YELLOW CARD, Ghana 0-1 Cape Verde
Cabral try to counter Ghana straight from dia own corner-kick.
As im try to run clear, Joseph Paintsil bring am down.
Di winger name don also enter di referee notebook.
Cape Verde score late to beat Ghana 2-1 afta Egypt bin draw 2-2 wit Mozambique.
Moseph Ekine
Cabral try to counter Ghana straight from dia own corner-kick.
As im try to run clear, Joseph Paintsil bring am down.
Di winger name don also enter di referee notebook.
Bebe shoot de free-kick into de wall as de defenders deflect e shot.
De ball fall to anoda Cape Verde player wey pass am back to Bebe but de Rayo Vallecano man shot from de pass no dey on target.
Ghana try to play out from de back but Baba Idrissu miscontrol di pass from Djiku.
Monteiro steal de ball from am before de midfielder bring am down.
E don collect de second yellow car of dis game.
Ghana resume play as di second half don start.
De Black Stars need to find a way past dis Cape Verde defence.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
De referee don blow im whistle for half-time.
Cape Verde go go into di break wit di lead afta Ghana bin tink say dem don score de equaliser.
De Black Stars go need try again for de second half but dis Cape Verde team dey deadly on de break too.
Jordan Ayew try im luck from free-kick wey referee give dem.
De Crystal Palace striker shot from about 25yards sail high over de bar.
Ghana 0-1 Cape Verde
We don enter into four minutes of added time.
De Black Stars still dey control much of de possession but Cape Verde defence make solid.
Ghana 0-1 Cape Verde

Wia dis foto come from, Getty Images
Referee Jean-Jacques Ngambo say di goal no go stand.
So di score remain: Ghana 0-1 Cape Verde
Di drama for dis match in di last five minutes pass Ghollywood.
Referee dey check VAR to confam if di goal go syand.
Konigsdorffer stand in front of di goalkeeper wen Ahimeru shot go in.
Majeed Ashimeru blast di ball into di net.
First Konigsdorffer header hit di post and straight from dat incident Ashimeru receive di ball, im turn well before e waya better shot past di goalkeeper.
Ghana 1-1 Cape Verde
Ghana 0-1 Cape Verde
De game don slow down slow down small.
But Cape Verde nearly increase dia lead. Monteiro again go close dis time as im test Ofori but di flag go up for offside.
Ghana 0-1 Cape Verde
Ghana now don dey in charge of possession but never really cut open Cape Verde.
Dem bin get good chance to equalise as Gideon Mensah send in one fine cross into di box but Konigsdoffer leg no connect well wit di cross.

Wia dis foto come from, Getty Images
Cape Verde don open di scoring through Jamiro Monteiro.
Di midfielder pounce quickly to convert di rebound afta Ofori save Cabral shot into im path.
Ghana 0-1 Cape Verde
Ghana 0-0 Cape Verde
Alexander Djiku don enter di referee notebook as im bring down Cabral just by di edge of di penalty box.
Cape Verde shoot di freekick straight into di Ghana wall.
Cape Verde plays ask di referee to check VAR as dem believe say dem suppose get penalty against Ghana.
Di ball come off di chest of one of Ghana players instead and no be di hand.
RefereeJean Ngambo wave play on.
Cape Verde don start di game as dem dey play from right to left.
Whoever win dis match go go top of group B afta Egypt and Mozambique draw for di earlier group match.
Both sets of supporters cheer dia team individual national anthems.
Ghana go wear dia traditional white jersey while Cape Verde dey in royal blue.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis two teams meet for di quarter-fianl of di 2013 edition of di Afcon wia Ghana defeat Cape Verde 2-0 dat day.
Who go come out on top dis time?
Coach Chris Hughton start Jordan Ayew for attack as Inaki Williams dey bench.
Ghana XI: Ofori, Odoi, Djiku, Salisu, Mensah, Ashimeru, Baba, Paintsil, Königsdörffer, J.Ayew, Semenyo
Meanwhile Bebe go lead di line for Cape Verde while jamiro Monteiro of San Jose Earthquakes go be di creative spark for di Blue Sharks midfield
Cape Verde XI: Évora Dias, Moreira, Evans Costa, Lopes, Moreira Fernandes, D'Encarnação Duarte, Gonçalves Pereira de Pina, Monteiro Alvarenga, Mendes da Graça, Dias Correia, Borges Cabral

End of X post