SUBSTITUTION, Nigeria 3-0 Benin
Benin don change players o
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Di Super Eagles win wit three goals from Victor Osimhen.
Victor Ezeama and Adesola Ikulajulo
Benin don change players o
66’ Benin players run Nigeria street just now for di midfield until dem near Nigeria goal area but defense Calvin Bassey clear di threat.
63’ So far Nigeria dey dominate play and Benin dey try catch up wit dem.
62’ Benin dey hold so ball well in di last one minute but dem Neva see chance to carry di ball enta Nigeria goal area.
60’ Victor Osimhen try to score di fourth goal but di ball crossover go sode netting.
Victor Osimhen na sweet joy to watch for dis game.
To score three goals for dis kain crucial game na very sweet one.
Di energy and strengths wey e dey take play pass di one wey e dey show bifor.
Although Ademola Lookman no play for di game sake of di card wey e collect for di last match, but di team dey do well for dis game.
Now, dem go gatz maintain di lead wit possibility say Osimhen fit score again.
Na dis kain energy di Super Eagles suppose use play from beginning.
Meanwhile, Osimhen no gree for pitch and e dey give complain for any hard tackle or challenge wey dem give am- still, e dey deliva.
57’ Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali dey delay play wit im usual tactics.
54’ Moses Simon of Nigeria give beta pass to I’m team mate but e miss di shot for open net.
Victor Osimhen wit great hattrick
50'
Mohamed Tijani of Benin chop yellow card
Wit trumpets and shouts, di Nigeria fans dey ginger to cheer up di players.
Di two goals by Victor Osimhen from di three minutes and 37th minutes mean alot to di team.
Now, di calculation go be on wetin be Nigeria chance to qualify for di World Cup.
Referee blow whistle for half-time.
45+5 Nigeria player Zaidu Sanusi get issue wit im boot e dey try wear am well.
45+2 Benin players dey play long balls.
45' Referee add 5 minutes
44' Samuel Chukwueze of Nigeria wey don get two assists for dis match fall for ground but Referee help am stand up.
44' Victor Osimhen of Nigeria balance for front bof benin goal area as e dey wait for more beta pass to score. Benis still dey bhistle for si match to get goal.
Afta Samuel Chukwueze give dat correct assist to Victor Osimhen, Nigeria get more chance for qualification.
Dat fantastic header for Osimhen revive hope of Nigerian fans wey shout wit joy and happiness.
Now, South Africa dey top di group C while Nigeria dey second position.
South Africa wit 18 points now as di game dey go on, and Nigeria wit 17 points.
Which kain miracle fit happun?
42' So far na only one attempt on goal Benin don get