Elon Musk fit kontinu to give $1m to voters, judge rule

Wia dis foto come from, Getty Images
Elon Musk political group fit kontinu award $1m (£722,000) to voters in swing states, judge rule.
Di giveaway by Oga Musk America PAC go end today, and dem don already sabi who go collect last, one lawyer for di billionaire tok for court hearing yesterday.
In a surprising turn, di lawyer reveal say dem no dey select di beneficiaries of di money anyhow, as many bin believe but na one group dey select dem.
Philadelphia District Attorney Lawrence Krasner bin sue to stop wetin e call "illegal lottery" afta Musk announce say e go give money to one voter in a swing state each day until Election Day.
Pennsylvania Judge Angelo Foglietta no immediately give reason for di ruling, wey e make just few hours afta di hearing, according to di Associated Press.

