Helen Oyibo, Faith Oshoko, Annette Arotiba, Victor Ezeama and Adebola Ajayi
Trump running mate Vance don vote for Ohio
Wia dis foto come from, Getty Images
Donald Trump running mate, JD Vance, vote in person a short time ago for Cincinnati, Ohio.
Di Republican vice-presidential nominee land for di polling station wit im his wife plus dia children.
E bin dey in good spirits.
US election day 2024 in pictures
Wia dis foto come from, Joseph Prezioso/AFP
Wetin we call dis foto, Di very first polls for di US open for midnight for di remote, unincorporated New Hampshire township of Dixville Notch.
Americans
dey cast dia ballots for di presidential race between Republican nominee former
President Donald Trump and Democratic nominee Vice-President Kamala Harris.
Wia dis foto come from, Joseph Prezioso/AFP
Wetin we call dis foto, Di community get tradition of midnight voting. More dan 82 million pipo vote bifor di election day
Wia dis foto come from, John Tully/Getty Images
Wetin we call dis foto, Di result na clean split between di six registered voters - three for Harris and three for Trump.
Wia dis foto come from, Erik Pendzich/REX/Shutterstock
Wetin we call dis foto, Voters for Connecticut, Indiana, Kentucky, Maine, New Jersey, Virginia and New York fit cast dia ballots now. Pipo queue to vote for di Brooklyn Museum for New York City.
Wia dis foto come from, Erik Pendzich/REX/Shutterstock
Wetin we call dis foto, New York get di most electoral college votes, wit 28 up for grabs.
Wia dis foto come from, Quinn Glabicki/Reuters
Wetin we call dis foto, Pennsylvania na one of di key swing state, wit 19 electoral college votes.
Wia dis foto come from, Andrew Kelly/REUTERS
Wetin we call dis foto, One third of di US Senate - 34 of dia 100 seats - also dey up for grabs.
Wia dis foto come from, Faith Ninivaggi/Reuters
Wetin we call dis foto, Di state wey get di fewest electoral college votes na Maine, wit four. Pipo cast dia vote for Longley Elementary School for Maine 2nd congressional district.
Voting open for seven more states - including swing state Arizona
Voting don begin for di swing state of Arizona.
As di only swing state along di US-Mexico border, di results for Arizona go dey crucial for both presidential candidates.
Di state bin also dey for di heart of 2020 election misinformation claims and pro-Trump protests.
Polls don also dey open for Colorado, Montana, Nebraska, New Mexico, Utah and Wyoming.
Voting don start for Arkansas
Polls don open for Arkansas wey don bring di number of US states wey don start voting to almost 30.
E get six electoral college votes wen you compare am to states like California wey get 54 and New York wey get 28.
How many votes wey state dey get, na in part based on di size of di population.
Several oda states wey include Mississippi and North Dakota don also begin voting.
A quick guide to di candidates
Wia dis foto come from, Getty Images
Kamala Harris, US vice-president
Age: 60
Party: Democratic Party
Campaign promises: Harris catchphrase na "We no dey go back", as she dey refer to di policies of former President Donald Trump. She support abortion rights, she don launch one economic plan to ban extortion of prices for grocery store, and she say she go "end America housing shortage".
Major moment of 2024: Wen she lead di speech for di Democratic National Convention for August, barely one month afta Joe Biden drop out of di race.
Donald Trump, former US President
Age: 78
Party: Republican Party
Campaign promises: Trump say im go "seal di border" to stop illegal immigrants, e promise across-the-board tax cuts, e propose10% tariff on all US imports and vow to "drill, baby, drill" to bring down energy prices.
Major moment of 2024: E survive assassination attempt for Butler, Pennsylvania, one image wey go dey pipo mind for a long time na one foto wey wey show blood on im face.
More polls open - including for Texas and swing state Wisconsin
Voting don almost complete for several states and 10 more states just begin dia ballots around 08:00 for di US East Coast (13:00 for UK and past 2:00pm for Nigeria).
Di states na:
Alabama
Iowa
Kansas (counties fit dey a bit flexible for dis state)
Minnesota
Mississippi
North Dakota
Oklahoma
South Dakota
Texas
Wisconsin - one swing state wit 10 electoral college votes
Dis one mean say more dan half of di US 50 states now dey vote.
E go be Trump abi e go be Harris?
Article Information
Author, Sam Hancock
Wia dis foto come from, Getty Images
Polls don open for more dan half of di states for America and we don dey see more and more pictures of Americans as dem dey go vote.
