Meet INEC Observer wey dey monitor election postponement

INEC don talk say on top some logistics things, presidential and national assembly elections for Nigeria go hold for February 23 and Governorship election go hold for March 9.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. , INEC still dey explain more

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  2. 'Based on logistics' - INEC don postpone Nigeria general elections

    Election bodi for Nigeria, di Independent National Electoral Commission don postpone di presidential, national assembly and govnorship elections for di kontri.

    Na on Saturday mor-mor wen may Nigerians still dey sleep, INEC Chairmo Prof. Mahmood Yakubu make di announcement. Im say na "based on logistics", INEC take di decision.

    Na on February 23 di presidential and national assembly elections go happun, while di govnorship and state assembly elections go hold on March 9.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. Na hia e go end today wit dis foto of dat very important paper from Bayelsa State.

    Ballot paper
  4. ‘We want leader wey go give IDPs beta life”

    Mama Mwuese and Dosur dey live for Abagana IDP camp for Benue State, north central Nigeria. Di two of dem dey share one room wit nine of dia relatives for di camp.

    Both of dem no dey well but despite di hard condition for di camp, dia only regret be say dem no get PVC to vote.

    Dem explain say dia PVC burn for dia village wen suspected herdsmen attack dia communities for Guma local goment area.

    Dem say dem hope do kontri get a leader wey go provide dem wit beta hospital and solve di farmer/herder crisis.

    Benue IDP
    Wetin we call dis foto, Mama Dosur
    Benue IDP
    Wetin we call dis foto, Mama Mwuese
  5. Gunmen don kill 66 pipo for Kaduna State one day before election

    El-Rufai

    Wia dis foto come from, El-Rufai

    At least 66 pipo don die afta gunmen attack Maro Gida and Iri communities for Kajuru local goment area of Kaduna state, north west Nigeria.

    Di Kaduna State govnor Nasir El-Rufai wey confam di tori, say among those wey die na 22 pikin and 12 women. Im say four pipo wey get wound na im security agencies rescue.

    Di govnor say dem don send more security go di area wia dis attack happun just one day before Nigeria go vote for presidential and national assembly elections.

    "Goment dey tell community, traditional and religious leaders for di area to encourage pipo wey dey live dia to avoid any do-me-I-do-you attack and to leave di mata for di hands of di security and law enforcement agencies," di govnor tok for statement wey Samuel Aruwan wey be im Special Assistant Media & Publicity sign.

    Kaduna na one state wey don get kasala between Christian and Muslim communities, farmers and herdsmen and oda katakata between communities. E no clear weda dis attack get anything to do wit Saturday elections.

  6. , INEC staff still dey sort voting materials for Edo State.

    INEC Edo
    Wetin we call dis foto, One woman work. But e no look like e hard for dis INEC staff wey dey sort materials.
    INEC Form
    Wetin we call dis foto, Dis na very important form for election bizness for Nigeria. Na dis one dem dey take record result and if any party suspect magomago, na one of di evidence INEC suppose submit for court.
    INEC staff
    Wetin we call dis foto, E be like dis INEC staff no go close by 6pm today, and dem no happy at all.
  7. Distribution of sensitive materials for Edo state don hang

    INEC office for Edo State neva begin move sensitive election materials go di different polling units for di 18 local goment areas of di state.

    One of di top INEC official wey no greee tok im name, tell BBC Pidgin say dem get serious mix up. Dem no even sure say di sensitive materials go leave CBN office for Edo capital Benin on Friday.

  8. Kano Police arrest man wit 500 weapons

    Kano state police command say dem don arrest one man wit over 500 sticks or canes locally called Gora. Dis sticks na popular weapon for northern Nigeria wey political thugs dey use. Tok-tok pesin of di police command say dem don transfer di man to di Criminal Investigations Department.

    Thug with weapons
  9. , No food Saturday, no food Sunday. Di Shagalinku menu.

    Banner
  10. Police don set up special team to arrest vote buyers and sellers

    Nigeria oga patapata of Police Mohammed Adamu don set up Special Election Investigation Team (SEIT) wey dia work na just to arrest and investigate those wey go buy and sell votes across di kontri.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  11. , Some pipo go say elections na about di numbers.

    Nigeria numbers
  12. , Voters for Calabar...'#NigeriaDecides

    Dis na how Cali town doo ready for Nigeria general election.

  13. Pipo dey use public holiday travel out of Port Harcourt

    Pipo for Port Harcourt dey use di public holiday wey diRivers State goment declare on Friday to travel go village, wia dem register to vote so on election day dem go vote who dem like.

    But some of dem say dem no go bother come out to vote because dem feel say dia vote no go count because whether dem vote or not, result go still comot.

    Meanwhile, INEC Rivers still dey wait for signal from CBN so dem fit go distribute sensitive materials to all di local goment.

    Head of Voter Education and Publicity INEC Rivers State, Edwin Enabor tell BBCPidgin say dem no too get any challengefor di distribution as dem don almost finish distribution of non sensitive materials.

    Im say already big trucks dem tanda outside di office wey dey ready to carry di sensitive materials go wia dem go work once dem get signal from CBN, say na dia dem go distribute direct go di local goment.

