You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
List of supreme court judges in Nigeria
South Africa president pledge equal pay for Banyana Banyana afta Women Africa Cup of Nations win
Una bye-bye for Wednesday, We go come back on Thursday morning
Na for hia di BBC Pidgin Live page team, dey press break but we go come back on Thursday morning.
For now, you fit find di latest updates on di BBC News Pidgin website, or listen to our Pidgin minute.
No forget to join us tomorrow morning around 9:00am.
Nigeria Senate give President Buhari ultimatum to tackle insecurity or face impeachment
Senators from opposition parties for Nigeria don issue six weeks ultimatum give President Muhammadu Buhari to tackle di security challenges for di kontri.
Nigeria media report say dem also threaten to start impeachment proceedings against di president if e fail to address di insecurity for di kontri within di period dem give am.
Minority Leader of di Senate, Senator Phillip Aduda tok say dis na di position of di lawmakers wen e dey follow tori pipo tok for di National Assembly for Abuja, di kontri capital.
Before di briefing, opposition lawmakers bin waka comot di red chamber afta Senator Aduda read one point of order say make lawmakers impeach President Muhammadu Buhari.
Senator Aduda bin raise one point of order wey ask di Senate President, Ahmad Lawan, to discuss di security situation for di kontri and di impeachment of President Buhari.
But Senator Lawan wey preside ova di plenary no agree to di request of di minority leader, e say di motion no get point plus di minority leader no inform am privately before e carry di mata come di floor of di house.
Di senate don begin seven-week annual recess.
Senate President Ahmad Lawal adjourn di plenary till 20 September, 2022.
Nigerian sojas rescue two abducted Chibok girls and dia children
Sojas of 202 battalion don rescue two girls wey Boko Haram kidnap from Government Girls Secondary School Chibok, Borno state on 14 April 2014.
Di Nigerian Army wey announce say di Chibok girls and dia children currently dey for one military medical facility.
Di sojas add say dem also rescue four women during clearance operations
Na ova 200 girls insurgents kidnap from di Government Girls Secondary School for Chibok for 2014.
Some of dem don dey rescued but some odas still dey for captivity.
Lawyer explain why judge send am to one month in prison for Uyo
One human rights activist lawyer Inibehe Effiong say di Chief Judge of Akwa Ibom State, Ekaette Obot, sentence am to one-month in prison.
For one long twitter post, Inibehe say im bin appear for court on Wednesday morning to defend one libel case wey Akwa Ibom state govnor, Udom Emmanuel against im client.
“Di Chief Judge of Akwa Akwa Ibom bin order one Premium Times reporter to comt di court”, im tok.
“I say my lord, we dey think say since di proceed na public, say dem suppose allow members of di public to observe di proceeding. My Lord ask me to proceed wit cross examination,” e add am for di tweet.
“Di moment My Lord enter di Courtroom, e order di orderly dem attach to di court to go out and bring di armed policemen inside di courtroom.
“I begin feel say trouble go dey. I apply to di Court to ask di armed policemen wit AK47 to leave di courtroom, say e no dey proper and say I feel extremely unsafe and uncomfortable.
“My Lord then begin write, I be think say e go be about di ruling on my application to excuse di officers.
“I no sabi say, my Lord dey write committal order to send me to Uyo prison.”
Inibehe bin travel from Lagos go attend di case for Uyo.
Im add am say dem no give am opportunity to say anything. My Lord just order me to remove my wig and gown, say i dey go prison.
E no dey clear wetin be di human rights lawyer offence.
Authorities don kill Japanese monkey wey dey terrorize pipo
Officials don catch and kill one member of one gang of monkeys wey don dey terrorise residents of one Japanese city for weeks.
Di macaques don bin injure almost 50 pipo for Yamaguchi.
Specially commissioned hunters find di male primate for di grounds of one high school on Tuesday evening.
Dem tranquilise am and later put am down wen dem identify am as one of di animals wey dey responsible for di attacks.
Authorities don bin dey hunt di monkeys since di attacks begin on adults and children about three weeks ago.
Most injuries na mild scratches and bites.
Pipo stilll dey report more Incidents and di search continues for oda members of di gang, one official for di local agricultural department tell AFP.
"Eyewitnesses describe monkeys of different sizes, and even afta di capture, we still dey get reports of new attack," e tok.
Di captured monkey dey estimated to be four years old and na about half a metre tall (1ft 7in).
Japanese macaques dey common for large parts of di kontri and for some areas dem dey consider dem as a pest, eating crops and sometimes entering homes.
However, di attacks for Yamaguchi dey unusual.
Zimbabwe civil servants on strike ova pay
Civil servants for Zimbabwe don begin two-day strike to demand make dem increase dia salaries.
Dem also want make goment dey pay di salaries for US dollars as di local currency don lose value.
Di goment dey double salaries dis July, but unions say di high inflation wey stand at about 190% don cover di increase.
Schools, health facilities and goment services fit face major disruptions as unions tell di BBC dem dey expect all dia workers to stay home.
But e be like pipo no too observe di strike, as teachers go work.
Di average worker including doctors and nurses dey earn about $200 (£165) per month.
Zimbabwe dollar don lose ova 50% of e value since January, partly because of di war for Ukraine.
