Meet INEC Observer wey dey monitor election postponement

INEC don talk say on top some logistics things, presidential and national assembly elections for Nigeria go hold for February 23 and Governorship election go hold for March 9.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. Nigeria election office don replace Plateau State election materials wey fire burn

    Di Independent National Electoral Commission, INEC announce on Friday say elections go still hold for Qu'an Pan local goment for Plateau State, north-central Nigeria where fire bin burn voting materials.

    INEC say dem don move dia office for di area to new location and dem don also deliver fresh supplies of voting cubicles and ballot boxes.

    For di statement Nigeria election office say dem don finish reprinting of di voters register for di area wey di fire affect.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  2. Una Good Morning

    Una welcome to today tori .

    BBC get reporters for all di 36 states for Nigeria to give you di latest ontop dis election. Friday wey go continue again.

  3. , Na here we go match break for today.

    Make we end wit dis foto of fire truck wey tanda for Benue State office of INEC.

    BBC get reporters for all di 36 states for Nigeria to give you di latest ontop dis election. Friday wey go continue again.

    Fire truck
  4. Buhari use presidential broadcast continue campaign

    Buhari

    Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo

    Nigeria President Muhammadu Buhari use im presidential broadcast on Thursday take continue im campaign.

    Many Nigerians bin dey look forward to di speech, to hear wetin Presido Buhari go tok, two days before presidential and National Assembly elections.

    But di president use di about 20 minutes speech, take list some things wey im goment don do, and add say im goment go dia best to make sure say di 2019 elections take place for secure and peaceful atmosphere.

  5. Albinos go get glass wey go help dem see wella

    Albinos for Cross River state go get opportunity to vote without any wahala on Saturday. Dis na as election bodi INEC for di state don receive magnifying glasses wey go helep dem see di ballot paper well-well. Di state INEC say dem still dey wait di Braille wey go help blind pipo self vote for di election.

    magnifying glass
  6. 73 presidential candidates dey make Ghanaians wonder if Nigeria dey go election or beauty pageant

    Beauty model

    Wia dis foto come from, Getty

    73 presidential candidates for ballot paper top, di number make some Ghanaians dey wonder if Nigeria dey go election or beauty pageant. What shock menerz for Ghana be pictures of di ballot paper wey Independent National Electoral Commission (INEC) release which dey show di huge number of people for di ballot top. Some political scientists talk say although electoral politics be necessary for democracies, dis number be too much wey check like e dey reduce di quality of di electoral process. Dr Isaac Owusu-Mensah, lecturer for University of Ghana talk BBC Pidgin say "so far in di world dis be di biggest number of candidates on di ballot." He argue say sometimes people too dey wan make popular so dem just go put dema body on di ballot paper so say after di elections dem go fit get some influence for di country. He explain say di 73 candidates go fit increase spoilt ballot for di elections sake of people go make confused on who dem dey vote for sake of di list be tall. Secondly, although di people wey be well educated go fit see inside well, those wey no sheda be literates go fit struggle den spoil dema ballot. Thirdly, Dr Owusu Mensah also explain say di long list go fit reduce transparency from di elections, as some people go fit shedda sponsor some small parties make dem just frustrate dema opponents. Although Nigeria set history plus dis number, di problem be say e no be good democratic history especially when spoilt ballots alone for di 2019 Nigeria election go fit be plenty pass some party en total votes.

    Dr Owusu Mensah

    Wia dis foto come from, @GHONE/TWITTER

    Wetin we call dis foto, Dr Owusu Mensah say Nigeria make history
  7. , As customs close land borders, Nigeria Police say no moto movement for road.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  8. Nigeria go close borders from Friday to Sunday

    Nigeria Minister of Interior, Lt.-Gen. Abdulrahman Dambazau don direct say make dem close all di kontri land borders from Friday, February 15 to Sunday, February 17 for di Saturday Presidential and National Assembly elections.

    Statement wey di Comptroller-General, Nigeria Immigration Service, oga Muhammad Babandede,release, say movements no go dey across di Nigerian borders during di election days.

  9. Kano Police arrest two men wit fake ballot papers

    Kano Police Command say na fake tori say police arrest some trucks for di state with thumb printed ballot papers.

    Tok tok pesin for di state police command, DSP Abdullahi Haruna tell BBC Pidgin say na specimen ballot papers wey dem see wit di two men wey dem catch, say no be di real ones wey dem go use vote on Saturday.

    Im say dem still dey torchlight di mata and dem don transfer di case to di state Criminal Investigation Department..

    Ballot paper specimen

    Wia dis foto come from, INEC

  10. "I beg una election no be war o" - America Ambassador dey tell Nigerians

    US Consul General for Lagos F. John Bray yan give BBC News Pidgin say make Nigerians no sell dia vote.

    "I beg una election no be war o"

  11. Rivers State don declare Friday work free day

    Gov Nyesom Ezenwo Wike

    Wia dis foto come from, Gov Nyesom Ezenwo Wike - CON/Facebook

    Rivers State goment don declare Friday work free day sake of Saturday election.

    Governor Nyesom Wike just finish state broadcast where im declare Friday 15 February as public holiday.