    RTC Motor park for Port Harcourt
    Wetin we call dis foto, RTC Motor park for Port Harcourt
    RTC Motor park for Port Harcourt
    RTC Motor park for Port Harcourt
    RTC Motor park for Port Harcourt
  14. Election ‘Black Friday’ Shopping rush don start

    Nigeria police don restrict movement from 6am to 6pm on Saturday 16 February, sake of di general election

    For Kano north west Nigeria, na ‘Black Friday’ Shopping rush don start sake of say of pipo wan stock food ahead of di election waka.

    Abubakar Musa for Kano
    Wetin we call dis foto, Abubakar Musa tok say e dey buy food wey go last am and im family for di weekend since e sabi say markets and shops go dey closed throughout di election period.
    Mallam Gambo wey be tomato seller for Kano
    Wetin we call dis foto, Even for sellers na big market day as Mallam Gambo wey be tomato seller don sabi.
    one basket of tomato
    Wetin we call dis foto, E tok say for normal day na one basket of tomato, but today e don ready with six baskets for di rush to buy market before di election weekend.
    Mallam Alhassan
    Wetin we call dis foto, African star apple and cashew seller Mallam Alhassan na one of di millions of ordinary Nigerians wey say im already dey happy to cast im votes tomorrow.
  15. Akwa Ibom NYSC members never know wia dem post dem go

    With only hours wey remain to di 2019 general election some youth corps members wey go serve for polling units for Akwa Ibom, south-south Nigeria still never know wia di kontri election office - INEC go post dem.

    As of Friday morning, corpers gada INEC office for Uyo to find out wia dem go serve for di election.

    One of di youth corpers tell BBC say;

    "Majority of di corpers na today dem go know wia INEC go post dem go."

    "Until now only some of my friends don know dia own as di process dey very slow, but we dey ready to serve for anywia dem send us go."

    INEC don send non-sensitive materials to di different parts of Akwa Ibom and dem say dem go send sensitive ones before today go finish.

    February 16 na im be di date for presidential and senatorial elections for Nigeria.

  16. Observers from ECOWAS, US Consular General dey meet INEC Rivers REC

    Observers from ECOWAS and US Consular General for Lagos John Bray dey do meeting with INEC Resident Electoral Commissioner for Rivers State south-south Nigeria.

    More tori to follow.

    US Consular General JOHN BRAY as e dey comot for INEC office
    Wetin we call dis foto, US Consular General John Bray as e dey comot for INEC office for Port Harcourt
  17. Why INEC neva begin distribute results and ballot paper for Bayelsa

    Less than 24 hours to di 2019 Nigeria presidential election, INEC wey be national election office - neva begin distribute results and Ballot paper for Bayelsa state south south Nigeria

    Plenti cars, trucks and vans pack around di commission office for Yenegoa readi to carri di materials once dem begin distribution.

    INEC Resident Electoral Commissioner for Bayelsa State Monday Ndoto tell BBC Pidgin say dem don cari all di sensitive materials from CBN office and dem go distribute am later today wen all di party representatives dey around.

    “Evritin wey pesin dey do, challenges must to show face but we dey handle all di challenges as e dey come”.

    Oga Ndoto say dem don dey fully readi for di Saturday election.

    Bayelsa na home to former Nigerian Presido Goodluck Jonathan.

    Meanwhile is na wetin we cari eye for INEC office dis morning for Bayelsa State south-south Nigeria.

    Plenti INEC adhoc staff block di commission gate to check dia names an just dis morning wey dem release di list.

  18. How voters dey prepare for north-central Nigeria

    BBC Pidgin enta street for Makurdi wey be capital of Benue State for north central Nigeria to ask pipo how dem dey prepare to cast dia vote on election day.

    Today na di last day before ogbonge Presidential and National Assembly election for Nigeria wey go happun on Saturday 16 February, 2019.

    For Benue na about 2.2 million pipo Nigeria election office register to vote for dis election.

    Di Independent National Electoral Commission say e dey ready to conduct free, fair and credible election.

  19. INEC dey move ballot papers and result sheets dis morning

    Di Independent National Electoral Commission (INEC) for Delta state, go begin carry sensitive materials go di 25 Local government area for di state today.

    Dem go move to sensitive material from Central bank of Nigeria (CBN) office wey dey Asaba di state capital.

    Resident Electoral Commissioner Cyril Omorogbe just show face for dia dis early morning.

    Strong security presence dey around di gate of di CBN Asaba office to move di sensitive material like ballot papers and result sheets.

    Security pipo for Central Bank of Nigeria Asaba office
  20. Nnamdi Kanu don stop election boycott

    Nnamdi Kanu wey be separatists leader for Nigeria Igbo speaking south-east region don tell im supporters make dem no avoid saturday general election.

    Dis na afta im bin vow to stop di whole Igbos not to vote during February 16 general elections if dem no fit get chance to vote for dia freedom to breakaway from Nigeria go form anoda kontri - Biafra.

    Mazi Kanu for im latest announcement say as dem don meet all di condition wey im group - Indigenous People of Biafra (IPOB) bin demand, im dey call-off di election boycott order.