Super Eagles Ahmed Mjusa say make dem win as im birthday gift
Super Eagles Captain Ahmed Musa don ginger di players wey dey play against Benin today say make dem win as special birthday gift to am.
E tok dis for video message wey e reveal say dis "dis go be di best birthday gift, you fit give me guys, I miss una and I wish una best of luck".
E add say "we all know wetin dey at stake wen dem get and wait for di result from South Africa- Rwanda,. I know una fit do am."
Dis video comot as Nigeria dey prep to go for dia Group C World Cup Qualifier match against Benin Republic. If dem no win e go mean say Nigeria no go go World Cup for di second time in a row. E go be di first time dis kain tin don happun since di team start to dey go for 1994.