    Wike use di broadcast call on international community to shine eye well-well inside security during di elections

  12. Mopol dey ginger to protect election material for Calabar

    You fit relate wit di songs dis mobile police men dey sing?

    Use #BBCNigeria2019 take join di conversation.

  13. INEC don distribute all di non-sensitive material and na 2.2 million pipo get PVC to cast dia ballot

    INEC HQ for Benue state

    Series of activities na im full ground for di Independent National Electoral Commission, INEC office for Benue State north central, Nigeria.

    Di State Resident Electoral Commissioner, Nentawe Goshwe Yilwatda tell BBC News Pidgin say e dey kampe to conduct free, fair and credible election for di state.

    E explain give say plenti security don dey ground to prevent any election wuru-wuru for di state and dat na anti-terrorism squad wey dey use red beret, na im dem dey use to escort di sensitive material to di 23 local goment area

    “We don do our risk assessment for areas wia election wuru-wuru and attacks di happun, we don put everi-everi in place to make sure say election happun jejely“

    “We don distribute all di non sensitive material tey-tey and for di sensitive ones, we go distribute am later on Wednesday”

    “ Some of di materials don already dey for Central Bank Of Nigeria and we dey expect few items from Abuja”.

    E yarn give say all di motor wey go cari di material don dey ground and about 23 thousand staff na dem go work during di Saturday election.

    Security tanda boku for Benue INEC office
  14. INEC Delta state dey concerned weda voters fit bone election

    INEC Delta State

    Di Independent National Electoral commission (INEC) for Delta State south-south Nigeria don tell pipo for di state say make dem no fear to come out cast dia vote on election because enof security dey to protect dem.

    Di INEC Resident Electoral Comissioner inside the state, Cyril Omorogbe way follow BBC Pidgin tok, say:

    "My advise be say make pipo follow directions and law plus make dem no allow pesin give dem money to vote for dem."

    "Make pipo no come like say dem dey ready to fight, make dem come like say dem dey come watch football and wen you finish go home in peace. "

    Oga Omorogbe say INEC no get any big challenge way dem dey face for di election inside di state but e add say some places dey wey pipo dey complain but im pray make e be say dem solve those problem before di election.

    "Some of di complain na from pipo wey be say dem get complain wey don dey tey like 20years ago and now dem want make you come fix di problem because election dey come in two days.

    "Some towns dey say goment don take dia land, job, take dis and dat, so dem go come complain say dem no want election, make e no hold. But my own reply be say dis one no be time wey you go take complain, if you wan complain afta election you fit come out to tell pipo wetin your palava be. Al these no go fit stop do election.

    E conclude say all those complain no concern INEC.

    Delta State REC for INEC, Cyril Omorogbe
  15. You fit join dis tori online wit #BBCNigeria2019

    Use #NigeriaDecides and #BBCNigeria2019 take find all BBC tori wey concern 2019 election.

    #NigeriaDecides
  16. For Akwa Ibom dem still dey wait for sensitive materials to land

    Resident Electoral Commissioner for Akwa Ibom, Mike Igini say di state still dey wait di arrival of sensitive materials even as dem don begin distribute non sensitive election materials go di different polling units for di state.

    Oga Igni dey hope before Thursday midnight everitin go arrive Uyo.

    Im also say make pipo no fear as dis go be one of di most peaceful election for di state.

    "For now, na just di non-sensitive material we dey share and we never begin see any challenges," na so oga Ignis tok.

  17. For Edo state INEC don move non sensitive materials

    Edo State Resident Electoral Commissir Emmanuel Alex Hart as im dey sign in for CBN Benin city to collect sensitive materials.

    Hart say di total number of PVCs wey dem record na 2,219,778 voters for Edo State

    Di number of cards wey dem collect na 1,735,910 while 483,868 cards still dey wey voters neva collect.

    Edo State Resident Electoral Commissir Emmanuel Alex Hart as im dey sign in for CBN Benin city to collect sensitive materials.
    Wetin we call dis foto, Edo State Resident Electoral Commissir Emmanuel Alex Hart as im dey sign in for CBN Benin city to collect sensitive materials.
  18. Nigeria Attorney General say make INEC postpone Zamfara State elections

    Di Attorney-General of di Federation, Abubakar Malami don tell Nigeria election join-bodi, INEC make dem postpone di National Assembly, Governorship and state assembly elections for Zamfara state.

    News Agency of Nigeria dey report say oga Malami say dis one go allow di All Progressives Congress for di state to produce candidates wey go run for di general elections.

    Court bin cancel di APC primaries for Zamfara but dem later declare di election as valid.

    But INEC Director of Voter Education and Publicity, Oluwole Osaze-Uzezi, tell tori pipo PUNCH say di commission neva receive di letter.

    Malami
  19. INEC don begin distribute election materials across di 36 states

    Nigeria election office wey be Independent National Electoral Commission begin distribute election materials on Thursday go di 774 local goment areas wey tanda for di kontri.

    INEC dey share dis material for Kano
  20. Warri!!!

    Well, no be really Warri, but election materials for Delta State dey di sorting process. Ughelli North and South na im INEC use block wedge, make breeze no enta tori.

    Delta INEC