You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kano Govnorship Elections dey INCONCLUSIVE!
Nigeria election bodi INEC still dey announce results for different states as e concern Saturday govnorship election.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
Dis filling station na polling station today
No be everytime pesin go enta wia im wan buy petrol only to see pipo tanda dey vote for Lagos.
Dis na 'Total voting station'. Sake of di election, for today di actual name na: Polling unit 23 ward 3, Ikeja LGA
, Vote sorting and counting don begin for di different polling unit for Benue State.
Atiku Abubakar dey ask pipo to defend dia vote
Dem don begin count votes for Nigeria state elections
Dem don begin count votes for different polling units wia voting happun on Saturday for Nigeria.
For 29 of di 36 states, pipo vote to elect govnor, while House of Assembly elections take place for all 36 states. Dem also vote for area council elections for di capital Abuja.
Pipo no too come out to vote across di kontri, and BBC tori pipo carri eye see voters wey some party agents dey give moni to "buy" dia vote.
Why Bola Tinubu discribe oda political parties for Lagos as crabs?
APC oga for Lagos State and di party national leader, oga Bola Tinubu say di party go win di state elections.
Im follow tori pipo yan afta im vote on Saturday.
500 or 1000 naira to buy vote?
Wetin be di value of vote na im dey touch head for dis video BBC tori pesin take eye see for Bayelsa State.
E no clear which party dey responsible for dis one, for state wey only House of Assembly election dey happun.
Pipo wey turn road to boxing ring
Voters no too show for presidential villa polling units
Voters no too show face for di polling units wey dey inside Nigeria presidential villa.
As at 12.30pm, Inec officials just dey press phone, some dey gist and odas dey sleep as work no dey to do.
For di presidential election on February 23, both PDP and APC bin share di two polling units 1-1 wey dey inside di villa.
"Red hot" Sanwo-Olu don vote
We no sabi who APC candidate oga Babajide Sanwo-Olu dey blow kiss, but na wetin im do afta im vote for Lagos State.
"Na result remain now"
Voting don end for dis PU under tree along Epe express way for Oko Alangbon village, unit 040.
INEC Adhoc Staff wey siddon dey wait along wit some pipo say dem don finish as at 12:10pm and dem tanda dey wait till 2:00pm to start vote counting.
Breaking, Oga di Jagaban don vote
Article Information - Author, Olubunmi Okunnu
- Role, BBC Pidgin, Lagos
Leader of di All Progressives Congress for Nigeria, oga Bola Tinubu don vote by 11:55pm.
Voting no quick start for im polling unit as Inec officials no show early, but as dem come, voting start.
Wend di APC leader come out to vote, e just waka go front pass pipo wey dey for line, go vote, as Jagaban im be.
APC Govnorship candidate for Lagos State, Babajide Sanwo-Olu dey vote
Blind voter dey look forward to 2023
Article Information - Author, Mansur Abubakar
- Role, BBC Pidgin, Kano
Saifullah Muktar don dey blind since dem born am tell BBC Pidgin say e just vote.
E tok say na im broda help am so e go fit vote for di party im like pass.
Oga Mukhtar get hope say by 2023, dem go fit dey use d special ballot for di blind fully.
Govnor Ambode na still my hero
Some pipo still dey vex for Epe area of Lagos State say Govnor Akinwunmi Ambode no dey come back for second term.
Fatimah Salau wey tok to BBC Pidgin say if no be say di govnor beg pipo to come out vote say area for empty like burial ground. Salau say Epe na place wey previous goment bin bone before sotey dem dey call dia road suicide road. But Ambode do road, empower pipo, make belle sweet Epe pipo, boost pipo morale well-well.
Fatimah say all in all even though APC reject Ambode, Epe pipo no reject am, say infact say na still dia hero.
Dem don break dis polling agent head
Dis wan hapun for Polling Unit 007 for Oju-Ekun Zarumi, Ilorin West local goment area.
Oga Jona and madam Pepe don vote
Former Nigeria presido Goodluck Jonathan wit im wife Patience and mama Eunice don vote for Otuoke Bayelsa State.
EFCC don gbab 'moni van' for Benue State
Jaguda pipo burn election materials for Benue State
Article Information - Author, Dooshima Abu
- Role, Benue, Nigeria
Electoral materials burn down for Mbalom ward for Benue State, northcentral Nigeria.
According to di state INEC, di jaguda boys dem bin start to shoot and INEC officials dem come run leave di materials
So far report neva dey weda any pesin die for di incident. Security and INEC officials don dey chook eye for di mata.
More govnors don vote