven get different dates wen dem dey do dia own govnorship election.
All di 36 states go do House of Assembly elections to elect lawmakers and voting go also happun for di Federal Capital Territory Abuja, wia dem go vote for area council elections.
Nigerian army say dem don begin torchlight videos wey dey fly for social media, wia claim be say sojas enta house of some politicians for Rivers State.
Army wen post for dia twitter account, say wen e concern politics, dem no belong to anyside.
Dis na one of di videos wey dey fly for social media:
Heavy presence of police and military na im dey ground for 10 local goment areas of Benue State.
Oga Godwin Nwobodo ey be Deputy Inspector General of Police wey dey in charge of North Central, say dis 10 LGAs na flashpoint areas during di last election.
So far police don deploy from Abuja five commissioners of police, four deputy commissioner of police and two assistant commissioner of police go areas like Agatu, Guma, Logo, Gwer-West, Gwer-East, Katsina Ala, Okpokwu, Ukum, Benue south and Benue east.
All these local goment na wia PDP win election for di presidential election and dis na why some youth group enta street to do I-no-go gree on top di mata and di state goment dey cry say dem wan use federal might do wuruwuru for di election.
Wen tori pipo ask di police oga why dem no send dat kind security to Konshisha, area wey be say APC get string leg, e say di police wey dey ground for dia.
INEC office still dey very busy for Yenegoa Bayelsa state as dem still dey move election materials to local goment areas and RAC centres.
Six out of eight local goments don carri dia election materials while di remaining two LGA’s dey readi to carri dia own.
Security dey tight for di office as different agencies full ground to protect di area.
Tamuno Akalokpo wey be Chief of Staff to di Amanyanabo of Okochiri Kingdom for Okrika local goment of River State, say one pesin die afta sojas of Nigerian army take force enta di King palace.
Chief Akalokpo give di pesin wey die name as John Ogbu, say di whole Okochiri community dey vex for wetin happun na im make dem wear black cloth come out to protest di attack on Friday.
BBC Pidgin don dey try since Thursday, to hear from Nigerian army about wetin dey happun for Rivers State, but dia tok-tok pipo neva pick call.
Chief Akalokpo say na disrespect to dia King and say make federal goment chook eye sharperly for di mata before water pass garri. "We di pipo of Okochiri Kingdom no dey happy wit dis attack on our King. Im no dey less than di Emir of Kano, Sokoto, di Oba of Yorubaland and oda high Kings for di kontri so why dem no fit give respect to im royal stool?"
Chief Akalokpo come beg di community pipo to cool down, make wetin happun no discourage dem to participate for di election on Saturday but make dem come out come vote peacefully.
APC for Edo state say, dem don already cari di case of dia candidate Osaro Obazee wey one court bin sack, go Court of Appeal and say dis case fit reach Supreme Court.
High Court for Benin on Wednesday 6 of March, sack oga Osaro as di candidate to represent APC for di Oredo East constituency election.
But, APC chairman for di state, Amsalem Ojezue tell BBC Pidgin say “we as a party, we know say Osaro Obazee na our candidate becos na im name we submit give INEC.”
Osaro na ogbonge parti member wit plenti plenti supporters, wey e neva clear weda dem go gree support Ekhosuehi Aighobahi wey court just put as candidate.
According to Oga Ojezue, dem no shake at all becos dem know say Obazee supporters go still support APC for Oredo East constituency.
One of di women wey dey protest Bertha Godwin say she dey vex because of di way di military pipo carry come invade dia king palace say na disrespect and dem no show regard for am.
Tori be say chiefs, women and youths of Okochiri Kingdom for Okirika Local Goment Area inside Rivers State, south southern Nigeria do protest waka for di invasion of dia king palace by men wey wear Military uniform.
On Thursday 7 March, some sojas enta di of palace of Ateke Tom wey be former Niger Delta militant and now Amanyanabo of Okochiri come ransacked di place.
“I no dey hia because of politics, no! Me I from dis place and di way dem take embarrass my King I am not happy. Di whole world know say my King na peace ambassador and im neva change. Wetin dey happen? Im no be politician, make politicians leave am alone. Dem come spoil di whole place abi dem no get respect for dia King? My King respect 100 percent and we must give am dat respect.”
Benue State don get new commissioner of police ahead of di governorship and state assembly election.
Di name of di new commissioner na Umar Muri and e resume work today for di police Headquarters for di state. Umar Muri bin dey in charge of procurement for police headquarters for Abuja before dem transfer am come Makurdi.
Di Governorship Candidate of African Action Congress AAC Awara Biokpomabo don confam to BBC Pidgin say true true di All Progressives Congress APC don adopt am as dia candidate for di governorship election wey go hold on Saturday.
Im say oda political parties too like YPP dem sef don endorse am because dem see say im na candidate wey get integrity and dey willing to serve Rivers pipo.
Afta di opposition Peoples Democratic Party win Edo state for di presidential election wey jus t finish, APC for di state neva fit sleep well as State Assembly election go shele on Saturday March 9.
Even though di south - southern state no go elect new govnor, di way wey PDP take win presidential election for di state create tension as di State House of Assembly wey be mainly APC, fit see wonders if PDP win majority.
One issue be say voters fit decide say dem no go go vote again as dem suffer finish for di presidential election to try vote out APC for di kontri but e no work.
Di worry be say, voters fit decide say sake of dis one, dem no send di election again.
Anoda issue na say di Federal High Court for Benin, sack Osaro Obazee put Ekhosuehi Aighobahi as di APC candidate for Oredo East constituency.
Obazee na ogbonge APC member wit plenti supporters. Wetin fit happun if im decide to port wit im supporters neva too clear for now.
Di uncertainty for Edo state show for meeting wey govnor Godwin Obaseki bin get wit officials of Nigeria Labour Congress NLC on Wednesday 6 March.
For di meeting, im encourage di different labour unions to helep am ginger dia pipo to go out go vote.
Plenti activities dey shele for local goment INEC office dem for Edo state south southern Nigeria.
Dis na as all di election materials sensitive and none sensitive don dey move go di 24 state constituencies.