For readers wey just dey join us, Donald Trump finish im campaign last night for di swing state of Michigam as Kamala Harris finish her own for Pennsylvania, wey dey seen as di key state to win as e get 19 electoral college votes. Dem don dey beg voters to comot and vote.
About electoral votes, na di way wey America dey take torchight who take win di election.
BBC Anthny Zurcher write say voters dey make decision wey fit affect generations to come.
US ballots: How dem look like and how dem dey fill am
Wia dis foto come from, Getty Images
For US, presidential election day ballot fit dey long - two or three white pages.
E no dey only get space wia voters fit vote for Kamala Harris or Donald Trump, but voters go also fit vote for House and Senate races plus local initiatives and proposals, like funding for community services.
Wen US citizens fill ballots out, dem dey fill am in form of bubble rather than ticking or marking an x in a box.
E dey take roughly 10 minutes to fill one out.
Which oda things Americans dey vote for today?
Wia dis foto come from, Reuters
Today election no be only about
Kamala Harris and Donald Trump - voters for America get oda things to decide
on:
Abortion
rights dey on di ballot for 10 states -
including di battleground states of Arizona and Nevada
One
third of di US Senate - 34 of dia 100 seats - also
dey up for grabs. Democrats dey currently control di Senate by a one-seat margin
For
di US House of Representatives, di lower chamber of Congress, all 435 seats dey up for
election, as e dey happun every two years. Republicans currently get small majority
Di
use of marijuana for recreational or medical use also dey on di ballot in four states - Florida,
Nebraska, North Dakota and South Dakota
Referendums
on voting and elections –
for some areas, voters go also choose how dem wan run dia elections.
States wia voting don open for 12:00 GMT
It is now 07:00 for di East Coast of di US (12:00 GMT) and voting dey open for more places:
Florida
Georgia - one of di seven swing states
Illinois
Louisiana
Maryland
Massachusetts
Michigan - a swing state
Missouri
Pennsylvania - seen as the key swing state, with its 19 electoral college votes
Rhode Island
South Carolina
Washington DC
Dis mean say voters fit cast dia ballots for more dan 20 US states out of di 50 in total.
Images of voters wey dey cast ballots for New York don show, Polls open for swing state North Carolina
Wia dis foto come from, Reuters
Voters for New York don dey show to vote for dia next president.
Some for New York City - wia voting open a little ovean hour ago don dey cast dia ballots for di Anna Silver Elementary School in Manhattan.
Wia dis foto come from, Reuters
Polls open for swing state North Carolina
More polls don open, dis time na for Ohio, West Virginia and North Carolina.
E mean say 11 US states don dey welcome voters.
North Carolina wey be di first swing state today wia polls don open, don get a tough few weeks.
Serious recent Hurricane Helene bin hit am, wit around half di total number of pipo killed coming from dia.
'Make dem hear your voices' and 'Make America great again' - Harris and Trump share voter posts
Wia dis foto come from, Getty Images
Kamala Harris don share her first post on X since US polls open one hour ago
"America, dis na di moment make dem hear your voices," di current vice-president tok.
Her opponent, Donald Trump, neva post since polls open but did im tok say ontop im Truth Social platform about three hours ago: " NA TIME TO GET OUT AND VOTE—SO TOGADA, WE FIT MAKE AMERICA GREAT AGAIN!!!"
Dis na about hour afta im final campaign rally, for Michigan, wrap up.
Polls open for New York, Vermont to kick off US election day
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, More states don dey gear up to open dia polls for di US
As at 05:00 for di East Coast of America, polls don open for Vermont as dis dey kick off di US election day.
Also, more states don dey gear up to open dia polls too.
Meanwhile, voters for Connecticut, Indiana, Kentucky, Maine, New Jersey, New York and Virginia fit now cast dia ballots.
Na New York get di most electoral college votes wit 28 wey di candidates go battle for while Maine get di lowest wit four.
Businesses close as Americans ready to vote
Wia dis foto come from, Reuters
Di US election dey come wit veri tight race but as Americans dey go poll, many businesses don close up.
For Washington DC, di home of US politics, many businesses don close up wit dia windows shutdown becos of fear of kasala on or afta election day.
Hundreds of National Guardsmen also dey on standby for di American capital, as well as for oda states wey include Alabama, Arizona, Delaware, Iowa, Illinois, North Carolina and New Mexico.
Dem don begin dey put metal fences outside di White House since di beginning of October.
