Wetin don happun so far

Activities don waka far for Eagles Square wia di Chief Justice of Nigeria bin give oath of office to di president Bola Ahmed Tinubu and In vice Kashim Shettima.
Di man of di moment Bola Ahmed Tinubu bin take im oath after im vice, Kashim Shettima don do im own.
Buhari handover leadership of Africa most populous kontri give Bola Tinubu, wey win di February 25 general elections.
Now former president, Muhammadu Buhari comot di Eagles Square immediately Tinubu take oath of office to gbab di seat of power.
Former Vice President Yemi Osinbajo don also comot di Eagles Square for Abuja.
Several African presidents plus oda foreign dignitaries present for Nigeria for di inauguration of Bola Tinubu as di 5th president of di continent most populous nation.




















