Nigeria presidential inauguration 2023 live as e happun

Plenti leaders from within Africa and across di world attend di inauguration of Bola Ahmed Tinubu as di 5th democratically elected president of Nigeria.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Dignitaries don begin show face for Eagles square

    All don dey set for di swearing in of Nigeria president-elect Bola Ahmed Tinubu as di fifth Nigeria democratic Presido since 1999.

    Di offical event begin wit match paarde from di military including men of di Nigeria Police Force.

    Match Past dey go on for Eagle Square
    Wetin we call dis foto, Match Past dey go on for Eagle Square Abuja
    Dignitaries don begin show
    Wetin we call dis foto, Dignitaries don begin show
    Dignitaries don begin show
    Wetin we call dis foto, Dignitaries don begin show
    Military pipo
    Wetin we call dis foto, Military pipo siddon
    pipo for eagle square
    Wetin we call dis foto, guest don dey siddon to witness di inauguration of di new president
  2. Security tight for Eagles Square

    Heavy security presence for Eagles Square
    Wetin we call dis foto, Heavy security presence for Eagles Square

    Heavy security presence don already dey di venue where 71-year-old Tinubu, go dey sworn in as Nigeria next leader afta Buhari eight-year administration.

    Plenty operatives from di Department of State Services, Nigeria Police Force, Nigerian Army plus oda paramilitary agencies don full ground for di venue.

    Plenty patrol vans don also tanda for strategic position in and around Eagle Square wit surveillance wey security agencies dey codedly carry out.

    Di Inspector General of Police Usman Alkali-Baba say dem dey 100% ready to ensure security and dem go improve on crowd control.

  3. GCFR: Tinubu promise not to disappoint as e gbab highest national title

    Buhari dey decorate Tinubu

    Wia dis foto come from, Bashir Ahmed

    Wetin we call dis foto, Tinubu receive GCFR titley for 25 Ma

    Bola Tinubu tell Nigerians say tins no go always dey smooth wen im become president of di kontri.

    Di President-elect tok dis afta im collect di kontri highest national honour from Muhammadu Buhari for Abuja on Thursday.

    On 25 May, president Buhari bin give Tinubu di title of Grand commander of di Federal Republic (GCFR).

    Im vice president elect Kashim Shettima also collect Grand commander of di order of di Niger (GCON).

    “Our way no go always dey smooth. Yet we get faith for our plan and belief for our collective ability to overcome di challenges wey confront us.” Tinubu tok

    But di President-elect assure kontri pipo say im no go disappoint dem.

    “I must run dis race and must do it well. On security, di economy, agriculture, jobs, education, health and power and for all oda sectors we must make headway. Di pipo deserve no less. For this, I no go disappoint neither them nor you, Mr. President.” Tinubu bin add.

    “I be simple man wey benefit from di support and goodwill of di people of Nigeria. Di pipo put dia trust in us. You don do your part, Mr. President.’’

    President Buhari also hand di transition documents and di baton of service to di incoming president for di event.

    Tinubu bin hail Buhari for im speech and torchlight some of di tins wey di outgoing president administration do.

  4. Articles wey we recommend

    • Di five test wey dey wait Nigeria new president
    • Bola Tinubu: Timeline of how Nigeria kingmaker become king
    • ‘Our way no go always smooth’- Tinubu tok as Buhari give am GCFR title
    • Afta eight years for office - Dis na di legacy of Buhari
  5. Eagles Square don set for Tinubu inauguration

    Eagle Square, Inauguration venue, Abuja
    Wetin we call dis foto, Eagle Square, Inauguration venue, Abuja

    All don dey set for di inauguration of di former Lagos state govnor as Nigeria president for di next four years.

    Di Eagle Square, one big space for Abuja, di kontri capital, where dem go use for di event don dey decorated wit White and Green, colours of di kontri.

    Last minute preparations don dey go down for di historic handover of President Muhammadu Buhari to im party man wey win di February 25 presidential election.