Wetin be di electoral college wey go elect US president?
Wia dis foto come from, Getty Images
Di US presidential election wey go decide who go take-ova di White House don alreadi dey witness tight race.
But e dey possible say di candidate wey get di higher votes no go be di winner.
Dis na sake of say no be voters dey choose directly who go be president, na wetin dem dey call electoral college dey choose am.
How electoral college dey work?
Wen Americans do di presidential election, di votes go only go up to make-up one group of officials wey go represent Kamala Harris or Donald Trump for electoral college.
Electoral college- simply mean group of pipo wey get shared task to do for election.
Dis pipo na electors and dia job na to choose who go be president and vice president.
E mean say na number of electors from each state dey roughly make up di population and each States get many electors as dem get lawmakers.
Di total number of electors na 538.
Interestingly, each elector dey represent one electoral vote and candidate need to get 270 or more votes to win di presidency.
For di oda hand, states dey award all dia electoral college votes to di candidate wey win votes of ordinary voters for di state.
Wit dis system, di popular vote winner fit loose di election
Celebrity endorsement until di end - Lady Gaga sing for Harris
Wia dis foto come from, Getty Images
Celebrities dey always get role dem play for US elections and e no dey different dis year for celebrity endorsements.
At her final rally, Kamala Harris join in Pennsylvania by pop star Lady Gaga wey sing God Bless America and tell attendees "di kontri dey on you".
Harris opponent also kontinu to receive celebrity support until di last moment, wit podcaster Joe Rogan announcing to im followers on Monday "for di record" say e endorse Trump.
Di former president appear on Rogan show last month - dem bin think say Harris go do di same but member of her campaign team eventually announce say scheduling neva work out.
Harris or Trump? Na time for America to decide
Wia dis foto come from, Getty Images
Today na US election day and in di next few hours, Americans go wake up to choose dia next president.
More dan 82 million pipo don already cast dia ballots, but dem still get huge number to go - in 2022, around 161 million pipo register to vote in di US.
In her final pitch to voters, Democratic candidate Kamala Harris tell one rally in swing state Pennsylvania say she wan end her campaign "wit energy, optimism, joy".
Republican Donald Trump end im campaign for Michigan - another swing state - wia e accuse im opponent of being "radical left lunatic", bifor im welcome im children to join am on stage.
Wetin dey happun now? Well, di majority of di US East Coast still dey sleep - di local time dia na 02:10 - meaning e dey fairly quiet dia for di next few hours.
Wen we go sabi who go win di US election?
Democrat Kamala Harris, di current vice-president, and Republican Donald Trump, di former president, don dey neck-and-neck for weeks.
Dis na tight race for di two candidates as dem go dey hope to win.
Depending on how close di election be, e dey possible say di winner no go even dey known for days or weeks.
Also, e dey possible say some election results fit come in more slowly dis year due to changes in individual states.
Generally, voters for US don dey used to di idea say dem go know who di next president go be by di time dem go to bed late on election night or at least in di early morning hours of di next day.
Howeva, across di kontri, di first polls go close by 1800 EST (2200 GMT) on Tuesday evening and di last polls go close by 0100 EST (0500 GMT) early on Wednesday.
If you just dey join us, Kamala Harris just deliver her last speech of di campaign for Philadelphia.
She end her weeks-long run of appearances by reflecting on di campaign, she tok say e "bring togeda pipo from all corners of di nation, and all walks of life".
Harris go on: "Our own no be to fight against nothing, but for something... Tonight we finish as we start: wit energy, optimism, joy."
She send familiar appeal to young and new voters, saying. "To you in particular I say I see your power and I dey so proud of you."
Di vice-president know say she go need young voters to back her in big numbers if she go win today election.
Pipo cheer as Trump end im last rally of di campaign
Wia dis foto come from, GETTY IMAGES
Donald Trump don take to di stage in Grand Rapids, Michigan, for im final speech, wia im meet pipo wey dey cheer am from di crowd.
Dis na also wia e end im campaigns for 2016 and 2020.
"Doing four of these [rallies] in one day dey difficult small," Trump tok, but add say di support e receive for each rally don "make am worth am".
Di former US president enta two hours late to di rally, wey dem schedule to start 22:30 local time.
E ask pipo wey dey in attendance weda tins don betta now dan four years ago, wia di crowd for di rally respond wit loud boos.
"My message to you, and to all Americans tonight, dey very simple: we no suppose dey live like dis."