, Nigeria 2-0 Benin
40' Nigeria and Benin dey battle for di midfield, di two teams no dy allow ball stay for dia opponent leg.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Di Super Eagles win wit three goals from Victor Osimhen.
Victor Ezeama and Adesola Ikulajulo
40' Nigeria and Benin dey battle for di midfield, di two teams no dy allow ball stay for dia opponent leg.
37' Victor Osimhen don score Nigeria second goal! Samuel Chukwueze pass di ball to di goal area Osimhen head di ball inside di net.
33'
Alex Iwobi is down afta tackle wit Benin player. Di ball don kontinue afta dem quickly attend to am
33' Nigeria player Alex Iwobi dey for ground sake of bad tackle but im don get up.
32' Benin hold possession of di ball, dem make di ball towards di post but di ball go over di bar!
25'
Appollis don increase South Africa lead as e score for di 25th minute of di game. Dis don place Bafana Bafana wit two goals ahead of Rwanda wey still dey find goal.
Aside from wetin Nigeria play against Lesotho, di Super Eagles bin make four changes.
Moses Simon make im 85th appearance while Osimhen dey partner wit Akor Adams for di front.
28' Side-netting! for Benin, di player fire di ball but e land for side of di net.
26' Chance for Nigeria! Samuel Chukwueze get di ball for goal area but defender block am, e call for handball but Referee saybno foul.
25' Freekick for Benin, dem play am but notin comeout.
22' Nigeria collect ball from Benin player from di midfield, dem build up until di ball reach Victor Osimhen wey fire shot but e land for one player head, Nigeria play di rebound but e go over di bar.
12' Bafana Bafana dey put more pressure ontop Rwanda as Mokoena give one korrect header but e go ova di bar.
Rwanda dey find equaliser for dis game but di Bafana Bafana dey out plenti pressure
Appollis come close to increase di lead for South Africa, but Rwanda goalkeeper make dat great save!!
Benin get corner kick but e land for Nigeria goalkeeper hand.
13'Chance for Benin to equalise but di ball land for Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali hand.
Mbatha put Bafana Bafana for di early lead ahead of Rwanda for inside 5 minutes
11' Benin collect ball from Nigeria leg and dem dey hold onto di ball since
Plenti fans don full stadium to watch Nigeria vs Benin Republic
08' Nigeria dey try hold di ball to keep possession but Benin no dey give dem space.
Nigeria 1-0 Benin