As voting dey go on for Kogi, Bayelsa and Imo states, Imo residents no
turn up for di election as dem dey find water for dia daily use.
Dis na becos water don become
scarce commodity for Owerri, di state capital sake of di strike wey di state
chapter of di National Union of Electricity Employees (NUEE) bin declare afta di
attack di National President of di Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero for di
state recently.
Plenty pipo for di state dey rely on
dia borehole for potable water, but many of dem no fit pump water sake of lack
of light wey don pass more dan seven days now.
BBC wey dey on ground for di state
see plenty queue wey dey wait to fetch water from one bore hotel wey one hote;
dey operate.
"One (25 litre) jerrycan of
water (wey bin dey cost between N10 and N20) now dey cost N50 and I spend at
least N1000 daily to get enough water for my household," one lady wey tok
say her name na Eunice tok.
She beg members of di organised Labour
to pity di masses wey dey suffer sake of dis strike.
Anoda man wey dey para and no even
fit tok im name dey wonder wen im go get water, come still get time to go im
polling unit to vote.
"It's almost ten o'clock
now," e tok for anger. "I' neva even baff, Wen I go get enough water
for my family and still fit vote? And besides, wetin be di benefit of dis
voting to us as a pipo all these years?" e ask.
Goment neva tok anytin about di water
scarcity. However, for inside one recent interview on Channels TV, di Imo state
govnor, Hope Uzodinma tok say im no get any problem wit di labour unions for di
state.
E say im don implement di national
minimum wage, and dey pay im workers and pensioners regularly.
However, if federal workers for di
state dey vex for any reason, im no fit dey responsible for dat.
Di 'Nigeria Labour Congress and 'Trade
Union Congress' don begin indefinite strike for Imo state, while a nationwide
strike go start next week Tuesday, 14 November, 2023.