Di Independent National Electoral
Commission INEC say dia senior officials don begin investigate one alleged
electoral magomago for Ogori/Mangogo area of Kogi state.
Di kontri electoral body for inside
statement tok dis one afta reports allege say dia staff dey present result
sheets wey dem don already fill.
“Our attention de drawn to report say
dem discover filled result sheets for some polling units for Kogi state.” INEC
tok.
Di govnorship candidate of di Peoples
Democratic Party for Kogi state, Dino Melaye bin raise alarm and allege say voting
no dey go on for Ogori Magogo area of di state sake of say electoral officers
for di area don dey compromised.
Dis na afta one
civil society organisation for Nigeria bin ask di electoral body to investigate di forged election results from some polling unit wey
dey circulate for Kogi state.
YIAGA Africa say dem receive report of results
sheets wey dem don fill for PU 004, Eni Ward of Ogori/magongo area for di north
central state.
YIAGA sharpely tell di election office to address
di mata so dat mago- mago no go dey for di election process.
Dem post photo of di result sheet wey show say di
ruling All Progressive congress party get 200 votes out of di 207 valid votes
for dat unit.
Di commission for dia response say dem dey view di
situation seriously and dem go communicate dia decision soonest.
18 candidates dey contest for di govnorship election, di top three candidates for di race na PDP Dino Melaye, APC Ahmed Usman-Ododo and SDP Murtala Ajaka.