    Heavy security presence don already dey di venue where 71-year-old Tinubu, go dey sworn in as Nigeria next leader afta Buhari eight-year administration.

  6. Who be Tinubu?

    Di media team of di president-elect release im official portrait ahead of di inauguration

    Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/Twitter

    Wetin we call dis foto, Di media team of di president-elect release im official portrait ahead of di inauguration

    Bola Tinubu, 71, dey widely known as di pesin wey reshape Nigeria commercial capital, Lagos.

    Popularly called Jagban by im supporters, Tinubu na two times former Lagos state govnor, di commercial hub of di nation.

    E bin also serve as senator during di brief third republic for Nigeria.

    Tinubu na very influential politician alias ''Kingmaker'' wey don help many of im protoges climb high political trees across di kontri - na why dem dey call am.

    E dey instrumental to di emergence of di outgoing president, Muhammdu Buhari during di 2015 and 2019 presidential election.

  7. Who dey attend di ceremony?

    Past presidents, diplomats, heads of international organisations, prominent Nigerians and representatives of foreign goments and agencies.

    Those foreign goments na United Kingdom, Canada, France, Saudi Arabia, United Arab Emirates, Pakistan, China, Germany, Finland, Jamaica, Japan, Israel, Turkey and several others.

    African leaders like Macky Sall of Senegal, Julius Maada Bio of Sierra Leone, Ghana President Nana Akufo-Addo, Mohamed Bazoum of Niger Republic, Paul Kagame of Rwanda amongst odas go also tanda for di 29 event today.

  8. How Bola Ahmed Tinubu emerge president-elect

    Bola Ahmed Tinubu

    Wia dis foto come from, Bola Ahmed Tinubu

    Di Nigeria electoral umpire, INEC,bin declare Bola Tinubu, di candidate of Nigeria’s ruling party, APC, as di winner of 28 February presidential election.

    Oga Tinubu defeat 17 other candidates wey participate for di election.

    E score a total of 8,794,726 votes, wey mke am di candidate wit di highest vote.

    Di 71-year-old also score over 25 per cent of di votes wey ontri pipo cast across 30 states, more dan di 24 states wey constitutional require am to get.

    Atiku Abubakar of di PDP na im come second wit total of 6,984,520 votes while Peter Obi of di Labour Party carry third position with a total of 6,101,533 votes.

    Di two leading rival plus few odas don carry waka go court to challenge Tinubu electoral victory.

  9. Power about to change hand for Nigeria

    Bola Tinubu and Buhari

    Wia dis foto come from, Presidency

    Di Eagle Square for Abuja don dey burst wit activities as Hand-over ceremony go shelle soon.

    In di next few hours, Nigeria President Muhammadu Buhari, go formerly hand over di baton of power to di President-elect, Bola Ahmed Tinubu wey go direct di affairs of di kontri for di next four years.

    Buhari bin gbab power eight years ago for 2015 afta one election of high hopes from Nigerians wia e defeat former president, Goodluck Ebele Jonathan.

    Today, di two-term administration of Muhammadu Buhari go end afta wetin many Nigerians describe as one rough ride sake of challenges like economic, security, education gbege wey bin trouble im gomment.

    Meanwhile, for im inauguration speech, Muhammadu Buhari bin tok one ogbonge tin wey bin confuse Nigerians, e bin say “I belong to everybodi, I belong to nobodi”.

    Despite di mix reactions wey bin follow how Bola Tinubu become president, Nigerians dey hopeful say di president-elect go hit di ground running once e enter Aso Rock today.

    Bola Tinubu go become di fifth democratically elected president of Nigeria since democracy return for 1999.

  10. Welcome!

    Welcome to BBC Pidgin live coverage of di inauguration of di 5th democractically elected president of Nigeria, Bola Ahmed Tinubu alongside im vice, Kashim Shettima.

    Di event go start for 10am.

    Twenty-eight govnors across Nigeria go also take oath of offices for dia respective states today.