Unions dey plan longer strike for September if govment no meet up with dia demands.
Nigeria police don order additional security to secure Abuja
Di Inspector General of Police, Usman Alkali Baba, don order di deployment of additional forces to strategic areas for di federal capital territory.
Di Force Public Relations Officer, Muyiwa Adejobi, tok am for one statement on Tuesday as pipo dey ontop security breaches for some parts of Abuja, di kontri capital.
Im tok say di police chief don also charge di Force Intelligence Bureau to make sure dem gada enough informate.
According to Adejobi, di police no go leave any stone unturned to fortify di Federal Capital Territory and di environment.
Im call on residents of di FCT to work wit police and other security agencies to forestall any breach of security for di kontri capital.
On Monday, gunmen dem suspect to be terrorists ambush troops of di Presidential Guards Brigade along Kubwa-Bwari area of di FCT, inflict injury on at least three soldiers.
Police arrest papa wey wan sell im three albino children
Police for Mozambique don arrest one papa wey allegedly bin wan sell im three albino children.
Dem gbab di man as e dey negotiate ova di price, police tok.
Police say dem arrest di man wey be 39 years old, and e brother wey be 34 years, for di western Tete province.
Two of dem don deny di accusation, according to police.
Bad pipo dey kill Albinos for di kontri for dia body parts, wey dem dey use for ritual purposes.
Police spokesman Feliciano da Câmara say two supposed buyers also dey for police custody.
E say di papa bin carry di children, wey dey di age of between nine and 16, from dia home and keep dem, as dem dey run negotiations ova dia price.
"Dem bin wan make di sale for over $39,100 (£32,400),” di police spokesman tok.
“We take steps and locate di two individuals for Angónia wey confam plans for di deal," e add.
12 Nigerian states declare 'holidays' for PVC registrations
Miners pick pink diamond wey fit be largest stone seen in 300 years
More fotos from di NLC rally
Nigeria university strike: ASUU President say "We no go back down"
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin
Academic Staff Union of Universities (ASUU) don beat chest say dem no go back down on dia five months strike until govment answer dem.
ASUU national president, Prof. Emmanuel Osodeke make di vow on Wednesday to kick off di labour Mega rally inside Abuja, Nigeria.
Nigeria Labour Congress (NLC) and ASUU joinbodi protests dey happun for di Nigerian capital on Wednesday.
"We no go back down, we go fight to finish, two years no dey too much to sacrifice for generations to come" e tok
E thank di NLC and and oda Unions wey joinbodi wit dem for dis struggle as e also beg Nigerian students to dey patient wit dem.
" We beg Nigerian students to dey patient wit us, Two years no dey too much to sacrifice, dis struggle no be for only di present students but for dia children, grand and great grand children and generations to come"
"We go fight until govnors and presidents children go begin attend our Universities"
ASUU dey on strike since February 2022.
Nigeria Labour Congress mega rally opening fotos
Nigeria Labour Congress [NLC] stage mega rally for Abuja on Wednesday to conclude dia nationwide protest.
Hundreds of Nigerian workers dey gada for di Unity Fountain inside di Nigerian capital Abuja for solidarity protest rally.
Nigeria Labour Congress, a powerful umbrella union of millions of public service workers across plenti sectors, bin ask dia members to do nationwide protest on Tuesday.
Di move na to gada support for public university lecturers union - ASUU wey dey on strike since February.
NLC bin give di federal goment deadline, say make dem resolve di mata wey dey cause di long strike by di public university lecturers within two weeks.
E don reach five months and thirteen days, since Academic Staff Union of Universities [ASUU] close down public universities to argue with goment ova dia welfare package.
ASUU bin start dia strike for February 14 while NLC don threaten indefinite strike if nothing happun.
Dis na di pictures for di protest for di Nigerian capital.
ASUU Strike: "We no go back down, two years no too much to sacrifice"
175 Nigeria returnees from Libya land for Lagos, So far NEMA don receive about 2000 returnees from Libya since January 2022
Article Information - Author, Andrew Gift
- Role, BBC Pidgin, Lagos
175 stranded Nigerians wey return from Libya land Lagos international airport on Tuesday night.
Nigeria Emergency Management Agency [NEMA] say dem don receive di fresh returnees.
Dia flight touch down for di Nigeria commercial capital five minutes before midnight.
Dem include 81 female and 94 males.
Di International Organization for Migration IOM wit funding from European Union na im assist bring di returnees back.
Over di years plenti Nigerians dey migrate from di acclaimed giant of African kontri into other kontris in search of greener pastures.
Plenti of dem no dey reach dia proposed destination and most times dem dey fall into wrong hands and begin face harsh conditions.
Dis fit include slavery and forced labour. Most of dem dey end up in kontris like Libya.
Most returnees from Libya bin don tell BBC how dem face harsh conditions for Libya wey make dem agree to return to dia home kontris.
So far NEMA don receive about 2000 returnees from Libya since January 2022.
Una Good Morning and Welcome
We welcome una proper-proper for dis our live page today as we go dey give una all di ogbonge tori as e dey hot.
Today, we go focus for Abuja wia di Nigeria Labour Congress don promise day dem dey hold dia mega rally as di finale for dia two day solidarity protest with ASUU on dia strike.
Di Headies disqualify Portable from award nominees